Blog masonry

Background

National

APC Release 2027 Election timetable, Presidential Ticket For ₦100m, and Govo ₦50m

By: Esther Ayoola Say like dis All progressives Congrees APC don release dia timetable and schedule of activities for di 2027 general elections. Dis na according to statement wey di party National Publicity Secretary, Felix Morka tuk  wey im joinbodi sign with National Organising Secretary, Sulaiman Argungu on Monday for Abuja. Part of di schedule na how dem go run screening, appeal process and party primary elections for different positions, to show how candidates go emerge. Di statement also tuk […]

todayApril 21, 2026 14

National

Wike Declare Say PDP Door Sti Open For Returnee

By: Esther Ayoola Minister of FCT, Nyesom Wike, on Monday for PDP 108th National Executive Committee (NEC) meeting, say door sti open for dia pipo wey run comot di Pipos Democratic Party to return. Wike give di message as e dey address party leaders and members, and e advise di Abdulrahman Mohammed-led National Working Committee to continue reconciliation work. Im say na through forgiveness, dialogue, and unity, PDP fit rebuild trust and become stronger as political party.

todayApril 21, 2026 9

National

Oluyede Tell Troops Not To Relax For Naija Bandits

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, don tell troops of Operation Fansan Yamma make dem continue serious fight against bandits and criminals for North-West. Im yarn dis one when he visit dia headquarters for Gusau inside Zamfara State, where e check how ready di soldiers be and discuss security wahala for di area. According to Oluyede, say Naija must be saved by all means, no excuse.

todayApril 21, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Insist Say No End To Di Blockade Of Strait Of Hormuz Unless Iran Agree Peace Deal

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don tuk say dem nor go lift di blockade wey dem put for Iran ports until dem reach agreement with Tehran. Di US presido Tuk for im Truth social say di blockade don dey affect Iran badly and say US dey win di for now. Say like dis, di temporary ceasefire between US and Iran go end on Wednesday, but nobody sure if new peace tuk go sti hapun for Pakistan or not. […]

todayApril 21, 2026 11

obodo oyinbo

Cuba And US Hold Respectful Tuk For Havana To End Oil Blockade

By: Esther Ayoola Cuban gornment don konfamat on Monday for Havana say, dem hold tuks with United States officials as tension sti dey between both countries over US energy and oil blockade for Cuba. Deputy director general for US affairs for Cuba Foreign Ministry, Alejandro Garcia del Toro, naim dey konfam dis mata say US delegation include assistant secretaries of state, while Cuba side send deputy foreign minister level pipo come di meeting. E explain say di tuks hapun with […]

todayApril 21, 2026 10

Sports

Shaibu Open Tuk On How Naija Wan Take Train Football Coaches

By: Esther Ayoola Director-General of National Institute for Sports, Philip Shaibu, don tuk say Naija get serious shortage of coaches. Im yarn dis one during im visit to NFF office for Abuja on monday, where e also go pay condolence for late former NFA chairman, Ibrahim Galadima. Shaibu tuk say dem get two-year plan to work with NFF to solve di coaching wahala and improve sports for di country. Im sti add say recent admission for di institute show say […]

todayApril 21, 2026 9

Sports

Wolves Enter Championship With Five Games Remaining Afta Poor Season

By: Esther Ayoola Wolves don drop from Premier League afta bad 2025/26 season wey no go well at all. Dem lose 3-0 to Leeds for weekend, and for small moment dem sti get hope when Spurs draw late against Brighton. But West Ham draw with Crystal Palace on Monday night finish everything, dat one mean say Wolves dey go Championship. Na with five matches remaining, dem nor go fit escape relegation again.

todayApril 21, 2026 15

Sports

Bournemouth Appoint Marco Rose As New Coach

By: Esther Ayoola Bournemouth don announce say dem don appoint Marco Rose as dia new head coach. Di German coach go take over from Andoni Iraola for summer as e sign three-year contract wit di club. Iraola self don tuk say e go comot when im contract finish for di end of dis season afta three years for di job. Na so Bournemouth dey prepare for new era under Rose wey go start soon.

todayApril 21, 2026 9

obodo oyinbo

One Kpai As Trolleybus Crash Enter Supermarket For Austria

By: Esther Ayoola Nor be small wahala for Australia as trolleybus lose control and crash enter supermarket for Salzburg, Austria, kpai one wunjure Seven. Na Austria Red Cross dey konfamate dis incident, say despite effort to revive di victim, di person no survive. Dem say emergency responders rush go the scene and carry di wujured go hospital, with two pipo in serious condition. Authorities say di crash hapun for one junction for northern Salzburg, but dem never explain wetin really […]

todayApril 20, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds