Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Trump Wan Help Sort Thai-Cambodia Border Fight

By: Esther Ayoola Fight for Thai and Cambodia border don make ‘about 600,000 people comot from dia house, plus at least 20 people don kpai for di mata, According to officials, di wahala na because of border palava wey don dey for long time. US Presido Donald Trump, talk on thursday say, e wan yarn with Thai and Cambodia oga dem, make dem stop di fighting, sey e wan protect people wey dey suffer and make di area calm down.

todayDecember 12, 2025 5

Sports

Super Eagles Coach Chelle Drop Im Final 28-Man Squad For 2025 AFCON

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Eric Chelle, don announce him final 28-man squad for 2025 Africa Cup of Nations wey go hold for Morocco from December 21, 2025, reach January 18, 2026. Di team get three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders, and nine strikers. Big names wey no make di final list include Udinese goalkeeper Maduka Okoye and Wolverhampton striker Tolu Arokodare, but Francis Uzoho and Paul Onuachu don return to di national team after more than one year. […]

todayDecember 12, 2025 7

National

INEC Show Report Card Say Voter Registration Hit 2.6 Million

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say over 2.6 million Nigerians complete dia voter registration for di first phase of di Continuous Voter Registration wey end on December 10. INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, talk dis one for Abuja, and im say more than 1.5 million people register online while about 1.1 million do physical capture. Im add say di highest turnout come from Osun, Kaduna, Plateau, Imo, Borno and Lagos states.  

todayDecember 11, 2025 7

National

Defence Minister Declare Say New Generals Must Fight Security Wahala

By: Rilwan Agbomeji Di minister of defence, Gen. Christopher Musa (rtd), don tell newly promoted Nigerian army generals make dem bring fresh and better strategies to tackle security wahala for di country. E talk dis one during di decoration ceremony of 28 major generals for Abuja. Musa remind dem say Nigerians dey watch dem and dey expect results, and di security challenges na everybody own, so dem must face am with unity and determination.  

todayDecember 11, 2025 7

Sports

Super Falcons Fall Enter 37th For FIFA Ranking

By: Rilwan Agbomeji According to report say Super Falcons don drop enter 37th position for latest FIFA Women World Ranking. FIFA release di new ranking on Thursday, and di Falcons no play any match during di last international break. Dem bin before dey 36th position for di world. Even with di drop, Naija still dey hold number one spot for Africa.  

todayDecember 11, 2025 10

foreign

How Tanker Wey US Seize Take Hide Im True Location

By: Rilwan Agbomeji US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast. Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement. Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover track. US Attorney General Pam Bondi talk say di vessel […]

todayDecember 11, 2025 7

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e no gree talk anything before e end call.

todayDecember 11, 2025 7

foreign

Jaguda Boy Use Hand Touch Bristol Museum ,Thief 600 Artefacts

By: Alice Iduh Bristol  for inside United kingdom dey shake say, some Jaguda boys enter dia museum thief about 600 of dia precious artefacts wey dey show link between Britain and former British Empire don vanish. Police talk say dem comot am for museum since September 25. Avon and Somerset police don release CCTV wey show four men wey police dey find, dem dey outside di building wey hold di collection.

todayDecember 11, 2025 8

Lagos

Lagos Police Clear Inspector Weh Dem Beat For Oshodi Say Im Nor Thief

By: Alice Iduh Lagos State Police don clear tori wey dey go viral, say one inspector wey area boys beat for Oshodi inside video dat im thief, nor thief anytin. Na for inside statement on Thursday by police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi,Police talk say na lie, say di officer dey do im official work wen di wahala hapun. Adebesi yarn mata dat,di inspector dey Lagos State Taskforce, and e dey stop illegal parking for Brown Street, Oshodi. And dat […]

todayDecember 11, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app