Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Nigerian Army Bury Fallen General, Soldiers For Borno

For Nigerian Army side, dem don bury Brigadier General Oseni Braimah, Captain Ismail and oda soldiers wey die for recent attack for Borno State. Dem do di burial for Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri with full military honour. Na on April 9, fighters wey dem suspect say na Boko Haram and Islamic State West Africa Province attack soldiers for Benisheikh along Maiduguri-Damaturu road, kill di officers and men. Big people like Babagana Zulum and Christopher Musa show face for di […]

todayApril 16, 2026 26

Politics

2027 Presidential Election Go Be My Last To Contest – Atiku Abubakar

Former Vice President, Atiku Abubakar don agree finally say na 2027 presidential election go be im last attempt to become Nigeria president. E yarn dis one on Wednesday night during interview for TV sit don tuk, when dem ask am about im age and di coming election. Atiku explain say by dat time e go dey close to 80 years, so di stakes high and e no sure say e go run again after dat.

todayApril 16, 2026 24

Lagos

Lagos Police Grab 3 Suspected Armed Robbers, Recover Pistol

Lagos Police command  don robo cup style arrest three suspected armed robbers wey dey  involve for robbery wey hapun for one estate for Sangotedo on April 11 and 13, 2026. Police Tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, put dis for statement on Wednesday night give tori pipo According to di statement, Dem arrest dem after distress call, and police recover local pistol wey get six rounds of 9mm bullet, face mask, hammer, rope, tape, jackets and plier. Say Area boys even […]

todayApril 16, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment Giv Obalende Park To Developer To Make Am Fine

Lagos State Gornment don officially hand over Obalende Park give redevelopers to build di place. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, after im run di mata on Wednesday  say di project dey very important for di state development. According to Wahab, dis kind move go help improve how Lagos look and how people go take use public spaces.

todayApril 16, 2026 15

obodo oyinbo

U.N Oga Guterres Beg US, Iran To Hold Serious Tuks

UN Secretary-General António Guterres like dis dey  call for serious tuk between United States and Iran, say make dem follow international law. E talk dis one to journalists for UN headquarters for New York on Tuesday. Guterres say humanitarian and legal responsibilities dey ignored for di Middle East mata and other places, and dis dey cause serious chaos, suffering and destruction.

todayApril 15, 2026 15 2

National

Akpabio Say Terror Attacks Na Plan To Shake Tinubu Government

Senate Presido Godswill Akpabio don finally tuk wetin do Naija, say all di recent terrorist attacks wey dey hapun for di obodo naija na plan by some people to distract President Tinubu. Im yarn dis one for Abuja during di opening of Naija Revenue Service headquarters. Akpabio even tuk say afta Tinubu win 2027 election, di bomb blasts go stop, say na pipo dey sponsor am.

todayApril 15, 2026 17

obodo oyinbo

Israeli Break Ceasefire Kpai 11 People For Gaza

Israeli military attack for Gaza Strip don kpai at least 11 Palestinians for different parts of di area. According to reports from medics and authorities on wednesady, among di dead na two children, one 3-year-old and one 14-year-old, wey come from di northern side of di conflict zone. For Gaza City, dem sti carry problem go strike police vehicle kpai about four pipo, including one police officer, and wunjure at least nine bystanders. According to Officials,  say all dis attacks […]

todayApril 15, 2026 12

National

Vice Presido Shettima Go Greet Governor Nasir Idris For Di Death Of Kebbi Speaker

Vice President Kashim Shettima, on behalf of President Bola Ahmed Tinubu, don go promise families of security officers wey dem kpai for Shanga area of Kebbi State say gornment go stand by dem. Im say di courage and sacrifice of di soldiers and police no go be in vain at all. For condolence visit wey he carry go meet Governor Nasir Idris for Birnin Kebbi, he sti mourn di death of Speaker Muhammad Usman Zuru wey die for Cairo.

todayApril 15, 2026 12

National

President Tinubu Launch New NRS Headquarters For Abuja

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu say, like dis NRS don enter new phase of beta money management, stronger institutions, and economic progress. Baba seyi dey yarn dis one as im go commission new Naija Revenue Service headquarters for Abuja. E say di reforms wey im gornment dey do, dey show beta workings, and dat di country dey move from uncertainty enter “better hope” gradually. Tinubu sti add say di new NRS building no be just structure, but symbol of […]

todayApril 15, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds