Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Senator Oluremi Tinubu Launch Federal Government Industrialisation Programme for Kano

Senator Oluremi Tinubu don launch “Energise Commercialisation Now” programme, wey go help turn research ideas to real money and industry for Nigeria on Thursday for Kano State. Di initiative na Federal Government plan to push innovation, attract investors, and boost production for all six geo-political zones. Di event wey carry theme “From Innovation to Industry” dey try close gap between ideas for school and research centres and how dem go […]

todayApril 23, 2026 11

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Ask Senate Make Dem Approve Fresh $516.3m Loan

Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don ask Senate make dem approve fresh $516.3 million loan from Deutsche Bank to take finance one road project. Di request dey inside letter wey dem read during plenary on Thursday to Senate Presido, Godswill Akpabio. According to di letter, di loan go fund Sections 1, Phase 1a and 1b of Sokoto–Badagry Superhighway, one major road project of about 1,000km, with 120km for current […]

todayApril 23, 2026 9

Lagos

Skip Sanitation and Collect Punishment – Lagos Government Warn Residents

Lagos State Government don warn residents across di state make dem fully join di monthly environmental sanitation wey dem fix for Saturday, April 25, or dem go collect wotowoto. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, drop di warning for statement on Wednesday, say make residents for all five divisions of Lagos stay for house between 6:30am and 8:30am to clean dia surroundings. Im talk say residents suppose […]

todayApril 23, 2026 16

Lagos

Make Una Giv Independence To Revenue Agencies –  Sanwo Olu

Govo Babajide Sanwo-Olu don tell other state govos say make dem give State Internal Revenue Service chairmen free hand to work well, so dat revenue for state go increase for development across di obodo Naija. Im say if dem empower di revenue agencies, taxpayers go get more confidence and staff go fit do their work without wahala. Di govo talk dis one on Wednesday when Joint Revenue Board come pay […]

todayApril 23, 2026 13

Sports

Arsenal Fit Go Six Points Ahead of Mancity – Paul Merson

Former England midfielder, Paul Merson, don talk say Arsenal fit go six points clear of Manchester City for di Premier League title race. Like dis like dis, Man City dey top table after dem beat Burnley 1-0 on Wednesday night. Pep Guardiola side just dey ahead of Arsenal on goals scored, as both teams get same points and same goal difference. Merson talk say Arsenal fit collect back di top […]

todayApril 23, 2026 17

OBODO NAIJA

Soldiers Push Back Attack for Yobe, Kpai 24 Jaguda Boys

Operation Hadin Kai Troops don fire back as jaguda boys try attack dem for midnight for military base inside Kukareta, Yobe State, as dem kpai 24 of di jaguda boys. Di gbege start early Thursday and e last for about three hours before soldiers overpower di jaguda boys. Media Information Officer for Joint Task Force, North-East Operation Hadin Kai, Lt. Col. Sani Uba, na im confirm di matter say di […]

todayApril 23, 2026 10

Lagos

Yahoo Boy Collobi 42 Years for Jail on Top €80,000 Scam

Ikeja Special Offences Court on Wednesday don sentence one yahoo boy, Ndidi Joshua Bobby, giv am 42 years of jail time for yahoo yahoo wey involve fake identity and dey use lie lie to collect money. Justice Olubunmi Abike-Fadipe na im give di judgment after court find am guilty. Na EFCC Lagos Zonal Directorate 2, Okotie-Eboh, carry di matter go court, as dem talk say di case involve stealing and […]

todayApril 23, 2026 29

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Hold Talk on Beta National Mata With Senate Oga Dem

Presido Bola Tinubu on Wednesday meet Senate ogas for closed-door meeting inside Presidential Villa, Abuja. According to reports, dem take serious decisions on key national issues during di high-level meeting, as dem discuss urgent matters wey concern di country. Senate Presido Godswill Akpabio na im lead di Senate team wey include Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Senate Leader Opeyemi Bamidele, and Minority Leader Abba Moro.

todayApril 23, 2026 14

Lagos

Sanwo-Olu Beg Lawmakers Make Dem Back Am to Complete Lagos Project Dem

Govo Babajide Sanwo-Olu on Wednesday dey beg Lagos lawmakers say make dem continue to support am so dat e go finish all di projects and reforms wey dey ground before im tenure end. Im talk dis one for di 19th Executive–Legislative Parley wey hold for Eko Hotels and Suites, Lagos. Di govo emphasize say make executive and Lagos House of Assembly continue to work hand-in-hand so dem fit deliver on […]

todayApril 23, 2026 13

Sports

Haaland Early Goal Carry Man City Go Top of EPL Table

Erling Haaland score as Manchester City beat Burnley 1-0 for Turf Moor, take jump pass Arsenal for top of  Premier League table. Di win also confirm say Burnley don go back to Championship. Even though City try anoda 28 shots, dem no add another goal as Haaland and Cherki even hit post. Arsenal fit still return top if dem beat Newcastle, but for now na City dey lead di table.

todayApril 23, 2026 14 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds