Blog masonry

Background

Lagos

Court Jail Three Suspects Say Dem Import GunĀ 

Senior Man judge for Federal High Court insideĀ  Lagos don cut pipo joy short, order make three suspects wey Customs gbab over alleged unlawful importation of pump-action rifles remain for Correctional Centre for 15 days. Na Justice Friday Ogazi give di order on Wednesday against Kenneth Mbonu, Kenneth Agwu and Choima Onuoha, pending di completion of investigation into di case. Di suspects go remain for custody until September 1, 2026, when di court go receive report on di investigation or […]

todayAugust 20, 2026 9

Sports

Haaland Lead Race For Premier League Golden Boot

By: Mariam Ajayi Erling Haaland go enter di new Premier League season as di biggest favourite to win Golden Boot after e score 27 league goals last season. Di Manchester City striker don win di award three time for four season and e dey target fourth Golden Boot. Liverpool forward, Alexander Isak dey among di main player wey fit challenge Haaland, although injury affect im campaign last season. Brentford striker, Igor Thiago also dey chase di prize after e score […]

todayAugust 19, 2026 25

Politics

Fayose Claim Say Accord Spend N40bn for Osun Election

By: Mariam Ajayi Former Ekiti State Gofnor Ayodele Fayose, claim say Accord Party spend at least 40 billion Naira for di August 15 Osun State gofnorship election. Fayose make di claim for video interview with TVC journalist,Ā  Nifemi Oguntoye wey dem post for X on Wednesday. Dis statement come after Davido allege say APC spend N110 billion on vote-buying during di election. Davido, wey be Accord candidate, Ademola Adeleke nephew, however say di party no spend money and instead rely […]

todayAugust 19, 2026 21

National

Wike Ban Cars For Abuja Green Areas

By: Mariam Ajayi FCT Minister Nyesom Wike don order immediate ban on cars and other unauthorised business for green area, park and garden across Abuja. Wike also order di touchlighting into civil servant wey allegedly dey approve conversion of recreational and protected area into car dealership. Di FCT Administration announce di directive on Wednesday, saying di move dey aimed at enforcing Abuja Master Plan and stopping illegal development. Di decision come as concern dey rise over flooding and indiscriminate development […]

todayAugust 19, 2026 25

OBODO NAIJA

Naija Begin Send Onion Give Ghana

By: Mariam Ajayi Nigeria don lift suspension on onion exports to Ghana, clearing di way for immediate resumption of cross-border onion trade between both country. Di National Onion Producer, Processor and Marketer Association of Nigeria say di decision follow consultation with trade pipo, diplomatic authority, ECOWAS and other stakeholder. NOPPMAN President, Alhaji Aliyu Isah Maitasamu, na im announce di decision for public notice dated August 19, 2026. Di association say dem suspend di export earlier because of problem wey Nigerian […]

todayAugust 19, 2026 17

obodo oyinbo

US Coast Guard Comot 12-Year Restriction On Top Nigerian Ports

By; Mariam Ajayi Nigeria don score major victory for maritime sector as United States Coast Guard don lift 12-year security restriction wey dey affect vessels coming from Nigerian ports. Minister of Marine and Blue Economy, Adeboyega Oyetola, say di development show say Nigeria don make serious progress in maritime security and implementation of international port safety standards. Di restriction wey start for 2014 had made vessels wey call at Nigerian ports face extra inspections and security checks before entering US […]

todayAugust 19, 2026 16

obodo oyinbo

Drone Strike kpai Six Pipo For Gaza

By: Mariam Ajayi Gaza City don turn scene of panic after drone strike knack one police post, kpai about six pipo,Ā  and wunjure several others. Di attack happen for busy hours for central city, close to di municipality and one park wey childrensis and other residents dey gather. Local paramedics say di casualty figure fit rise as emergency workers dey rush victims wey wunjure for treatment. Earlier, another attack knack one motorcycle for Nuseirat refugee camp, kpai one pesin, kon […]

todayAugust 19, 2026 18

Sports

Man United Table £60m For Baleba

By: Mariam Ajayi Manchester United don make initial Ā£60 million offer for Brighton midfielder Carlos Baleba as dem continue to strengthen dia midfield ahead of di new season. United bin try sign di Cameroon international last summer but Brighton valuation wey pass Ā£100 million make di deal no happen. But Baleba price don drop significantly and after United fail to sign Matheus Fernandes, dem don return for di midfielder again. Brighton valuation still dey above United offer, but both clubs […]

todayAugust 19, 2026 21

Local

Gunmen Kill 24 People For Plateau Community

By; Mariam Ajayi At least 24 people don die while several others sustain injuries after gunmen attack Binper community for Mangu Local Government Area of Plateau State. Residents say di attack happen between Monday night and early hours of yesterday. One eyewitness, Daniel Musa, say di heavily armed attackers move from house to house, forcing dia way inside homes. E say di gunmen attack residents wey dey sleep, leaving many people dead and others injured

todayAugust 19, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds