Blog masonry

Background

National

Reps Drag Women Affairs Ministry On Gender Equality And Welfare

Di House of Reps committee on women affairs don yarn make Ministry of Women Affairs deliver proper, dey promote gender equality, protect women and girls rights, and push welfare mata well well. Di committee chairperson, Hon. Kafilat Ogbaran yarn dis dis week during oversight meeting with Hajiya Imaan Ibrahim for National Assembly. She yarn say dis oversight na to confirm say money wey dem dey drop go giv Naija women and girls beta life.

todayDecember 5, 2025 11

Sports

Ndidi Go Captain Super Eagles After Troost-Ekong Retirement

Wilfred Ndidi don become Super Eagles captain for AFCON 2025 afta Troost-Ekong retire. Ndidi, wey don lead Eagles for 2026 FIFA World Cup African playoffs, na now im dey front line as di most senior padi for di team. Di 28-year-old Besiktas star don make 71 appearances since 2015, and then Moses Simon go dey back am up as assistant captain.

todayDecember 5, 2025 8

National

Imo Police Burst 2 Kidnappers, Nab 12

By: Rilwan Agbomeji Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest. DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again. Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for Anti-Kidnapping Unit (AKU), wey dem dey call Tiger Base.” CP […]

todayDecember 5, 2025 10

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man Everton for Old Trafford. Di match bin dey under United […]

todayDecember 5, 2025 8

Lagos

NDLEA Fire Up Youth Summit To Fight Drug Wahala

By: Esther Ayoola Lagos don start anoda  fight against drug wahala as the State Interministerial Drug Abuse Control Committee join body with NDLEA begin two-day youth summit for Agege on Thursday. The event wey happen for Oba Sanni Komolafe Youth Centre pack students, teachers, health experts and youth leaders under one theme: Drug/Substance Abuse and You: Wetin Every Young Person Suppose Know. Olawale Poluyi, wey deliver keynote on top Lagos Health Ministry matter, hail the students for show face well-well […]

todayDecember 5, 2025 5

Business

Lagos Go Double ICT Power, Target Global Tech Hub by 2030

By: Esther Ayoola Lagos Commissioner for Innovation, Science and Technology, Olatunbosun Alake, don announce say by 2030, the state wan double 100% increase ICT contribution to Lagos economy, and dem no dey slow down. Alake drop this bombshell on Thursday for Art of Technology Lagos 7.0 wey carry the theme Future Technologies and Sustainable Lagos. E yarn say Lagos go boost invention and scientific research by 50%, make the state the number one place to solve its own wahala through […]

todayDecember 5, 2025 8

Entertainment

Waje Land Abuja, Shake Gov Wives Conference With Strong Talk

By: Esther Ayoola Nigerian singer and humanitarian Waje scarra area for inside the 6th Nigerian Governors’ Conference, where big madams, policymakers, and development partners gather discuss women, health, education, youth and social welfare wahala. Waje, wey don always fight for women rights and youths, join the conversation on how influencers fit shape society and push better change. She yarn say policies nor dey enough, na the everyday behavior wey people show online and offline dey decide the kind society we […]

todayDecember 5, 2025 4

Entertainment

Wizkid and Asake Don Join Hands for EP “REAL (Vol. 1)” This December

By: Esther Ayoola Tori don land for music fans! Wizkid and Asake don announce say dem dey drop collabo drop EP “REAL (Vol. 1)” this December, and fans don dey ginger for di collabo. The two both of announce for the x handle, even show small snippet of tthe track “Jogodo” during Apple Music 1 appearance with DJ Tunez, give people taste of wetin dey come. Asake yan say their bond no just dey music, e deep and “real,” show […]

todayDecember 5, 2025 9

Niger Delta

Apc Cross River Wahala: National Body Block Eba Removal

By: Alice Iduh Progessives Congress wahala for Cross River don scatter reach national level as di party National Working Committee don All overturn di move wey State EXCO make to remove dia chairman, Alphonsus Ogar Eba. National Legal Adviser, Murtala Aliyu, send letter wey summon Eba make e come Abuja on Monday, December 8, to answer di vote of no confidence wey dem pass for am. Di summons land as majority of SEC members talk say di System no want […]

todayDecember 5, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app