Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Iran Tell Us: We Ready To Tuk, But No Go Accept Intimidation

By: Esther Ayoola Iran tuk say dem still dey communicate with America through Switzerland, even as protest and violence dey spread for di country. Iran foreign ministry tuk say dem ready for dialogue but no go accept any one-sided tuk or foreign interference. Untop yaning for us, President Trump confamate say, Iran call am to negotiate nuclear matter, while e still dey threaten strong action. Meanwhile, gornment don shut internet, […]

todayJanuary 12, 2026 5

Lagos

Chimamanda Lawyers Drag Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Solicitors wey dey represent Nigerian senior writer Chimamanda Adichie don write letter to Euracare Multi-Specialist Hospital, Lagos, over di death of her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, wey die on Wednesday, January 7, 2026. Di lawyers,  Prof Kemi Pinheiro (SAN), claim say di hospital, di anaesthesiologist, and attending medical staff breach di duty of care wey dem suppose give di pikin. Lagos State Gornment don confirmate say dem […]

todayJanuary 12, 2026 10 34

National

NARD Stop Strike Say Dem Dey Make Progress FG

By: Esther Ayoola Di National Association of Resident Doctors (NARD) don suspend dia planned nationwide strike say negotiation with Federal Government dey make progress. Di decision come during virtual Emergency National Executive Council (E-NEC) meeting wey dem hold on Sunday, to review status of dia demands and recent developments. NARD Secretary-General, Dr Shuaibu Ibrahim, tuk say di suspension dey strategic and conditional, and e allow NEC check tangible progress for […]

todayJanuary 12, 2026 3

National

Police Gbab 4 Jaguda Bandits, Nab 65 Stolen Cows for Kaduna

By: Esther Ayoola Police for Kaduna State don show beta workings arrest four Jaguda bandits for Kakura area, Chikun Local Government, on Monday, wey dey carry 65 stolen cows. Police tuk tuk, DSP Mansir Hassan, wey tuk to our correspondent, say anti-kidnapping operatives follow correct intelligence, say ni dem take track di suspects. According to Hassan, di arrested people na Ibrahim Shuaibu alias Magaji, Buhari Ibrahim, Musa Haruna, and Abdullahi […]

todayJanuary 12, 2026 7

Sports

Carrick Dey Lead Di Race To Take Over Man United As Caretaker Coach

By: Esther Ayoola Michael Carrick don turn favourite to take over as Manchester United caretaker coach, as people wey close to di club tuk am. According to transfer expert, United bosses wan choose person before players resume training on Wednesday, and discussion don reach final stages with Carrick. Di 44-year-old  don bin do di work  before back in 2021 after Ole Gunnar Solskjaer sack, and e win two matches draw […]

todayJanuary 12, 2026 6

National

EFCC Chairmo Olukoyede Explain How Im Take Escape Bribe

By: Esther Ayoola Oga Chairmo of Economic Finance Crime Commission, Ola Olukoyede,  don drop bumpshell say im na holy, holy, dey  challenge Nigerians dat,  anybody wey get evidence say im dey corrupt make im come forward. Olukoyede dey yarn dis one on Sunday for TV sit don tuk, as e clear marras wey dey fly, fly dat im do fraud. E tuk say from when e serve as Chief of […]

todayJanuary 12, 2026 4

National

Fubara Clear Supporters To Be Calming Down Following Impeachment Threat

By: Esther Ayoola Untop reactions, Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don clear im pipo say im ma nor dey worry bodi, dey tell dem not to panic even say political wahala carry beta trailer put for dia neck. Dis na di first time wey di govo dey appear publicly since lawmakers start di fresh impeachment plan. E yarn dis one on Sunday inside church service to mark 2026 Armed Forces […]

todayJanuary 12, 2026 3

National

FG, Governors Honour Soldiers As Nigeria Mark Armed Forces Remembrance Day

By: Esther Ayoola Nor be small choir doings for Abuja, As Nigeria mark 2026 Armed Forces Remembrance Day on Sunday, both federal and state gorments do beta collabo sing for soldiers wey dey serve, retired ones, and those wey don die for duty. Church services hold all over di country as leaders pay respect to di selfless sacrifices of di military for unity, peace, and protection of Nigeria. Minister of […]

todayJanuary 12, 2026 2

National

Pope Warn Say Surrogacy Na Wrong Way To Build Family

By: Esther Ayoola Pope Leo XIV don condemn surrogacy, say e dey make family mata comot from normal doings. Surrogacy na arrangement wey woman carry pikin for anoda woman  wey no fit get own. Oga pope tell diplomats say make church no support any practice wey dey exploit life or waka against how life suppose be. Di practice don dey more popular worldwide because infertility dey rise, IVF technology dey […]

todayJanuary 12, 2026 2

Lagos

Chimamanda Adichie Drag Lagos Hospital Over Pikin Death

By: Esther Ayoola Senior Nigerian writer, Chimamanda Adichie, don drag one private hospital for Lagos, Euracare, say make dem come answer for wetin happen afta her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, kpai for di hospital. Her Mata sef dey raise worries about di hospital as plenty, plenty pipo sef dey accuse di hospital of medical negligence and professional misconduct. Say, like dis, Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don also order investigation […]

todayJanuary 12, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app