Blog masonry

Background

National

GenCos Beg NERC Make Dem Hike Light Tariff Afta Gas Price Rise

By: Esther Ayoola Electricity generation companies, Gencos like dis now don dey beg Nigerian Electricity Regulatory Commission, NERC, make dem quickly adjust electricity tariff afta Federal Gornment raise domestic gas price. CEO of Association of Power Generation Companies, Joy Ogaji, say delay in tariff review don dey worry dia body already and she yan dis one during interview on Monday. She explain say gas don cost, so any extra wey dem pay go reflect for consumers bill. Ogaji sti yan […]

todayApril 7, 2026 3

National

Resident Doctors Begin Nationwide Strike Today Over Allowance

By: Esther Ayoola Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don announce say dem go start strike from today, April 7, 2026, for federal and state hospitals all over Naija. Dem tuk say di strike happen based on gornment failure to pay di revised Professional Allowance and don reverse some health policies wey dem agree afta di 2025 strike. NARD say for dia National Executive Council meeting, dem decide say di only way na total and comprehensive strike to make […]

todayApril 7, 2026 3

National

Three Kpai As Gunmen Do Fresh Attack Jos Community

At least three pipo don kpai as gunmen try attack Hyeipang community for Jos, Plateau State on Sunday, but security men stop dem and gbab one suspect. Plateau State Police Commissioner, Bassey Ewah, naim dey brief journalists on Monday about di attack, say e hapun, even as di state dey recover from di Palm Sunday attack Ewah explain say police, with other security agencies, don put more men join, including Special Intervention Squad and Counter Terrorism Unit, to patrol di […]

todayApril 7, 2026 2

OBODO NAIJA

Bandits Kpai 6, Kidnap Many For Easter Church Attack For Kaduna

Say nor be small gbege for Kachia LGA of Kaduna State, dat Residents of Ariko community dey cry dat bandits attack dem early Sunday morning during Easter service, kill six worshippers and kidnap many others. Eyewitnesses talk say di gunmen come in large numbers, surround First ECWA Church and St. Augustine Catholic Church, then open fire on pipo wey dey worship. According to locals, di attackers carry out di operation to kidnap victims and collect money, as dem also steal […]

todayApril 7, 2026 2

OBODO NAIJA

Kemi Adeosun Expose How BVN Help Gorment Catch 45,000 Ghost Workers

Former Finance Minister Kemi Adeosun don expose mata tuk how Federal Gornment take use technology wipe out plenty fake names for gornment payroll. She say, when dem link salary system with BVN, dem discover about 45,000 ghost workers wey dey collect money for nothing. According to her, before dat time, gornment dey spend pass salaries wey dem suppose dem pay, say na so corruption full plenty gorment offices. She say instead of forcing new registration, dem just use BVN run […]

todayApril 7, 2026 5

OBODO NAIJA

BUA Chairmo Rabiu Hail Tinubu Reforms, Say Tough Step, but Na Correct Move

Chairmo of BUA Group, Abdulsamad Rabiu, like dis dey hail wi oga presido, Bola Tinubu economic, though say im reforms dey tough but na di right step forward for Nigeria. E talk dis one when e visit di president for Lagos for di easter break. After meeting na dis senior man con dey explain every, say, di gornment removal of fuel subsidy and devalue di naira, all dey correct, telling Nigerians to dey patient.

todayApril 7, 2026 4

obodo oyinbo

Presido Trump To Touch Light Iran Ceasefire Deal

White House officials, all di way from united state of America on Monday don konfamate say dem dey consider one 45-day ceasefire deal between U.S. and Iran for di Middle East war. Di senior men wey tuk with Agence France-Presse, say di only tin be say Donald Trump never sign di deal. Dem explain say na mediators bring di proposal as part of efforts to reduce di fighting, but Trump administration still insist to continue di military operation wey dem […]

todayApril 7, 2026 4

OBODO NAIJA

Naija Soldier Expose Full detail Of Army Monthly Salary

One dismissed Nigerian soldier Rotimi Olamilekan, don scatta table oh, wey people sabi as Soja Boi, explain how many army personnel dey suffer buy dia uniform and protective gear by demselves. E yarn dis one for one interview wey never drop, as e tuk say im last salary before dem sack am na around ₦109,000 to ₦111,000, after dem increase am from about ₦51,000. According to am, before di increment, even with allowance, di total money no pass ₦70,000, and […]

todayApril 7, 2026 2

Sports

Mbappe Set To Shine As Madrid Face Bayern For UCL Clash

Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday. For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team. Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella. Now wey e don recover, coach hint say Mbappe go likely play alongside Vinicius Junior for […]

todayApril 6, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app