Blog masonry

Background

Lagos

Customs Hand Over 399 Seized Rifles To NSA

Nigeria Customs Service, NCS, don hand over more dan 399 seized rifles to di office of National Security Adviser, Nuhu Ribadu, as part of efforts to stop illegal arms movement for di country. Customs boss, Adewale Adeniyi, talk on Monday say di service don finish examination of di arms wey dem seize for Tincan Island Port, where dem find 399 fully assembled Jojef firearms plus plenty rifle parts. Adeniyi warn say criminal networks fit try use Nigeria borders, ports and […]

todayAugust 18, 2026 22

Entertainment

Must Read: Celebrity Break Up – Frank Edoho Story

Written by: Kofoworola Olayinka   Make we talk truth oooo, when celebrity love break, everybody go hear am. Celebrity breakup no dey ever dey quiet, once social media catch am like dis, di whole internet go turn microphone. For Naija entertainment, we don see plenty celebrity marriages wey start with love, glamour and beautiful pictures, but later end with breakfast and public drama. Make we give enter di mata wey sup between Frank Edoho and him second wife, Sandra Onyenucheya. […]

todayAugust 17, 2026 137 270

Sports

Rodri Go Wear Number 16 Jersey For Barcelona

Spain international and Manchester City midfielder, Rodri, go wear number 16 jersey for Barcelona after e ask Fermín López make e give am di number. Na Football transfer expert, Fabrizio Romano, reveal say Rodri don already discuss di matter with Fermín, wey go switch to number 7. Rodri dey set to join Barcelona from Manchester City and e go sign four-year contract wey go keep am for Camp Nou till June 2030.   Read similar stories:https://konfamfm.com/maresca-say-man-city-problem-no-be-only-because-rodri-no-play/

todayAugust 17, 2026 32 1

obodo oyinbo

Trump Wan Share Bomb Giv Oman On Top Hormuz Marras

US Presido Donald Trump on Monday don threaten to bomb Oman if di country try block any US deal with Iran over Strait of Hormuz, as e also tell Iran make dem surrender. Iran and Oman officials don dey hold talks for weeks on how ships go take pass through di important waterway, and Iran Foreign Ministry say both sides dey work on joint agreement. But Trump still dey insist say US get control of Strait of Hormuz, even as […]

todayAugust 17, 2026 13

OBODO NAIJA

Over 200 KASU Lecturers Stop Work, Tok Say Strike Fit Start

Nor be small gbege for Kaduna state university, say Over 200 professors and other academic workers don comot from Kaduna State University, KASU, over poor working conditions and di university failure to implement di 2025 Federal Government-ASUU agreement. ASUU-KASU chairmo, Abubakar Abdullahi, fry dis mata on Monday for press conference for di union secretariat inside Kaduna State University. Abdullahi say di 2025 FGN-ASUU agreement, wey suppose improve working conditions for lecturers across Nigerian universities, take effect from January 2026, but […]

todayAugust 17, 2026 21

OBODO NAIJA

Edo Assembly Speaker Comot From House of Assembly

Edo State House of Assembly Speaker, Blessing Agbebaku, don resign on Monday as some lawmakers dey move to impeach am, and im media aide, Ivy Ebojele, konfamate say he don comot. After di resignation during Monday plenary for Edo Assembly, Yekini Idiaye, wey represent Akoko-Edo Constituency 1, don emerge as di new Speaker. Idiaye tell journalists after di sitting say Agbebaku leave office because of poor leadership and alleged corruption, with too many adjournments during im time as Speaker.

todayAugust 17, 2026 16

Lagos

NDLEA Destroy N301bn Worth Of Drugs For Lagos

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don destroy almost 330,000 bag of drugs of different illegal drug wey worth about N301 billion for Lagos on Monday, following Federal High Court order. NDLEA Chairman Mohamed Buba Marwa say di exercise for Navy Town, Ojo, na part of effort to stop drug pipu and cut dia money supply. Di agency say di drug include cocaine, heroin, cannabis, methamphetamine, tramadol, codeine syrup and other illegal substances wey officers seize between April 2025 and May 2026. […]

todayAugust 17, 2026 16

obodo oyinbo

US Teen Weh Dem Accuse Say E Kill Mama, Brother After ChatGPT Search

By: Kofoworola Olayinka Police for Massachusetts don charge teenager Aravind as adult for allegedly killing him 45-year-old mama, Sudha Venkatesan, and him 14-year-old brother, Siddharth, for dia house for Acton. Middlesex District Attorney Marian Ryan say police find some disturbing thing for Aravind internet activity, including searching for idea about killing family member on ChatGPT. Police go di house around 6:30 p.m. on Tuesday after Aravind papa ask dem to check on di family because a tutor could not enter […]

todayAugust 17, 2026 20

crime& security

Police Arrest Woman Over Alleged Baby Theft In Kebbi

By: Kofoworola Olayinka Kebbi State Police don arrest Khadija on August 14, 2026, after she allegedly carry another woman newborn baby run away and present di baby to her husband as her own. Police say Khadija allegedly deceive her husband for about nine months say she dey pregnant, after she face pressure over her inability to have a child. Di suspect allegedly use opportunity to take di newborn after she was sent to fetch water, as police later recover di […]

todayAugust 17, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds