Blog masonry

Background

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Say Iran Dey Feel Di Heat

US Presido, Donald Trump  say Iran don dey feel di heat oh,  reach say, Iran no get air force again. Trump put for im Truth social say, i tuk am, an dem don dey see workings for Iran. Meanwhile for Iran, Secretary Ali Larijani dey rake say Iran soldiers dey ready if US come ground fight, dem fit kill and capture plenty Americans. Since Saturday, US and Israeli attacks don kpai at least 1,230 pipo for Iran, two schools for […]

todayMarch 6, 2026 4

Sports

CAF Dey Find New WAFCON Host as Morocco Wan Step Down.

Confederation of African Football, CAF say dem dey find another country to host 2026 Women’s Africa Cup of Nations as dem nor sure whether Morocco wan sti host. Dem don shift di tournament from March 17–April 3 go July 25–August 16  after dem inform with FIFA and other people wey concern. Sports News Africa report say Morocco don tell CAF before  say dem no go fit host am for March  because  planning problem and other football activities, so like dis […]

todayMarch 6, 2026 4

OBODO NAIJA

First Lady Charge Wives Of Govos To Hellep Grassroots Pipo

First Lady, Senator Oluremi Tinubu don charge state First Ladies to show workings, ensure say dem, dey hellep pipo wey nor too get and ensure economic stability. Mama Oluremi dey hammar dis mata for di first quarter meeting of di Renewed Hope Initiative coordinators on Thursday. she challenge dem make dem take bold action to hellep dia states.

todayMarch 6, 2026 6

Sports

Super Eagles Still Ready For World Cup Playoffs – Ndidi

Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, say im and im teammates go still play di world cup play off if , FIFA  favour dem ahead of DR Congo. Di super eagles miss automatic qualification, after losing 4–3 on penalties to DR Congo for African play-off final last November. Nigeria Football Federation don carry matter go FIFA, tsay some DR Congo players switch nationality wrongly, so dem dey hope say, dem fit get second chance. As e be now, FIFA never yarn […]

todayMarch 6, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Fire Missiles Enter Tel Aviv, Cause Big Damage

Iran don fire cluster missiles reach Tel Aviv for new attack wey hit central Israel,  damage everywia. TV Channel 12 for Israel report say some missile pieces land for di city and areas around am. According to eye wey see, wey nor reach collect slap, for eyes, say properties wey destroy yakpa Say, Since February 28, Iran don dey fire missiles and drones enter Israel and Gulf countries wey get U.S. military base.

todayMarch 6, 2026 15

Sports

PSG And Bayern Munich Enter Race To Sign Victor Osimhen

Five big European clubs don enter serious battle to sign Victor Osimhen from Galatasaray as summer transfer window dey approach. Bayern Munich dey plan to bring Osimhen replace Harry Kane, as coach Vincent Kompany wey don watch am since im Belgium days don give green light for di move. Paris Saint-Germain also dey chase Osimhen because dem want strong striker for their attack, while Manchester United, Juventus and Atletico Madrid still dey monitor im form and contract matter. Di 27-year-old […]

todayMarch 5, 2026 7

Lagos

Lagos State Farmers Collobi FG Support To Boost Food Security

Federal Government don empower small-small farmers for Lagos State with farm inputs to help boost food production and improve food security for Nigeria. Di empowerment programme wey Federal Ministry of Agriculture and Food Security carry out happen for Agege, Lagos on Thursday, and dem give 68 farmers cooperatives farm materials. Agriculture Minister Abubakar Kyari, wey Dr Marcus Ogunbiyi represent, talk say di programme na part of Presido Bola Ahmed Tinubu Renewed Hope agenda to fight food shortage, reduce farming cost […]

todayMarch 5, 2026 10

obodo oyinbo

First Rescue Flights Carry Stranded Israelis Back To Tel Aviv

First two flights wey carry Israelis wey dey stranded for abroad because of Middle East war don land for Tel Aviv on Thursday, after airspace close when United States and Israel launch strike against Iran. Di  flights land for Ben Gurion Airport, wey still remain closed for commercial flight operations, as first flight wey El Al Airlines operate come from Athens, while second flight wey Israir Airlines operate come from Rome, and each flight carry 170 passengers. Transport Minister Miri […]

todayMarch 5, 2026 6

Sports

WAFCON 2026 Fit Hold For July

Di 2026 edition of WAFCON 2026 fit move go July as uncertainty still dey around di original schedule. Di tournament suppose hold between March 17 and April 3 for Morocco, but preparation and organization wahala don raise doubt  whether competition go start as plan. Even though Confederation of African Football never officially talk anything, reports say dem don internally decide to postpone di tournament, and dem now dey consider July 25 to August 16, after FIFA World Cup 2026 wey […]

todayMarch 5, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app