Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Federal Gorment Make Change For Nysc

Di Federal Executive Council don approve big changeĀ  for National Youth Service Corps (wey wi sabi as NYSC), na di first ogbonge change for since e start 53 years ago. FEC order di Attorney-General and Ministry of Youth make dem amend di NYSC Act so all di new changes fit start immediately. Wetin be di change, Under di new arrangement, civilian go lead NYSC operations while military go still dey […]

todayJune 30, 2026 13

OBODO NAIJA

Tinubu Commission Open New Road For Abuja

Wi oga Presido, Bola Tinubu, don rake full newspaper again say im gorment dey deliver beta development to Nigeria Im yarn dis one through im Vice, Kashim Shettima wey go represent am for di event, commison road project for Karu, wi decision headquarters. Tinubu rake oh, say im road project na blood tonic to Ā Ā local businesses and e dey Ā bring development.

todayJune 30, 2026 13

Lagos

Bus Conductor Allegedly Nack LASTMA Screwdriver

Nor be small tin oh, say One bus conductor don go allegedly nack LASTMA official screwdriver for im head, wunjor am yangayanga for gorun for Abule-Egba, along Lagos-Abeokuta Expressway. LASTMA tuk,tuk, Adebayo Taofiq, na him bin sorosoke dis mata inside statement wey dem wrap like akara on Monday. Im explain dat di LASTMA official just bin dey do im job, na dis conductor wey head shake enter argument am, an […]

todayJune 30, 2026 13

Lagos

Lagos Taskforce Begin Clear Alaba Rago, Clear Illegal Traders

Lagos State Taskforce don begin park pipo comot for Alaba Rago area along Mile 2 - Badagry Expressway after dia 72-hour notice wey dem give illegal traders and occupants expire on Monday. Dem dey remove street traders, funny shops and every structure wey block road, pedestrian walkway, road median and setback wey break Lagos environmental and town planning law. Chairmo of the Taskforce, CSP Adetayo Akerele, fry mouth, konfam say […]

todayJune 30, 2026 10

Sport Yarns

Tobi Amusan Carry Paris Diamond League Gold

By : Jolayemi Olajide Nigeria sprint queen Tobi Amusan don win di women 100m hurdles for Paris Diamond League on Sunday after she run 12.28 seconds, wey equal her season best. She beat Americans Grace Stark wey finish second with 12.38 seconds and Alaysha Johnson wey come third with 12.39 seconds. Amusan recover from behind after Nadine Visser take early lead before she sprint pass everybody to claim di victory. […]

todayJune 29, 2026 9

obodo oyinbo

Pakistan, Afghanistan Face-to-Face as Airstrike Kpai Dozens for Border

By : Jolayemi Olajide See gbege, Pakistan go launch airstrike and send ground troops enter Afghan province, kpaikpai pipo yangayanga on Sunday. Di Taliban gornment for AfghanistanĀ  say at least 36 civilians, including women and children, kpeme inside the attack and over 160 people sustain wound. But Pakistan Information Minister, Attaullah Tarar, change am, say 29 militants st caputĀ  inside di strikes wey target wia diĀ  bad boys dey hide. […]

todayJune 29, 2026 8

OBODO NAIJA

Dickson Beg Obi, Kwankwaso Make Dem No Dump NDC

By : Jolayemi Olajide Senior man leader of di Nigeria Democratic Congrees, Seneta Seriake Dickson don beg Peter Obi, Rabiu Kwankwaso and oda NDC candidates make dem no dump di party after Federal High Court judgment for Lokoja. U sabi Di court cancel im earlier order wey direct INEC to register NDC, say one Peace Movement Party dey claim di party logo. Dickson say make all aspirants remain calm as […]

todayJune 29, 2026 7

Lagos

FG ban Okada, Keke say Make dem avoid, Lagos-Calabar Highway Again

By : Jolayemi Olajide Federal Ministry of Works don ban commercial okada and keke from using Lagos-Calabar Coastal Highway, and the order go start dis week. Federal Controller of Works for Lagos State branch, Olufemi Dare,Ā  naim announce di decision for statement wey dem release on Sunday. According to am, di ban na to protect di lives, to avoid oka and keke drag road with big trailer. E add say […]

todayJune 29, 2026 14

Lagos

Two Trucks, One Car jam each odaĀ  for Gbagada Lagos State Traffic Management Authority

By : Jolayemi Olajide Nor drive wawa, wawa, pipo nor dey hear for di obodo lagos oh, like dis nowĀ  Lagos state Traffic pipo, don konfam one serious motor askident wey hapun for Monday morning insideĀ  Gbagada along di express. According to LASTMA, di askident involve two big trucks wey carry cargo and one private car, gbowayi, dem jam demselves. Di agency say emergency responders and tow truck don reach […]

todayJune 29, 2026 10

Sport Yarns

Lewandowski Put Ink For Paper Enter Chicago Fire for America

By : Jolayemi Olajide Poland veteran striker, Robert Lewandowski, don gree to join USA club, Chicago Fire, for dis summer transfer window. Dis move take shape after di 37-year-old striker comot from Barcelona afta di 2025/26 season to touchlight di frequency of di club two weeks ago for America to see how di level be. According to transfer oga, Fabrizio Romano, on Monday, di forward tuk say he dey ready […]

todayJune 29, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds