Blog masonry

Background

National

President Tinubu Tuk Why Im Nor dey Fear for Di 2027 Election

Wi oga Presido, Bola Tinubu don scata mouth again oh,  say e no dey fear any opposition, as e describe dem as pipo wey just dey make noise and wey nor understand law. E yarn dis one during meeting with Renewed Hope Ambassadors leaders from all 36 states for State House, Abuja on Thursday. Say Na oga of APC govos group, , Hope Uzodimma, wey be DG of the ambassadors, naim  carry im members go  meet baba Seyi, and im  […]

todayApril 17, 2026 15

National

Wike Blast Atiku, Call Am Serial Election Loser

FCT minister Nyesom Wike don blast former VP Atiku Abubakar, call am serial contestant wey dey always lose election. Dis one come after Atiku tuk  for interview say 2027 go be im last chance to run for president and label Bola Tinubu gornment as di worst. Na wia  Wike go inspect project for Abuja, wike take answer  Atiku, say di former vice presido  norbi sincere man, with wetin e tuk about Tinubu gornment.

todayApril 17, 2026 16

National

APC Chairmo, Yilwatda Press Tuk on Party Structure

APC National Chairmo, Nentawe Yilwatda, don clear mata say  nothing spoil  if more politicians  join di  APC  from opposition side. Im yarn dis one For one media chat wey happen for Abuja, Yilwatda say APC get solid system to manage different interests as membership dey grow. E still add say the party don already prove say dem sabi handle problems, so size nor mata at all.

todayApril 17, 2026 11

Obodo Niger

Police Explain how Kidnappers kramp JAMB Candidates For Benue

Police for Benue don konfam say gunmen kidnap 14 passengers wey  bin dey travel from Makurdi go Otukpo,  and dat, most of dem na JAMB candidates. Di Commissioner of Police, Ifeanyi Emenari, clear tori pipo say di mata hapun on Wednesday night when dem dey inside Benue Links bus. Emenari add say police don mobilise DPOs and other officers for Otukpo area to try rescue di victims. E also konfam say one person manage escape from di kidnappers hand.

todayApril 17, 2026 15

Lagos

Lagos Court Jail Pastor Say im Abuse Church member Daughter

  One 63-year-old senior man pastor, Chris Douglas, don chop life imprisonment dat, im nor fit defend imself before Lagos State Special Offences Court sitting for Ikeja, and dat im go rape church member daughter. Delivering judgment on Thursday, Justice Rahman Oshodi explain say Douglas, wey be General Overseer of Peculiar Generation Assembly Church, Oshodi, abuse im office. Say dat one mean say, im throwaway im members trust for sea water.

todayApril 17, 2026 38

Business

Speaker Obasa Explain Why Lagos Be Naija Number One Business Centre

By Ebi Oboko Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa,  don drop yarns, say Lagos go continue to push Nigeria economy forward, even though Abuja naim be di Federal Capital Territory. E yarn dis one when e receive new leaders of Lagos Chamber of Commerce and Industry wey Leye Kupoluyi lead come pay am courtesy visit for Assembly. Obasa explain how  Lagos still tey  be di best place for pipo wey wan invest for Nigeria, because of beta […]

todayApril 17, 2026 11

Sports

Bayern Run Comeback Beat Real Madrid 4–3 For Crazy Champions League Night

Say nor be small drama on Wednesday night for Allianz Arena for Germany,  wia Bayern Munich beat Real Madrid 4–3 to qualify 6–4 on aggregate for Champions League semi-final against PSG. Madrid start di match  very fast, as Arda Guler score just under one minute and later add another goal from free-kick, while Kylian Mbappe also score to give them strong fight. Bayern answer back through Harry Kane and other team efforts to level di tie and keep pressure on […]

todayApril 16, 2026 19

obodo oyinbo

Iran Military Make Move To Block Red Sea, Gulf Trade After U.S Naval Blockade 

Iran military don sama warning say dem go block trade for Red Sea, Gulf, and Sea of Oman if US naval blockade on Iranian ports continue. Military commander Ali Abdollahi and Iran central command na im tuk dis one for State broadcast. According to di senior men, US dey create cause problem  for Iran ships and oil tanker movement, and dis sef violate dia ceasefire agreement. Military commander Ali make clear dat dem ma ready to protect dia national interest […]

todayApril 16, 2026 17

OBODO NAIJA

Nigerian Army Bury Fallen General, Soldiers For Borno

For Nigerian Army side, dem don bury Brigadier General Oseni Braimah, Captain Ismail and oda soldiers wey die for recent attack for Borno State. Dem do di burial for Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri with full military honour. Na on April 9, fighters wey dem suspect say na Boko Haram and Islamic State West Africa Province attack soldiers for Benisheikh along Maiduguri-Damaturu road, kill di officers and men. Big people like Babagana Zulum and Christopher Musa show face for di […]

todayApril 16, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds