Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Police Commissioner Drop Security Alert

By: Esther Ayoola Lagos Police commissioner Olohundare Jimoh don shake table oh, say make Lagos resident dey always dey alert of security. Jimoh dey yarn dis one give tori pipo as im dey mark one year for inside office. Giving his report card , Jimoh say, just one year im don spend for office, dem don recover over 150 vehicle from jaguda boys, gingering resident to dey at alert always.

todayFebruary 18, 2026 4

Sports

FA Cup Round of 16: Arsenal, Chelsea, Liverpool, Man City Know Opponent

By: Esther Ayoola Premier League big clubs Arsenal, Liverpool, Chelsea and Manchester City don sabi who dem go play for FA Cup Round of 16. Arsenal go play lower league team Mansfield Town, while Chelsea go face Wrexham. Manchester City go play Newcastle United, and Liverpool go rugged Wolves wey dey try avoid relegation. Other games na Fulham vs Southampton, Sunderland go play Port Vale or Bristol City, Leeds go face Norwich, and West Ham go play Macclesfield or Brentford.

todayFebruary 17, 2026 14

Sports

Spalletti Rake For Newspaper Say Juventus Go Block Osimhen Progress

By: Esther Ayoola Juventus coach Luciano Spalletti, wey be Victor Osimhen former coachie for Napoli  say, im  believe im boys to  stop Victor Osimhen Galatasaray for Champions League. Di two teams go play first leg for RAMs Park on Tuesday night. Osimhen don score six goals for six Champions League games dis season. However, Spalletti say, if Juventus must progress, e dey importankpa for dem to stop Gala deadly stikers Osimhen and Mauro Icardi.

todayFebruary 17, 2026 8 2

Sports

FIFA Maintain Composure For NFF Petition Against DR Congo

By: Esther Ayoola Say, FIFA never still tuk anytin about di petition wey Naija Football Federation (NFF) put, dat, DR Congo play ineligible players for last November 2026 World Cup African play-offs, According to report, Nigerians waiting on Monday na another level, because di intercontinental play-offs go happen from March 26 to 31 for Mexico. But unto update, NFF Presido Ibrahim Gusau tuk for social media, say dem never hear from FIFA. For NFF say dem don do dia part, […]

todayFebruary 17, 2026 13

obodo oyinbo

President Trump Insist Say Im Go Put Eye For Iran-US Nuclear Tuks

By: Esther Ayoola U.S. Presido, Donald Trump say im go dey “indirectly” involve for di second round nuclear tuks wey go happen for Geneva between US and Iran. Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don already land Geneva for meeting before di tuks proper. Tension for Gulf, still dey high, as US don send another aircraft carrier, and Iran for dia part through dia Supreme Leader Khamenei, say, any attack, go start regional war. Trump dey insist say di tuks important, […]

todayFebruary 17, 2026 8

obodo oyinbo

Prime Minister Albanese Insist Say, Australia No Go Rescue ISIS Woman An Pikin From Syria

By: Esther Ayoola Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat  Australian  go send  woman an pikin wey get tie  with ISIS fighters. Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision. Albanese say any person wey use im two eyes join ISIS, terrorist group, make dem face di […]

todayFebruary 17, 2026 6

National

Medipool And FG Join Body To Boost Local Medicine Production For Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don sign Memorandum of Understanding (MoU) with ogbonge Medipool to make local drug manufacturing for Naija grow. Oga coordinating minister of Health, Professor, Ali Pate don describe dis partnership correct access to ogbonge medicine, reducing importation of medicine. Pate say e go also support beta healthcare and boost production of important local drugs.

todayFebruary 17, 2026 6

National

WAEC Release Second CB Result

By: Esther Ayoola WAEC don release di 2025 Second Series CB-WASSCE results for private candidates, According to a statement by Acting Head of Public Affairs, Moyosola Adesina,  on Monday for Lagos, say  Candidates fit check dia results online for www.waecdirect.org before dem fit collect digital certificate for www.waec.org. To get hard copy certificate, candidates suppose apply online through WAEC e-Certman portal at https://certrequest.waec.ng/, as WAEC advise make dem act quick. Say na Total of 65,752 candidates sit for di exam […]

todayFebruary 17, 2026 11

National

Gbajabiamila Press Yans Dat Education Na Mission For Renewed Hope Agenda

By: Esther Ayoola Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, don repeat tuks, say education na key part of President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda. Im yarn dis one for Abuja during 2026 International Day for Education Conference wey Speaker Tajudeen Abbas organise. Gbajabiamila say if Naija wan compete well for global knowledge economy, e must invest serious for education and carry young people along.

todayFebruary 17, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app