Blog sidebar

Background

Sports

Former Super Eagles Player No Gree Make I Enter Iheanacho Room – Osimhen

Galatasaray Striker, Victor Osimhen don yarn how one senior player for Nigeria national football team pursue am comot for room during im first call-up for 2017 under coach Gernot Rohr. Osimhen tok dis one during one livestream chat with Carter Efe on Saturday morning. According to am, di player bin dey share room with Kelechi Iheanacho. E remember say as e come Uyo, I meet Iheanacho tell am say I […]

todayMarch 21, 2026 10

Lagos

LASEMA Konfamate Say One Person Kpai For Tanker Askident

Lagos State Emergency Management Agency don konfamate say one person don die for gas tanker and tipper truck explosion wey happen for Lekki-Epe Expressway on Saturday. Dis update come after Margaret Adeseye wey be Controller General of Lagos State Fire and Rescue Service tok say property worth thousands of naira don spoil, while two people burn beyond recognition for di askident. For statement, Permanent Secretary of LASEMA, Olufemi Oke-Osanyintolu, say […]

todayMarch 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Delta Gorment Order Probe On Top Ozoro Festival Wahala

Delta State Government don condemn report wey talk say some women suffer harassment and sexual assault during Ozoro Festival, dem say di act na barbaric and no acceptable at all. Commissioner for Works (Rural Roads) and Public Information, Charles Aniagwu, don call on security agencies make dem quickly investigate di matter and arrest those wey dey involved. E still assure residents say government go continue to protect di rights and […]

todayMarch 21, 2026 17

obodo oyinbo

Spain Prime Minister Drop €5 Billion Plan To Cut Fuel Tax

Spain Prime Minister Pedro Sánchez don announce one big package wey worth about five billion euros to help battle di economic wahala from di Middle East war. After emergency meeting, di prime minister say di plan get about 80 measures to protect households and important sectors from high cost of living. E also promise serious reductionfor energy taxes, especially for gas and fuel, to make things easier for citizens.

todayMarch 21, 2026 15

Sports

Salah To Miss Brighton Match Sake Of Muscle Wunjury

Say Mohamed Salah no go play for Liverpool match wey dem get for Brighton on Saturday because im get muscle wahala. Di Egyptian forward comot pitch on Wednesday after im score for Liverpool 4-0 win against Galatasaray wey make dem reach Champions League quarter-final. Manager Arne Slot talk dis tuk for press briefing dat dem get international break, and Egypt nor go happy as im no fit join dem.  

todayMarch 21, 2026 12

Sports

Lionel Messi Hit 900 Career Goals, Join Cristiano Ronaldo For Football History

By: Esther Ayoola Lionel Messi don score him 900th career goal on Wednesday, join Cristiano Ronaldo as di only players wey reach dat level for top men football. Di 38-year-old Argentina World Cup winner score the goal with him left leg as Inter Miami play 1-1 draw with Nashville SC for CONCACAF Champions Cup. Dis 900th goal come 21 years afta Messi score him first senior goal for FC Barcelona […]

todayMarch 20, 2026 18

Sports

Guinea Tell CAF To Recheck 1976 AFCON Say Morocco Sef Do Walkout

By: Esther Ayoola Guinea Football Federation don ask CAF make dem check di 1976 AFCON wahala, because Morocco waka comot for pitch like Senegal do am for 2025. For dat 1976 match, Guinea bin dey win first, but Morocco  come  equalise last minute afta plenty gbagbos, making Moroco di Champions. Guinea say if dem fit cause say, Senegal do wahala, reverse 2025 result, make dem use same rule for di […]

todayMarch 20, 2026 14

obodo oyinbo

Netanyahu Say Israel & Trump Dey “Win” Di War For Iran

By: Esther Ayoola Prime Minister Benjamin Netanyahu say Israel and America dey “win” di war against Iran, and dat confusion gadima for Iran. Him yan dis one for news tuk say nobody send dem message oh, dat Israel act alone wen dem strike Iran big South Pars gas field, but US Presido, Donald Trump later ask tell dem to “hold off” for di next attacks. Netanyahu tuk say di war […]

todayMarch 20, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Plan To Drop Qatar Gas Export By 17%

By: Esther Ayoola Iran Foreign Minister Abbas Araghchi tuk on Thursday say na just small part of dia power ni dem don dey use attack regional energy facility . E tuk dis one for news tuk, say, if anybody touch Iran energy again, dem no go hold back. According to report dem dey plan attack Ras Laffan gas plant for Qatar, and dat e go cut Qatar LNG export by […]

todayMarch 20, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds