Blog sidebar

Background

Lagos

How Lagos State Police Go Gbag Fake Kidnap Victims

Lagos State Police Command don do small ji mike gbab 26 fine-boys and fine-girls from other countries including some camerounians wey con fake dia kidnap. According to di police, na one 22-year-old Cameroonian woman carry report go police station say dem kidnap am, afta she travel come Nigeria to see one 39-year-old Chadian man wey she dey date for internet. But as police start to dig di dig, ehn, dem […]

todayJune 19, 2026 21

Lagos

Lagos LG Chair Promise to Back Farmers

Alimosho Local Gornment Chairmo, Akinpelu Johnson, don spread joy wetin nor good, dat make farmers wey dey im council nor too worry body oh, say dem ma get support dem. Johnson yarn dis one on Friday for di council secretariat during meeting with All Farmers Association of Nigeria, AFAN, and other agriculture stakeholders for Alimosho, Lagos. According to di Alimosho council chair, farmers get beta role for economic growth, food […]

todayJune 19, 2026 12

Entertainment

Delta Gofnor aide flame Omoni Oboli hot over Alexx Ekubo movie!

By : Jolayemi Olajide Wahala don burst for Nollywood, Omo! One of Delta Governor’s aide, Ossai Ovie, naim carry just carry fire go meet Omoni Oboli. Di reason? Say, Di filmmaker drop her film, 'The First Lady', just few days after dem bury Alexx Ekubo. Even as Omoni talk say she go give all di profit to di family, Ossai no gree. E call the move "pure disrespect," saying she […]

todayJune 19, 2026 9

Sport Yarns

Pochettino tell Messi Sorry, for im papa wey dey hospital

By : Jolayemi Olajide USMNT head coach, Mauricio Pochettino, don message Lionel Messi and im family, after dem rush Messi papa go hospital. Pochettino fry mouth say normal, messi papa, Jorge, receiving treatment for hospital na distraction, but encourage di senior man to stay focus dat im papa go dey alryt. Di former PSG boss, wey sabi Messi well-well, send im full support and best wishes to the family as […]

todayJune 19, 2026 8

Sports

Canada Wipe Qatar 6-0

For World Cup yesterday, Canada show serious strength as dem hammer Qatar 6–0, completely dominate di match from start to finish. Still yesterday, Bosnia and Herzegovina try but Switzerland overrun dem 4–1, especially for second half . Canada victory na clean attacking performance with plenty goals and no reply from Qatar, while Bosnia struggle to contain Swiss pressure all through di game.

todayJune 19, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Leader Accept Peace Deal Wit US

Iran supreme leader, Ayatollah Mojtaba Khamenei, don finally konfamate  say im hand dey for peace deal wey US Presido Donald Trump sign to end Middle East war, even though say nor be every tin inside di deal dey give am joy. And dat joy is coming in di morning. Di agreement go also allow US lift blockade for Iran ports and open road for 60 days tuk, on matas like […]

todayJune 19, 2026 12

Uncategorized

NEC Approve ₦83bn To Fight Flood Wahala

National Economic Council (NEC) don press naij purse for neck, approve over ₦83 billion under Anticipatory Action Trust Fund, AATF, to tackle flood wahala. Di approval hapun for meeting wey Vice President Kashim Shettima chiar for State House, Abuja on Thursday. Governor Bassey Otu of Cross River naim con fry mouth afta di meeting explain say dem first propose over ₦166 billion, but NEC finally approve ₦83.2 billion. Dat dis […]

todayJune 19, 2026 7

OBODO NAIJA

President Tinubu drop Promise Say Beta Life

Wi oga Presido Bola Tinubu don drop bombshell say im nor promise Nigerians any miracle oh but beta gornment policies and development projects. Baba Seyi dey yarn dis on through Senate Presido Godswill Akpabio during di commissioning of one new access road and bridge for Abuja on Thursday. Im nor understand why pipo dey drag gorment and dat im administration  focus na to build ogbonge projects wey go improve di […]

todayJune 19, 2026 14

Lagos

How Sanwo-Olu buy more trucks

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don order immediate cleanup say dirty wan finish Lagos. Di senior man post dis one for facebook page, e nor go fit sit down an look dirty to con build office for di state, and say like dis, extra trucks and workers don already join LAWMA, LASEPA and Environment Ministry to clear dirty communities. According to am, Lagosian go soon dey see very clean Lagos […]

todayJune 19, 2026 8

Sport Yarns

World Cup Gbege, Police Gbab Ivorian Star Elye Wahi Over Betting Scandal

By : Jolayemi Olajide Nor be small gbege, Ivory Coast striker, Elye Wahi, don enter world cup hot soup. According to report, French police arrest am just two weeks before di  2026 World Cup over alleged spot-fixing. Omo, the gist be say the 23-year-old allegedly collect yellow card on purpose during one Ligue 1 match between Nice and Metz back in May, all just to settle one dirty betting arrangement. […]

todayJune 18, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds