Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

14 Brigade Go Do Shooting Drill For Abia

14 Brigade Nigerian Army don tell farmers and people wey dey near 14 Brigade Range Area make dem no fear if dem hear gun shots from Monday, March 23 go reach Wednesday, March 25, 2026. Di Brigade talk say dem go do first Range Classification exercise to improve how soldiers dey handle weapons, shooting skills, and marksmanship. According to statement wey Captain Mazinho Attah sign, di exercise go happen for 14 Brigade Shooting Range, Goodluck Ebele Jonathan Barracks, Ohafia, Abia […]

todayMarch 22, 2026 7

OBODO NAIJA

Tinubu Set Plan Wey Go Reduce Fuel Wahala For Nigerians

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don yarn say fuel price don dey too high for Nigerians, and don start plans to reduce di sufferness wey citizens dey face. Dis one dey inside statement wey Hamisu Muhammad Gumel, Chief Press Secretary to Jigawa governor, release give media tori pipo. Di Governor talk dis one during Eid-el-Fitr celebration for Dutse, after e receive Emir of Dutse and other traditional oga dem for Hawan Bariki Durbar on Saturday. According to am, di situation […]

todayMarch 22, 2026 9

OBODO NAIJA

Police Grab Three Jaguda Boys For Anambra

Anambra State Police Command don arrest three suspected armed robbers and cultists, and recover different weapons, ammunition, plus one stolen petrol tanker for separate operations across di state. For statement wey dem release on Sunday, police PRO, Tochukwu Ikenga, talk say operatives of Rapid Response Squad, Awkuzu, carry out di arrest on March 21, 2026, around 1:46pm. Ikenga say police act on correct intel before dem storm one suspected criminal hideout for Ogidi for Idemili North LGA, where dem take […]

todayMarch 22, 2026 7

obodo oyinbo

US Military Say Iran Threat To Strait Of Hormuz Don Reduce Well Well

US military don yan say Iran fit no fit threaten Strait of Hormuz again after dem bomb underground place wey dem dey hide cruise missiles and other weapons dis week. Iran don dey block di Strait, wey dey carry one-fifth of world oil, so US come use heavy heavy bombs strike di missile sites wey dey around. CENTCOM oga, Admiral Brad Cooper, talk say dem drop plenty 5,000-pound bombs for di hardened underground facility wey dey Iran coast, wey dem […]

todayMarch 21, 2026 9

Sports

Former Super Eagles Player No Gree Make I Enter Iheanacho Room – Osimhen

Galatasaray Striker, Victor Osimhen don yarn how one senior player for Nigeria national football team pursue am comot for room during im first call-up for 2017 under coach Gernot Rohr. Osimhen tok dis one during one livestream chat with Carter Efe on Saturday morning. According to am, di player bin dey share room with Kelechi Iheanacho. E remember say as e come Uyo, I meet Iheanacho tell am say I wan carry im boot, so e tell me make I […]

todayMarch 21, 2026 3

Lagos

LASEMA Konfamate Say One Person Kpai For Tanker Askident

Lagos State Emergency Management Agency don konfamate say one person don die for gas tanker and tipper truck explosion wey happen for Lekki-Epe Expressway on Saturday. Dis update come after Margaret Adeseye wey be Controller General of Lagos State Fire and Rescue Service tok say property worth thousands of naira don spoil, while two people burn beyond recognition for di askident. For statement, Permanent Secretary of LASEMA, Olufemi Oke-Osanyintolu, say one life lost and two others get injury for di […]

todayMarch 21, 2026 6

OBODO NAIJA

Delta Gorment Order Probe On Top Ozoro Festival Wahala

Delta State Government don condemn report wey talk say some women suffer harassment and sexual assault during Ozoro Festival, dem say di act na barbaric and no acceptable at all. Commissioner for Works (Rural Roads) and Public Information, Charles Aniagwu, don call on security agencies make dem quickly investigate di matter and arrest those wey dey involved. E still assure residents say government go continue to protect di rights and safety of everybody, especially women and other vulnerable people. Aniagwu […]

todayMarch 21, 2026 8

obodo oyinbo

Spain Prime Minister Drop €5 Billion Plan To Cut Fuel Tax

Spain Prime Minister Pedro Sánchez don announce one big package wey worth about five billion euros to help battle di economic wahala from di Middle East war. After emergency meeting, di prime minister say di plan get about 80 measures to protect households and important sectors from high cost of living. E also promise serious reductionfor energy taxes, especially for gas and fuel, to make things easier for citizens.

todayMarch 21, 2026 5

Sports

Salah To Miss Brighton Match Sake Of Muscle Wunjury

Say Mohamed Salah no go play for Liverpool match wey dem get for Brighton on Saturday because im get muscle wahala. Di Egyptian forward comot pitch on Wednesday after im score for Liverpool 4-0 win against Galatasaray wey make dem reach Champions League quarter-final. Manager Arne Slot talk dis tuk for press briefing dat dem get international break, and Egypt nor go happy as im no fit join dem.  

todayMarch 21, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app