Blog no sidebar

Background

south west

Governor Makinde Beg Government As NLC, NUT, And NANS Protest Over Oyo School Kidnap

By: Esther Ayoola Oyo State govo, Seyi Makinde, don call on all levels of gornment make dem join hand together fight security wahala and rescue di students and teachers wey bad boys kidnap for Yawota and Ahoro Esinele communities inside Oriire Local Government. Governor Makinde tuk dis one on Tuesday when im receive leaders and members of NLC, NUT, and NANS wey do peaceful protest for di state  Secretariat. Di […]

todayJune 3, 2026 13

south west

Senate Cry Out Based On Bad Boys Doings For Oyo

By: Esther Ayoola Di Senate on Tuesday don condemn di way bad boys take pakalam (kidnap) school children and dem teachers for Oyo State. Di Senate President, Godswill Akpabio, tuk say dis bad tin wey hapun na national tragedy and na attack on top everybody humanity. Akpabio cry say as di country no fit protect children and teachers, dis insecurity tin fit spoil Naija future and di education system kpata-kpata.

todayJune 3, 2026 16 5

Lagos

Police Catch Accountant Wey Run Go Canada Afta Im Thief Theif ₦150m For Lagos

By: Esther Ayoola Zone 2 Police Command for Onikan, Lagos don gbab one accountant wey dem dey accusate, say im gada mehn go rob one house for Maryland, carry property of about ₦150 million loss. According to Oga Assistant Inspector-General of Police (AIG) for di zone, Olohundare Jimoh, say na since July 2025, dem don dey find dis person But dem trace am, con catch am for one corner as […]

todayJune 3, 2026 19

Lagos

Police Gbab Four Cult Boys Inside Ojo

Lagos State Police Command don catch four men loaded with guns and bullets inside one hotel for Ajanmgbadi, Ojo area. According statement wey Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, release, di suspects Emmanuel Nwokolo, Ayola Israel, Ebuka Nnamdi, and Chinedu Okafor, confess say dem belong to di Aiye  cult  gang and dem dey behind di killings and violent crimes inside di community. Police sti recover two local pistols, one revolver gun, […]

todayJune 2, 2026 31

Sport Yarns

Iran Football Team wan take Risk enter 2026 World Cup Base

By : Jolayemi Olajide After all di plenty yanga,  Iran football team  wan enter di 2026 world cup through  Spain dis weekend. Di  team dey face serious visa delay from both Mexico, where dem wan stay for di tournament, and di United States, wia dem suppose play all dia three group matches. According to di country football chief, Mehdi Taj, dem suppose  get the Mexico visa by Tuesday or Wednesday.

todayJune 2, 2026 58

obodo oyinbo

Canada Suspend Immigration Documents For 3 African Countries Over Ebola Outbreak

By : Jolayemi Olajide Canada gornment don announce 90-day suspension of immigration documents for residents of Democratic Republic of Congo, Uganda and South Sudan based on di Ebola  katakata. Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC)  naim dey konfamate dis mata  and dem put am for dia  social media on Tuesday for Canada. According to IRCC, dis move  na to guide Canada against  Ebola.

todayJune 2, 2026 21

OBODO NAIJA

INEC  Begin  touchlight  Voter Database  say Mata Leak

By : Jolayemi Olajide Di Independent National Electoral Commission (INEC) on Tuesday say e don start full blood check  into allega of some jaguda boys access dia  Continuous Voter Registration (CVR) database. Dis na after information about one candidate for a political party primary election in the Federal Capital Territory (FCT) leak enter public space. INEC National Commissioner and Chairmo of Information and Voter Education Committee, Mohammed Haruna, put for […]

todayJune 2, 2026 15

Lagos

Obasa Say State Police Na Di Way For Dis Kidnap Wahala

  By : Jolayemi Olajide Teachers for Lagos don hail Speaker Mudashiru Obasa as dem protest for Lagos Assembly over di kidnap of teachers and students for Oyo State. Obasa tuk say di Assembly still dey push for State Police, saying na one major way to fight insecurity and protect schools across Nigeria. NUT Chairmo, Hassan Akintoye beg government make dem rescue all kidnapped victims and make schools no turn […]

todayJune 2, 2026 30

OBODO NAIJA

Teachers For Lagos Storm Street, Demand Freedom For Kidnapped Teachers And Students

By : Jolayemi Olajide Teachers for Lagos State sef don join di nationwide protest, for dis Oyo school children kidnap. Dem carry di wahala  go Lagos State House of Assembly for Alausa, demanding, say gorment gat raise body for di mata, everyday kidnapping kidnapping say dem don tire. Di protesting teachers, under di Nigeria Union of Teachers, trek from Ikeja Under Bridge,  raise dia  voice  dey shout abeg oh rescue […]

todayJune 2, 2026 23

OBODO NAIJA

Oyo Parents Reject Gornment Rice And Cash Dey Cry For Dia Pikins

By : Jolayemi Olajide Meanwhile, Angry families of dipupils and teachers wey bandits kidnap for Orire local government area for Oyo State don reject rice and money wey oyo state gorment bin give dem to cool dia temper. Di Baale of Yawota, Emmanuel Alade, clear news tatafo on Monday, how dem feel, say di parents pursue baba govo, Seyi Makinde team comot because food no be dia problem now. Di […]

todayJune 2, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds