Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Prime Minister Albanese Insist Say, Australia No Go Rescue ISIS Woman An Pikin From Syria

By: Esther Ayoola Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat  Australian  go send  woman an pikin wey get tie  with ISIS fighters. Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision. Albanese say any person wey use im […]

todayFebruary 17, 2026 5

National

Medipool And FG Join Body To Boost Local Medicine Production For Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don sign Memorandum of Understanding (MoU) with ogbonge Medipool to make local drug manufacturing for Naija grow. Oga coordinating minister of Health, Professor, Ali Pate don describe dis partnership correct access to ogbonge medicine, reducing importation of medicine. Pate say e go also support beta healthcare and boost production of important local drugs.

todayFebruary 17, 2026 6

National

WAEC Release Second CB Result

By: Esther Ayoola WAEC don release di 2025 Second Series CB-WASSCE results for private candidates, According to a statement by Acting Head of Public Affairs, Moyosola Adesina,  on Monday for Lagos, say  Candidates fit check dia results online for www.waecdirect.org before dem fit collect digital certificate for www.waec.org. To get hard copy certificate, candidates suppose apply online through WAEC e-Certman portal at https://certrequest.waec.ng/, as WAEC advise make dem act quick. […]

todayFebruary 17, 2026 11

National

Gbajabiamila Press Yans Dat Education Na Mission For Renewed Hope Agenda

By: Esther Ayoola Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, don repeat tuks, say education na key part of President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda. Im yarn dis one for Abuja during 2026 International Day for Education Conference wey Speaker Tajudeen Abbas organise. Gbajabiamila say if Naija wan compete well for global knowledge economy, e must invest serious for education and carry young people along.

todayFebruary 17, 2026 3

National

FG, APC Govos Dash Kano Fire Victims ₦8bn To Start Life Again

By: Esther Ayoola Federal Gornment don approve ₦5 billion to support pipo wey lose property for di Kano Singer Market fire disaster. Vice Presido, Kashim Shettima tuk am during him sympathy visit to di market. Shettima say di money sef eh,  go hellep victims rebuild dia businesses and bring back normal trading activities. Also marking present, Di All Progressives Governors Forum, led by Imo State Governor Hope Uzodimma, also add […]

todayFebruary 17, 2026 4

National

President Tinubu Express Shock As Governor Fintiri Show Workings For Adamawa

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu don enter area for Adamawa state cut cap for govo Ahmadu Fintiri  say na real “renewed hope” development  im dey do for di state. President Tinubu enter Yola for first state visit yesterday and say im eyes first blur as im see  di kind of big infrastructure and fine governor office. Baba Seyi use di opportunate take beg Nigerians oh, say as country […]

todayFebruary 17, 2026 4

Lagos

Lagos Truck Drivers Protest To Stop Tax Extortion

By: Esther Ayoola Say nor small go slow for Lagos, dat Truck drivers, members of di Nigerian Union of Haulage Truck and Trailer Drivers, on Monday protest say dem nor go gree, task collectors wan kpai dem with tax. Dem say Lagos State Taskforce, Vehicle Inspection Office, and LASTMA dey harass, beat, and extort dem under guise of enforcement. Dis protest sef sup afta one driver, Comrade Prince Ogunkanmi Adekunle, […]

todayFebruary 17, 2026 4

National

Police Arrest Suspect Afta Two Nollywood Actors Kpai For Set

By: Esther Ayoola World pipo say, problem nor dey finish, Dat like dis, police don arrest food delivery guy over di death of Two Nollywood crew members, Ekemini “GeeTee” Imeh and Ayodeji Walter Odediran. Say dem kpai for location wey dem bin dey shoot film for Lekki area Lagos. Lagos State Police tuk, tuk, CSP Abimbola Adebisi, ni dey konfamate dis report, say police don arrest di suspect. According to […]

todayFebruary 17, 2026 3

Lagos

Lagos Gorment Set To Release Flying Cameras To Boost Security

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say now, dem wan to dey use surveillance drones to boost security work across di state. Executive Secretary of Lagos State Security Trust Fund, Ayodele Ogunsan, ni dey tuk dis one during press conference to mark him first 100 days for office. According to am, dem dey plan sign agreement with Nigerian Air Force and Naija Police Airwing to support beta aerial monitoring and […]

todayFebruary 17, 2026 7

Lagos

Lagos Assembly Approve Deal For Ogbonge Waste Management

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don approve report wey four-man committee prepare on di deal to hellpe di state gorment proper waste management. Untop sitting on Monday for state house Alausa, di committee tuk say, gornment  go share 4,250 tonnes from di 13,000 tonnes waste wey di state dey generate every day, so other investors fit join di waste management mata. Committee wey Speaker Rt Hon Mudashiru […]

todayFebruary 17, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app