Blog no sidebar

Background

Sports

Late Goal Carry Canada Enter World Cup Round 16

Canada don qualify for World Cup last 16 for di first time after Stephen Eustaquio score late winner wey give dem 1-0 victory against South Africa on Sunday for di first knockout match. Di game bin dey wan enter extra time oh, before Eustaquio fire one fine shot from outside di box for stoppage time to break South Africa heart. Canada, wey dey co-host di tournament, go now face either […]

todayJune 29, 2026 8

obodo oyinbo

Plane Crash Kpai 11 Near France Airport

Eleven pipo naim don kpai after one civilian plane wey carry skydivers crash, play, play turn to hit an go, say di plane get askident near Tomblaine for eastern France on Sunday. According to local authorities, Di victims include five instructors, five students and di pilot, as di plane fall near Nancy-Essey airport close to residential area. Authorities say nobody wey dey ground die, while dem don open investigation to […]

todayJune 29, 2026 11

OBODO NAIJA

NARD Give FG Four Weeks, Threaten Nationwide Strike

Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD), dat di number one body mata pipo don declare say if wi Federal Gornment nor con follow dem discuss about dia  lazy salary in di next four-week, dem go shut down all hospital house for di Country. Dis according to a paper wey di association release on Sunday after dia special meeting wey hapun online on Saturday. NARD Presido, Dr. Mohammad Usman Suleiman, […]

todayJune 29, 2026 13

south west

Ogun Police Collect N1.1M Fraud Money From Seven Suspects,

Ogun State Police Command don catch seven guys wey dem dey suspect for different-different bad market like armed robbery, "one-chance," cultism, and travel scam. Di Police tuk tuk for di state, DSP Oluseyi Babaseyi, naim cleare dis mata on Sunday say dem catch di suspects during separate sharp-sharp operations based on intelligence. Among di tins wey di police recover from dia hand na stolen Toyota Venza, Toyota Camry wey "one-chance" […]

todayJune 29, 2026 10

Lagos

Demolition Loading As Lagos Gornment Vow To Clear Illegal Structures

Lagos State Gornment based on flooding don sama beta warning say dem go bring down any shop, or building wey dey block gutters flows for Ajiran, and Ikota areas sharp. Di Commissioner for Environment and Water Resources,  Tokunbo Wahab, tuk dis one after im go check di gutter systems for Lekki and those areas, say na dis blockade dey make flooding dey hapun for raining season. Wahab warn developers say, […]

todayJune 29, 2026 8

Sports

From Naija To NBA: Six Players With Nigerian Roots Make Draft

Six players wey get Nigerian roots don enter di 2026 NBA Draft, including Felix Okpara, Otega Oweh, Tobi Lawal and Ugonna Onyenso. Orlando Magic pick Okpara as number 46, while Houston Rockets choose Onyenso as number 53 for di draft. Onyenso start as football player for Nigeria before e switch go basketball after e move go America in 2018 and train for NBA Academy Africa for Senegal. Di Imo-born player […]

todayJune 26, 2026 20

Sports

Na Mbappe Vs Haaland As France Jam Norway

France and Norway go face each oda for crucial World Cup Group I match on Friday, as Kylian Mbappe and Erling Haaland prepare for big goal battle. Mbappe and Haaland don score four goals each for di tournament, just one goal behind Lionel Messi wey get five. Di match go happen for Foxborough near Boston, and di winner fit finish top of di group. France get small advantage because of […]

todayJune 26, 2026 10

obodo oyinbo

America Send Support To Venezuela To Rescue Earthquake Victims

America don send military and rescue support go Venezuela after two strong earthquakes of 7.2 and 7.5 magnitude kill at least 188 people. Di earthquakes destroy plenty buildings, damage di country main airport and leave many people trapped under rubble. US Southern Command talk say dem go help rescue teams find survivors, check di damage and deliver emergency help to victims. America also deploy USS Fort Lauderdale, USS Billings, C-17 […]

todayJune 26, 2026 12

OBODO NAIJA

Bayelsa Police Don Arrest One 23-year-old University Student Wey Spread Fake Social Media News Say Bandits Don Invade Some Parts Of Di State.

Bayelsa Police don arrest one 23-year-old university student wey spread fake social media news say bandits don invade some parts of di state. Commissioner of Police, Daniel Iyamah, tok dis one on friday for Yenagoa, say di fake report cause serious panic and disturb business and school activities. According to am, di false story claim say militants catch di bandits and dey demand N50 million ransom before dem go release […]

todayJune 26, 2026 21

OBODO NAIJA

Kwankwaso Jam Obasanjo For Kano aliagn politics

Senator Rabiu Musa Kwankwaso pay courtesy visit to former President Olusegun Obasanjo for Kano on Thursday night. Obasanjo, wey dey Kano for official assignment, receive Kwankwaso for im temporary residence. Statement wey Saifullahi Hassan release say Aminu Gwarzo join Kwankwaso for di visit. Di statement no talk wetin di two leaders discuss during di meeting.  

todayJune 26, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds