Blog masonry

Background

Lagos

Police Catch Four Cultists

Lagos State Police Command don catch four suspected cultists and recover gun, bullets, plus jackknife during one sharp operation wey dem do for Egbeda area. Di Command tok-tok person, SP Abimbola Adebisi, naim use a yam chop mouth on Thursday tuk how police use small jet li move to go gbab dis pipo  for midnight inside Alimosho axis. Among di tins wey di police dem collect from dia hand na one locally-made pistol, one English Beretta pistol wey dem load […]

todayJune 5, 2026 17

Sport Yarns

Napoli  Wave Bye-Bye to Conte, Allegri Fit Take Over

By : Jolayemi Olajide Napoli don confirm say coach Antonio Conte dey leave di club before im contract finish. Conte wey help Napoli win Serie A title for 2024/25 season fit soon return as Italy national team coach. Reports say Napoli don dey discuss with Massimiliano Allegri to take over di coaching job. Allegri recently lose im position after AC Milan fail qualify for next season Champions League.

todayJune 4, 2026 12

obodo oyinbo

Oil Price Jump as Trump Vow Say Iran Sea Blockade Go continue

By : Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump dey press tuk  oh,  say US naval blockade for  Iran go fit last for months, as oil price go rise, dat dem nor understand wetin IRAN dey do. According to tatafo, Trump go gat wait for fresh military briefing on possible action against Iran from top US military commander Admiral Brad Cooper. As peace tuks between Iran and America still nor get beta head, Trump and Russian President Vladimir Putin talk on […]

todayJune 4, 2026 14

OBODO NAIJA

Judge Order Sowore To Con Defend Imself Why Im Call President Bad Name

By : Jolayemi Olajide Justice Mohammed Umar for Federal High Court, Abuja don order Omoyele Sowore, the AAC presidential candidate, to appear an  defend imself  for accusate   im call President Bola Tinubu bad name for nothing. Di judge fling Sowore lawyer, Marshall Abubakar, wey bin dey beg make court forget di mata, con order say the hearing must happen every day starting from Friday, June 5. The Department of State Services (DSS) dey push the case against Sowore sake of […]

todayJune 4, 2026 10

OBODO NAIJA

President Tinubu Send Letter Give Senate for  Marwa  to Join NDDC Board

By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don write  Senate say  make dem look into into di appointment of Dr Zainab Marwa as member of the Niger Delta Development Commission (NDDC) governing board. Baba Seyi put dis one for request letter give  Senate Presido, Godswill Akpabio,  am im read am out  for dia  meeting on Thursday. Inside di letter, Tinubu  say Dr Zainab Marwa go  represent the North-East zone for the NDDC board. He con add say dis […]

todayJune 4, 2026 12

Lagos

Lagos Assembly Agree New Bill Wey Go  Hellep  Future Generations 

By : Jolayemi Olajide Lagos Assembly don gree on the new Lagos State Wealth Fund Bill, 2025 to keep money for future generations. Di oga  kpatakpata of Finance Committee, Hon. Obafemi Saheed,  dey ground for di house of assembly read di report to the House after di bill pass second reading. From dere,  senior man Speaker,  Mudashiru Obasa con konfam dis ogbonge bill wey go make Lagos rich, say na only people wey get sense and heavy experience go manage […]

todayJune 4, 2026 9

Lagos

Lagos CP Tell Residents to Blow Whistle for any Corner-Corner Movement

By: Jolayemi Olajide Lagos  Oga Commisioner of Police,  Tijani Fatai,  strong face today,  condemn di school kidnapping katakata for Oyo State. Oga Fatai  yarn dis one on Thursday, when konfam 89.5FM newsroom waka go pay am courtesy visit for im office. As questions take reach im side  concerning di security mata for Lagos, di CP yarn say, for now, Lagos dey calm and peaceful but di police still need beta help say,  na corporation dey make rice full pot. Oga […]

todayJune 4, 2026 8

Sports

Poland Fall Super Eagles Hand

Naija Super Eagles drop standard last-minute as Poland hold dem to 2-2 draw for inside Warsaw on Wednesday. Terem Moffi naim bin give Naija the lead for 23 minutes, but Poland score back before half-time. As di match almost finish, Przemysław Wiśniewski just sharply score with di last kick of di game to spoil Nigeria win.

todayJune 4, 2026 15

Politics

First Lady Launch Women Support For Baba Re-election!

First Lady Senator Oluremi Tinubu don launch one new political group wey dem dey call Tinubu Torchbearers (TTB) for Abuja on Wednesday June 3, to start solid mobilization for President Bola Tinubu re-election work. Mama Tinubu charge all di APC women leaders make dem carry di "Renewed Hope Agenda" story go down to di grassroots, wards, and polling units across di country. She yarn say women na di heartbeat of every community, and dem must stand gidigba to yarn pipo […]

todayJune 4, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds