Blog sidebar

Background

Sports

PSG Coach Luis Enrique Worry Bodi For Team Struggle

By: Esther Ayoola Paris Saint-Germain manager, Luis Enrique, throw lamentation say im team PSG dey struggle wetin nor good dis season. Dem lose 3-1 for house against Monaco and Enrique say, dem too dey make plenty mistakes. E say dem need find confidence quick oh, before Champions League match wey dem get against Chelsea, make Chelsea nor go use dia eyes see shege.

todayMarch 9, 2026 18

Sports

How Young Nigerian Ugochukwu Win Im First FIA F3 Race For Melbourne

By: Esther Ayoola Nigerian-American driver Ugo Ugochukwu don win him first FIA Formula 3 race for Melbourne. E start well, but for first corner, e drop go third behind polesitter Théophile Nael and Britain driver Freddie Slater. But di 18-year-old no carry last, e start dey pass dem one by one. By second lap, e overtake Slater and Nael for Turn 9, take di lead win di race.

todayMarch 9, 2026 13

Sports

Rivers United Eye Second NPFL Title ,Package Bendel Insurance 3-1

By: Esther Ayoola Rivers United don continue dia moral fight to win dia second Naija Premier League title beating Bendel Insurance 3-1 for Adokiye Amiesimaka Stadium for Port Harcourt on Sunday. No goal for first half sha, but Chijioke na im head in a coner kick, putting  Rivers ahead  for 53rd minute. Douglas sti deliver assist for 81st minute, set up Wisdom Samuel making it two. Bendel Insurance score one […]

todayMarch 9, 2026 10

obodo oyinbo

Thousands Enter Street for Women Rights

By: Esther Say Thousands of pipo ni enter street for many city all over di world on Sunday to celebrate International Women’s Day. For Rio, France, Spain and oda European place, demonstrators demand for women rights. Infact For Paris, one rape victim, Gisele Pelicot tell reporters say di march na to shine light on rape survivors and fight women equality. People for Spain sef march say make war for Middle […]

todayMarch 9, 2026 14

obodo oyinbo

China Hold Economy Strong As Global Wahala Dey Increase

By: Esther Ayoola China foreign minister Wang Yi say China dey pin pillers to strengthen di kontri economy against global wahala. Wang, wey be member for Communist Party top council, drop dis one for journalists for Beijing on Sunday. Wang say, im don use im gbojero eye look di worldwide economy, say tins dey change like say tomorrow nor dey and ni make dem dey make plans for di future.

todayMarch 9, 2026 10

obodo oyinbo

Late Iran Supreme Leader Pikin Take Over Gorment

By: Esther Ayoola Son of late Supreme Leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, don become new Supreme Leader for Iran. Iran Assembly of Experts, 88 clerics wey dey choose Supreme Leader, ni pick am afta Ali Khamenei kpai for U.S.–Israeli strike. Mojtaba na hardline cleric wey get strong connection with Iran Revolutionary Guard Corps, and now, na aim go dey control of political matas, army, and strategic programs.

todayMarch 9, 2026 15

National

IGP Disu Appoint DCP Anthony Placid As New Police Tuk, Tuk Person

By: Esther Ayoola Di Naija Police Force don appoint DCP Anthony Okon Placid as new Force tuk, tuk person Say na di outgoing tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, ni use im own mouth tuk am, on Sunday to tori pipo. From report, Placid go replace Hundeyin wey don dey di job since 2015, Say dis one dey follow afta IGP Olatunji Rilwan Disu reshuffled police top officers. Placid, wey im mama […]

todayMarch 9, 2026 14

National

NiDCOM Oga Calls Out Mozambique Over 42 Nigerians Arrest

By: Esther Ayoola Chairmo and Chief Executive Officer of di Nigerians in Diaspora Commission, NiDCOM, Abike Dabiri-Erewa don drag Mozambique say, why dem go arrest 42 Nigerians for dia kontri Inside statement for Abuja on Sunday, she  say di mata nor make brain at all, and so make Mozambique gorment  release dem immediately or charge dem to court if dem do any crime. NiDCOM complain be say, why be say […]

todayMarch 9, 2026 12

National

Obi Official Say Im Nor Wan Shout, Say Na Nigerian Get 2027 Elections

By: Esther Ayoola Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, don decide say di 2027 general elections go be battle between Nigerians and bad leadership. Obi tuk dis one for Anambra State as he officially register as member of di African Democratic Congress (ADC) on Saturday. Di former Anambra govo, wey say im go challenge Presido, Bola Tinubu for 2027, also call on Nigerians make dem join di ongoing online […]

todayMarch 9, 2026 15

National

First Lady Oluremi Tinubu Put Call Say Make Mehn Dey Support Women

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, say make everybodi continue to support di rights, opportunities and empowerment of women and girls for di country. As Naija join di rest of di world celebrate International Women’s Day 2026, she tuk say di progress of women dey very importankpa for national development. She also praise di strength, courage and achievements of women, come remind Nigerians say everybody get responsibility […]

todayMarch 9, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds