Blog masonry

Background

National

TUC Beg FG Make Dem Use Crude Money Help Refineries

By: Esther Ayoola Trade Union Congress of Naija don tell Federal Gornment say make dem use excess crude oil money support local refineries, so dat dem go sell fuel cheap for Nigerians. TUC President, Festus Osifo, tuk dis one for Abuja, say like dis now say, petrol fit reach N2,000 per litre, if gornment no act fast. Festus sti press tuk on why wi federal gorment need act fast, saying dollar wahala, gbogboyegbogboye dey  make life harder for Nigerian workers.

todayApril 10, 2026 14

National

NDLEA CEO Marwa Clear Security Agencies To Join Hand Against Insecurity

By: Esther Ayoola Oga chairmo and CEO of NDLEA, Mohamed Buba Marwa sef don scata mouth say, all security agencies and civil society need joinbodi for dis fight against insecurity for obodo Naija. Im yarn dis one for Abuja during opening ceremony of Army War College seminar wey focus on how to close intelligence gap among agencies. According to am, if agencies dey share correct informate with each other, e go make dem work beta and protect di country wella.

todayApril 10, 2026 14

Uncategorized

IGP Disu Vow For Abuja To Tighten Police Accountability

By: Esther Ayoola Oga Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, on Thursday for Abuja don promise say him go strengthen accountability for Naija Police Force. Him yan dis one as him meet Civil Society Organizations for Force Headquarters. Di CSO group wey human rights lawyer Femi Falana lead, enter dis meeting just to push for police reforms and beta protection of citizens’ rights. Disu nor close mouth too, say di reforms go hapun through joinbodi  with civil society and respect […]

todayApril 10, 2026 13

National

President Tinubu Mourn Soldiers As Terrorists Attack Borno Camp

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don show deep sadness as soldiers from 29 Task Force Brigade under Operation HADIN KAI lose dia lives for terrorist attack wey hapun for Benisheikh, Borno State. Baba Seyi put dis one for im news tuk yesterday, sending condolences to di military pipo and families of di soldiers. U sabi say, Defence Headquarters konfam say dis attack hapun early Thursday morning and say some casualties dey. Dem tuk say di insurgents try […]

todayApril 10, 2026 17

National

Osun Assembly Call For Clean, Free Election For 2026

By: Esther Ayoola Osun House of Assembly don raise concern say make di governorship election wey go happen on August 15 dey free, fair and credible. Dem tuk dis one afta INEC move dia Resident Electoral Commissioner, Mutiu Agboke, go Ondo State. Speaker of di Assembly, Adewale Egbedun, say, whoever INEC go put for di state must follow Constitution and Electoral Act wella. E sti tuk say di sudden change dey raise suspicion, but e get confidence say Osun pipo […]

todayApril 10, 2026 9

Lagos

Ogun Bike Snatching Turn Deadly As Rider Lose Life

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don do Rambo doings arrest one 27-year-old man, Chidi Ebere, wey bin dey try snatch motorbike from rider and ending up kpaing di drive. According to di Police tuk, tuk, Babaseyi Oluseyi, statement, say di man first enter di bike like passenger for Igbesa area, before e attack di rider. During di struggle, di rider, Sunday Ogbu, try defend himself but di suspect stab am badly. Police Konfam say di rider Kpai from […]

todayApril 10, 2026 11

Lagos

Fulani/Arewa Leaders For Lagos Quash Suspension Rumor Of Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Arewa and Fulani leaders don gather stakeholders address dia leadership issues say dem nor suspend Alhji Sa’adu Yusuf Dandare-Gulma as chairmo. Fulani leader for Lagos, Alhaji Mohammad Abubakar, naim dey yan dis mata for dia stakeholders meeting wey dem run on Thursday, say, di suspension story na false and he officially cancel am, insist say Dandare-Gulma sti be chairmo. Other leaders like Mai Kano Lawal and Alhaji Ibraheem Haruna also tuk, say di allegation no get base […]

todayApril 10, 2026 9

Lagos

President Tinubu Commission Big Tolu Schools Complex For Ajegunle, Lagos

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don inaugurate di remodelled Tolu Schools Complex for Ajegunle, Lagos State. Say, di complex wey dey Ajegunle get 31 secondary schools, 5 primary schools, plus vocational centres, science labs, ICT and robotics hubs. Represented by Senate Presido Godswill Akpabio, oga presido tuk how dis school take be good achievement, say na one of di biggest school collection for Sub-Saharan Africa.

todayApril 10, 2026 12

Lagos

Governor Sanwo-olu Go Commission 36 Schools For Tolu Complex

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, go commission di Tolu Schools Complex for Ajegunle area of di state on Thursday. Di Tolu Schools Complex dey get 36 public schools, 31 secondary and 5 primary schools wey dey for Ajegunle inside Ajeromi-Ifelodun Local Government Area of Lagos State. Di Tolu Schools Complex get standard football pitch with race tracks, multipurpose sport court for outdoor games, fire service station, health centre, water harvester, biodigester, and solar panels for di school to make sure […]

todayApril 9, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds