Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Police Gbab One Man Wey Cut Small Pikin Head For Oyo

Oyo State Police Command don gbab one 23-year-old guy wey dem catch with pikin head for Ibadan. Police tuk tuk , Ayanlade Olayinka, yarn on Sunday say di matter happen on Saturday, April 11, for Adigun Village, Olorunda Ogunsola area inside Ona-Ara Local Government Area. According to am, police move sharp-sharp after dem receive informate say some pipo kpai one small girl con cut her head. Olayinka talk say dem […]

todayApril 12, 2026 5

obodo oyinbo

US Vice Presido Land Enter Pakistan For Iran Talks

US Vice Presido, JD Vance land for airbase near Islamabad on Saturday, ahead of negotiation with Iran to end Middle East war. Iran delegation wey pass 70 people, wey parliament speaker Mohammad Bagher Ghalibaf lead, reach Islamabad first under tight security. Di Vice presido yarn say US dey ready to open hand if Iran negotiate well, but if dem wan play game, US team no go soft. As for Iran […]

todayApril 11, 2026 11

Sports

Inter Miami Wan Carry Casemeiro

Manchester United Midfielder, Casemiro don get two-year offer to join Inter Miami. According to transfer expert Nicolo Schira, Inter Miami dey talk with di Brazil international for possible move dis summer. Di MLS side wan bring di 34-year-old go United States as free agent from July. Inter Miami don offer Casemiro contract wey go run till December 2028, but e never tuk anything.

todayApril 11, 2026 6

OBODO NAIJA

Federal Gornment Drop New Tariffs, Cut Import Duty For Rice, Motor, Drugs and Sugar

Federal Gornment don approve new 2026 Fiscal Policy Measures (FPM) wey go change import tariffs to help grow important sectors of di economy. Di approval dey inside document wey carry date April 1, 2026, wey Minister of Finance, Wale Edun sign and di new policy go replace di 2023 own. Gornment don review import duties for 127 items like rice, sugar, vehicles and industrial materials, say di reduction go help […]

todayApril 11, 2026 13

OBODO NAIJA

My Gornment Care For Every Bodi – Presido Tinubu

Wi oga Presido, Bola Tinubu don talk say im gornment still dey serious to tackle main problems like hard economy, light wahala and security issues for di obodo Naija Tinubu yarn dis one for Yenagoa, Bayelsa State, say im gornment still dey focus on policies wey go help poor people and those wey dey vulnerable pass. Oga Tinubu add say e no go stop to dey move forward, and e […]

todayApril 11, 2026 7

Sports

Nigeria Football Federation (NFF) don announce 36-player squad for Flamingos ahead of their second-round qualifier for FIFA U-17 Women’s World Cup for Morocco. New head coach Akeem Busari pick five goalkeepers, 10 defenders, 13 midfielders and eight forwards as dem begin preparation for important tie against either Niger Republic or Guinea. Di two countries go first meet for first round, and winner go come face Nigeria. Niger Republic go host […]

todayApril 11, 2026 5

Sports

Bassey Dey Ready For Liverpool Clash

Fulham don get better boost before dia Premier League trip go Liverpool, as dem don confirm say Calvin Bassey don recover and e fit play. Di Nigeria international bin dey doubtful after e comot from Super Eagles squad for March international friendlies because of back problem, wey make am miss matches against Iran and Jordan for Antalya. Im absence bin raise concern whether e go fit play Fulham important match […]

todayApril 11, 2026 4

obodo oyinbo

Artemis II Space Pipo Come Back To Planet Earth

Say like dis, NASA dey celebrate as dem successfully carry four astronauts go round Moon and bring dem back to Earth safely on Friday, and dis na di first lunar flyby wey happen for more than 50 years. NASA public affairs official, Rob Navias na im dey narrate their return for di agency live broadcast. Di spacecraft carry four astronauts, three Americans and one Canadian. As dem dey return to […]

todayApril 11, 2026 6

OBODO NAIJA

I Do Throat Surgery After Al Jazeera Interview – Daniel Bwala

Eight days after interview with Al Jazeera journalist, Mehdi Hasan, Special Adviser to Presido Bola Ahmed Tinubu, Daniel Bwala tuk say im go do surgery for im throat. Bwala yarn dis one during one TV siddon tuk wey show on Friday. For di TV siddon tuk, e respond to how pipo react to di first siddon tuk with Mehdi and how some online pipo bad mouth am. E sti yarn […]

todayApril 11, 2026 4

Lagos

Lagos Police Command Kramp 3 Suspected Robbers, Recover Bike, Phones and Weapons

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area. According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use […]

todayApril 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app