Blog masonry

Background

Business

“Trump Dey Happy With Dangote Refinery” — Aliko Dangote

By: Rilwan Agbomeji President of Dangote Refinery, Alhaji Aliko Dangote, don calm di internet, talk say US President Donald Trump no get any wahala at allwith di $20 billion Dangote Refinery. E yarn dis while e dey react to social media gist wey scatter everywhere, wey some people begin talk say Trump no happy say Africa biggest refinery dey Nigeria. Di talk burst afta Trump threaten say im go hit terrorists wey dey attack Christians for some parts of Nigeria, […]

todayDecember 15, 2025 9

Entertainment

“Abeg Make Una Leave My Marriage Palava, Make We Face Real National Wahala” – 2Baba

By: Rilwan Agbomeji Nigerian music icon Innocent Idibia, wey people sabi as 2Baba, don call Nigerians make dem stop to dey focus on im personal life and turn eye to di serious problems wey dey worry di nation, for one live performance on December 12, 2025. As e yarn di crowd directly, di singer talk say discussion about im marriage to Edo State lawmaker Natasha Osawaru don too long, and e don tire for di matter.

todayDecember 15, 2025 11

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now together, Super Eagles camp don full ground, as preparation for […]

todayDecember 15, 2025 8

Lagos

Police Hunt Driver Wey Kill House Agent For Lekki

By: Esther Ayoola Lagos state police command don carry fork, wrake and all dia equipment  enter Lagos dey find one driver wey dem accuse of killing a house agent, Yinka Agboola, because of fight over parking space for, orchid road, Lekki. U sabi say,  Konfam bin report last week how di wahala take start,  dem tell di driver make e move im motor from middle of road and even show am another place to park, but man wey get cocoanut […]

todayDecember 15, 2025 8 1

Lagos

FRSC Share Report Card Say 91 Kpai For Lagos Road Crash

By: Esther Ayoola Federal Road Safety Corps, Lagos state branch, don mark present, share report card say, not to make anibodi fear, say from dia record say wawawa driving don kpai at least 91 people across di state between January and November 2025. Lagos FRSC Sector Commander, Kehinde Hamzat, yarn dis one for tuk tuk meeting wey im do with tori pipo wey dem hold for Ojodu-Berger on Friday. Di briefing na normal tin wey im dey do sama dia […]

todayDecember 15, 2025 11

Lagos

Nigerian Wear Chain For Dia Officers Neck Say Dem Try For Dia Old Age

By: Esther Ayoola Nigerian navy over di weekend don hold dia awards night for naval dockyard, Victoria island, Lagos, to mark di formal end of dia 2025 activities and celebrate officers wey perform well. Vice admiral Idi Abbas, chief of naval staff, tell journalists say di event na to recognise officers and ratings wey show dedication and help di navy achieve dia mandate for di year. Di ceremony, wey sup on saturday evening, use di platform to reward outstanding service and […]

todayDecember 15, 2025 15

Lagos

Early Mormor Fire Scarra 48 Shops For Elegushi Market, Lekki

By: Esther Ayoola One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops. Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday. E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, fire don already fence the market. According to Oke, emergency […]

todayDecember 15, 2025 12

National

President Tinubu Wire Call To West African Leaders To Join Bodi Fight Terrorism

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don  recharge 100 naira,  wire wire call  to West African leaders say make dem join hand fight terrorism and military takeovers for di region. As im dey vex, i nor fit tuk so, im carry the phone give im  vice, Kashim Shettima for di 68th ECOWAS summit wey sup for Abuja on Sunday. Tinubu yarn say no single country fit bring stability alone, and Nigeria still dey committed to di ideals of ECOWAS.

todayDecember 15, 2025 8

National

FG Rake Full Newspaper Say Health Sector Standard For Di Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola Wi Federal Gorment don bring mata dey rake full newspaper say Nigeria health sector dey stable for di last two and half years, and nothing serious don disturb am. Minister of Health, Ali Pate, yan this one on Sunday for TV sit down tuk, say na because di federal gorment give am beta attention and dem put money for di sector. Pate talk say, “For di last two and half years, we don experience beta care for […]

todayDecember 15, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app