Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Senate Nack Federal Gornment  Akpako for Head  Say Make Dem Sharply Rescue Oyo kidnap victims

  Nna wa o, for inside Abuja, the Senate don nack Federal Gornment and security people strong Akpako for head say  make dem sharply rescue the Oyo State school students and teachers Wey bad boys kidnap. Na Senator Abdulfatai Buhari carry the mata  tuk first  say around 46 people dey inside the kidnappers net. While  Senator Adams Oshiomhole tuk about o how the military dey spend  money Wey dem dey give dem to fight insecurity, other senators look am sideways […]

todayJune 3, 2026 13

OBODO NAIJA

Court sentence four Owo church attackers to death, release one person 

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don sentence four guys to death by hanging because of the deadly attack wey dem do for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State. Justice Emeka Nwite convict di four bad boys on Wednesday after the judge see say di evidence wey DSS bring clear wetin nor good, say dem be part of di  terrorist group wey commit the crime. Di convicts, Idris Abdulmalik Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, […]

todayJune 3, 2026 12

Lagos

Lagos Goment Carry 45 Beggars Commot For Oshodi, Agege And CMS

By : Jolayemi Olajide Lagos State Goment don carry 45 beggars, including grown-up pipo and pikin dem, commot from road during enforcement operation for Oshodi, Agege and CMS. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis tori for statement wey im post for im X page on Wednesday. According to am, dem arrest 22 beggars for Oshodi and Agege, and di people wey dem carry include adults and some teenagers. Im still tok say dem pick another 23 […]

todayJune 3, 2026 11

OBODO NAIJA

Wike Tell Police Say Make Dem Arrest Pipo

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike don order security agencies on Wednesday, June 3, make dem arrest any person wey dey drop former President Goodluck Jonathan picture everywhere for Abuja to cause political katakata. Wike yarn say e pure wrong make anyone dey parade Jonathan as presidential candidate when di man himself never use e own mouth talk am. Di minister clear air say candidate na person wey run election win and collect certificate of return, not to […]

todayJune 3, 2026 321

OBODO NAIJA

How N100k Minimum Wage Fit Kill Small Business

By : Jolayemi Olajide Private sector pipo don raise alarm say make nobody force dem to pay N100,000 minimum wage like some states dey do. Business groups yarn say na only few big companies fit afford am, while small and medium shops dey suffer inflation, fuel wahala, light bill and customer scarcity. Di warning land as talk dey fly about new general minimum wage, with some governors already lifting workers pay. As LCCI boss Leye Kupoluyi clear am, “gornment no […]

todayJune 3, 2026 11

National

President Tinubu, National Assembly Set Correct Activities To Celebrate June 12

By: Esther Ayoola Wi oga President Bola Tinubu don ready to scatta mouth with the National Assembly join-together address di country for 2026 Democracy Day. Di Inter-Ministerial Committee wey dem start on Tuesday tuk say other correct activities like Juma’at prayers, church service, and public lecture go also shele before di main day reach. Inside di program, special youth and women events go hold on June 10, then di Presido go do im personal broadcast and Gala night to wrap […]

todayJune 3, 2026 15

National

FG Tighten Ebola Check For Airports, Borders And Seaports Across Naija

By: Esther Ayool Federal Gornment don tighten Ebola check for airports, seaports and land borders across Naija to stop di virus from entering. Assistant Director Naija body mata pipo, Ado Bako, tuk say Naija never record any confirmed case yet. Ministry of Health yarn say travellers wey show symptoms or dem mark as high-risk go face extra screening, isolation and referral. As elders dey tuk, “better to close door before thief enter,” so gornment don act quick because of di […]

todayJune 3, 2026 17

National

NANS Students Rise To Protest For Di 42 Borno Pupils Wey Kidnap Carry

By: Esther Ayoola NANS don drop words say students for North-East go march peaceful protest from June 5 to June 7 over di 42 school children wey gunmen carry for Borno.Chief of Staff to di Zonal Coordinator, Lukman Yusuf, announce say di action go happen same time for Borno, Bauchi, Gombe, Adamawa and Taraba. As elders dey tuk, “when pikin dey cry, e dey find something,” so di protest na to draw national eye, make gornment and security pipo rush […]

todayJune 3, 2026 10

OBODO NAIJA

Datti Baba-Ahmed Leave Labour Party Finally For PRP

By : Jolayemi Olajide Yusuf Datti Baba-Ahmed don waka comot from Labour Party enter Peoples Redemption Party (PRP). Im tuk dis one for one podcast on Wednesday, say Peter Obi suppose first settle Labour Party gbege before e im piante comot di party. Datti clear mata say e no be Obi shadow, na im own mind dey guide am. Normal say goat dey follow farmer, nor mean say goat go chop farmer food.

todayJune 3, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds