Blog sidebar

Background

National

Senate Tell Military Ogas To Touch Light Military Base Attack For Borno

By: Esther Ayoola Senate don direct Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, and other service chiefs make dem carry out full operational and logistical audit afta Boko Haram attack military formations for Benisheikh and Monguno, Borno State. Borno North Senator, Tahir Monguno, joining force with orda lawmakers naim raise di motion for di senate on Wednesday, for Abuja. Di Lawmakers order say dem must review how di attack hapun, […]

todayApril 22, 2026 8

obodo oyinbo

Kyiv Jaguda Boy Shooting Bring Serious Argument For Ukraine

By: Esther Ayoola For Kyiv, Ukraine, gunman don go shoot and kpai seven pipo near supermarket, and di attack don spark serious debate about who suppose carry gun for di country. Authorities say di shooter, wey mama dem born for Moscow and later live for eastern Ukraine, use registered weapon do di attack but im motive sti no clear. Ukrainian lawmakers dey now argue say, pipo need more right to […]

todayApril 22, 2026 10

Lagos

Lagos Clarify Sanitation Rules, Warn Defaulters Before April 25 To Cleanup

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly environmental sanitation go start again on Saturday, April 25, 2026, with movement restriction for di state from 6:30am to 8:30am. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,naim put dis one for news statement. Say di exercise na to allow residents clean dia houses, environment and drainages wella. According to Wahab, enforcement teams from LASPARK, LAWMA, KAI and other agencies […]

todayApril 22, 2026 23

National

COVID-19: NCDC Say No Wide Spread For Cross River

By: Esther Ayoola NCDC don tuk say make pipo nor panic afta dem confirm new COVID-19 case for Cross River State, say no sign of widespread spread for now. According to NCDC DG, Dr Jide Idris, dem say all di persons wey come in contact with di patient dey under monitoring and dem dey track dem properly. Cross River State Health Commissioner, Dr Henry Ayuk, explain say di case na […]

todayApril 22, 2026 11

National

Tinubu Appoint New Ogas for NECO, NBTE to Make Education Stronger

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don approve new appointments for key education agencies. Dis na according to a statement by im media aid, Bayo Onanuga tuk on Wednesday for Abuja. According to am, dis move na to strengthen institutions under Federal Ministry of Education and improve how dem dey run. Tinubu appoint Prof. Modupe Adeola Adelabu as chairmo for National Examinations Council board, while Prof. Ibrahim Wushishi […]

todayApril 22, 2026 10

Sports

Adepoju Back Iheanacho Return To Super Eagles After Di Striker Show Fine Form For Celtic

By: Esther Ayoola Former Naija player Mutiu Adepoju don call for Kelechi Iheanacho return to Super Eagles, based on di striker fine form for Celtic. Iheanacho join di Scottish club last summer, but injury wahala like hamstring problem reduce im game time dis season. Even with all dat, di 29-year-old sti score 6 goals and give 1 assist for 18 matches wey im don play for di club.

todayApril 22, 2026 14

Sports

Chelsea Chop 3-0 For Brighton As Fans Turn Red Eye For Coach Rosenior

By: Esther Ayoola Say like dis Chelsea fans dey vex for dia manager Liam Rosenior afta dem chop anoda 3-0 beating from Brighton, spoiling  dia small Champions League hope. Brighton use goals from Ferdi Kadioglu, Jack Hinshelwood and Danny Welbeck take jump pass Chelsea to sixth position for table. Na so for di second half, travelling fans turn choir, begin shout bad chants for Rosenior as di team continue dia […]

todayApril 22, 2026 10

Sports

D’Tigress Face Tough Test for World Cup Group B, Ready to Fight Back

By: Esther Ayoola Naija D’Tigress don enter tough Group B for 2026 FIBA Women’s World Cup with France, South Korea and Hungary. Dem go meet France and South Korea again, teams wey beat dem earlier for qualifiers for Lyon, but di girls dey expected to ready demselves wella for di fight dis time around. Dis tournament go happen for Germany from September 4 to 13, with top teams from all […]

todayApril 22, 2026 16

obodo oyinbo

Japan Soften Arms Export Rules, Open Door For Weapon Selling Abroad

By: Esther Ayoola Japan don announce say dem go loosen dia long-time strict rules on export of weapons, including lethal defence equipment. Dis na according to statement gornment tuk, tuk, Minoru Kihara on Tuesday. Say dis new move go allow Japan sell finished military products to other countries. According to Prime Minister, Sanae Takaichi say di change important as e go hellep, strengthen national defence and also grow Japan local […]

todayApril 22, 2026 7

obodo oyinbo

US Presido, Trump Give Big Announcement Say Ceasefire With Iran Likely To Continue

By: Esther Ayoola U.S presido, Donald Trump don make public announcement, say di ceasefire wey dey between US and Iran go sti continue till two countries go complete dia peace tuks. Di senior man sti put for im Truth social say, di blockade wey dem put for Iran ports go sti dey, until Tehran bring one clear and united proposal. Say like dis, nobody too sure how di US-Iran tuks […]

todayApril 22, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds