Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

FG Draw Red Card For Corruption Wey Dey Nigerian Universities

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don declare war against corruption and impunity for Nigeria tertiary institutions, say any university lecturer wey dem catch go face di musik. Minister of Education, Dr Maruf Alausa, yarn dis one for Abuja during retreat for polytechnic and college heads, say govment no go tolerate money mismanagement, abuse of office and any unethical behaviour again. E say from now, transparency, accountability, timely audit and zero tolerance for corruption go be di rule to build public […]

todayJanuary 22, 2026 7

obodo oyinbo

President Trump Drop Plan To Take Over Greenland

By: Rilwan Agbomeji US Presido, Donald Trump don comot im threat to put tax for European countries wey no like im plan to take over Greenland. E tuk dis one yesterday for Davos wia im hold meeting with leaders for Europe, say e no go use force take di land again, and im dey try do deal wit NATO Secretary-General Mark Rutte. Trump talk say if dem fit agree, e sure say everywia go good for US and all NATO […]

todayJanuary 22, 2026 6

Sports

Maryam Usman Become Di First Nigerian Wey Enter Di Controversial Drug Enhanced Games

By: Rilwan Agbomeji Maryam Usman don become di first Nigerian wey dem don confirm say go compete for di new Enhanced Games wey allow athletes use performance-enhancing drugs. Di Games, wey Australian businessman Aron D’Souza start, go hold for May 24, 2026 for Resorts World, Las Vegas. Maryam na 35-year-old weightlifter wey don represent Nigeria for three Olympics and even win bronze medal for 2008 Olympics. She still get four African Championships, Commonwealth Games gold, and bronze for 2011 World […]

todayJanuary 22, 2026 9

Sports

Manchester United Eye Ndidi Move As Dem Chase Champions League

By: Esther Ayoola Unto football transfer updates, say Manchester United don revive interest for Super Eagles midfielder Wilfred Ndidi, wey now be captain for Besiktas for Turkey. According to transfer expert on Wednesday, di Red Devils dey find short-term midfielder to strengthen dia squad as dem chase Champions League qualification next season. Report tuk say United recruitment team don discuss possibility to bring Ndidi on loan.

todayJanuary 21, 2026 6

obodo oyinbo

Trump Hail US Economy for Davos, Throw Shade Give Europe

By: Esther Ayoola U.S Presido Donald Trump dis Wednesday afternoon,  don go whine world leaders wetin nor good for davos say  America “ na di economic engine of the world,”. Trump clear di world leaders  say America dey show workings yangayanga, whether na  inflation, dem dey top, investment nkor, say dem don reach trillions of dollars, say America don grow pass di prediction of internation monetary fund IMF. Oga dey whine di leaders like dis say , na to take […]

todayJanuary 21, 2026 5

National

Northern CAN Raise Security Concern Afta Kaduna Kidnap Denial

By: Esther Ayoola Oga  Chairmo of Christian Association of Nigeria (CAN),   northern branch, Joseph Hayab, don cut rope chain for security agencies for “denying”  jaguda boys kidnap pipo for Kaduna. Hayab yarn dis on Wednesday, hours afta Nigeria Police Force deny report say jaguda boys kidnap worshippers for Kurmin Wali community, Kajuru LGA, Kaduna. He tuk say how police and other security agencies just dey deny, dat all dis kin doings dey reduce trust Reports say over 100 people get […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Court Sack Abure, Order INEC To Recognize Nenadi Usman

By: Esther Ayoola Federal High Court don go settle labour party leadership wahala, for Abuja on Wednesday,  dem rule say, Julius Abure, no longer bi  di  national chairmo of Labour Party say im tenure don expire. Na Human rights lawyer, Inibehe Effiong, na im yarn di mata for X, say im dey court when di judgment come out and say di decision follow earlier Supreme Court ruling. According to report, Justice Lifu tuk say court don order di Independent National […]

todayJanuary 21, 2026 7

Lagos

Fashola Ginger Oga Presido To Update Naija New Ambassadors

By: Esther Ayoola Former Lagos State Govo, Babatunde Fashola, don wire wi oga presido Bola Tinubu message, say make im all new Nigerian ambassadors, especially non-career ones, sabi Nigeria policies, economic plans, and investment frameworks, Asap, before dem start work. Fashola yarn dis during him keynote speech for Nigeria Reputation Summit 2026 wey di Nigerian Institute of Public Relations hold for Abuja. E say di Senate don confirm 62 ambassadorial nominees last month, including ex-Minister Femi Fani-Kayode and former aide […]

todayJanuary 21, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Teach Civil Servants About Pension

By: Esther Ayoola Di Lagos State Head of Service, Bode Agoro, don ask public servants make dem start to learn about pension, say e dey improtakpa to avoid confusion later once dem retire. Agoro tuk dis tuk on Tuesday during Pension Awareness Programme wey Lagos State Pension Commission organize for Public Service Office, Alausa, Ikeja. E  say di programme na serious move to make sure workers  for di state wey don retire see di benefit of dia work.

todayJanuary 21, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app