Blog masonry

Background

obodo oyinbo

NAF Airstrike Kpai Several Terrorists For Sambisa Forest

Nigerian Air Force (NAF) say dem do commando through Air Component of Operation HADIN KAI carry out precision airstrike for Yuwe axis inside Sambisa Forest on Monday, kpai several terrorists. According to NAF tuk, tuk, Air Commodore Ehimen Ejodame, di operation follow credible intelligence wey Intelligence, Surveillance and Reconnaissance (ISR) confirm, Say na only terrorists dey inside fortified bunkers and structures wey collect wetin nor good. NAF say the attack na part of sustained pressure to clear terrorist elements for […]

todayApril 21, 2026 11

obodo oyinbo

Gunman Kpai Tourist, Injure Six For Mexico

For Mexico, say one gunman open fire for Teotihuacan archaeological site for central Mexico, kpai one Canadian tourist and wound six other pipo, including visitors for Pyramid of di Moon area. Security official tuk say afta di attack, di gunman sti take im own life for di same site wey di tourists dey climb  to see ancient pyramids. Authorities confirm say di wounded victims, dem don carry dem go hospital, including one Canadian woman, one Colombian woman and her pikin, […]

todayApril 21, 2026 10 2

obodo oyinbo

Pope Leo Honour Late Pope Francis For 1st Death Anniversary

By: Esther Ayoola For Vatican City, Pope Leo XIV don mark oneyear afta di death of Pope Francis on Tuesday, as he call on Catholic faithful worldwide to continue the mission of mercy and brotherhood wey Francis stand for. Pope Leo, for message wey im post on X (formerly Twitter), say, dem sti carry Pope Francis words and actions for heart. He add say di Church go continue to preach Gospel joy, God mercy, and promote unity among all men […]

todayApril 21, 2026 11

Lagos

Lagos Lawmaker Promise More Projects As Road Work Continue For Oshodi

By: Esther Ayoola For Oshodi/Isolo Constituency I for Lagos State, House of Assembly member Hon. Stephen Ogundipe on Monday don go promise residents say more development projects. Di senior man make dis announcement as im go inspect ongoing road works for di area. Ogundipe use im mouth tuk say im check four roads Oluwasanmi, Baba Ode, Deji Adeoye, and Alhaji Sokoya streets, and body sweet am for di quality of work wey im see dia. He also praise oga Presido, […]

todayApril 21, 2026 17

Lagos

Jandor Tuk Why Lagos Governorship Race Dey Open, Say Hamzat Never Declare

By: Esther Ayoola Lagos 2023 governorship candidate of di pipos democratic party, Abdulazeez Adediran, AKA Jandor, don go pour cold water for Lagos Politics say Deputy Govo, Obafemi Hamzat, never declare say e wan contest 2027 governorship election. Jandor yarn dis one for TV sitdon tuk on monday E say Hamzat get plenty experience as deputy governor, but for now, no clear sign say e don enter race. According to Jandor, Baba Seyi never endorse anybody to carry APC flag […]

todayApril 21, 2026 11

Lagos

INTERPOL Catch Runaway Lagos Bizman Over Alleged Double Kpaing

By: Esther Ayoola Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks. AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan. According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta e run comot since police declare am wanted on February […]

todayApril 21, 2026 9

Lagos

How Speeding Tanker Jam And Kpai Dispatch Rider For Alapere

By: Esther Ayoola Say one serious road askident wey hapun for Motorways Inward Estate area for Alapere, Lagos State, don kpai one dispatch rider. According to Lagos State Traffic Management oga, Adebayo Taofiq, di askident involve empty NIPCO Tanker and di rider. Taofiq say di tanker driver bin dey speed when e jam di moving dispatch rider, and di rider kpai on di spot. LASTMA officials quickly rush go di scene to control di wahala as other dispatch riders vex […]

todayApril 21, 2026 10

National

PDP South-West Hail Seyi Makinde, Say Im Na Strong Man For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Di Pipos Democratic Party South-West leaders don praise Seyi Makinde, say im na senior man behind Naija multi-party democracy. Dem yarn dis one on Monday for press conference wey dem hold for Ibadan. Party’s Zonal Publicity Secretary, Chief Sanya Atofarati, naim carry im mouth take explain dis mata for di press conference Im say, Oga Makinde don show true character through im policies and actions, and dat na man im be for democracy.

todayApril 21, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds