Blog sidebar

Background

Entertainment

FIFA Pick Davido For World Cup 2026 Concert For LA

By : Jolayemi Olajide FIFA don announce say Nigerian music star Davido go perform for Los Angeles leg of the World Cup 2026 Countdown Concert wey go hold on Wednesday, June 10. Di event go also feature Diplo Major Lazer, with more artistes still expected to join the lineup. FIFA tuk say di concert na part of global music series wey go hapun for Canada, Mexico and United States as […]

todayJune 3, 2026 17

obodo oyinbo

US-Iran War Spread enter Gulf as Missile, Drone Attack Increase

By : Jolayemi Olajide As US and Israel war against Iran enter 96th day, fight don spread reach Gulf region as both sides dey report fresh military action. US military tok say dem carry out “self-defence” strike for Iran Qeshm Island on Wednesday, while Iranian media report say explosion shake di area. Kuwait say im air defence system stop some drones and missiles, while Bahrain activate warning sirens as tension […]

todayJune 3, 2026 8

obodo oyinbo

Wetin be dis?! Striking teachers pull down giant football statues for Mexico, threat to scatter World Cup!

By : Jolayemi Olajide   Dey say goat wey stubborn follow lion enter bush, na im body go tell am say forest no be play ground. na serious wahala wey dey brew for Mexico City. Teachers wey dey vex don use rope pull down three giant football player statues, tear jersey commot, even set am on fire. Dem dey para say gornment no answer dem for dia labour demands as […]

todayJune 3, 2026 9

Sports

Late Drama As Wales Hold Ghana 1-1

By: Esther Ayoola Lewis Koumas score late equaliser for added time as Wales draw 1-1 with Ghana for friendly match wey happen for dia home ground. Di result mean say Ghana never fit win any of dia last four matches, with three losses and one draw for dia recent games. Di Black Stars miss chance to start well under coach Carlos Queiroz as part of dia preparation for World Cup.

todayJune 3, 2026 8

obodo oyinbo

Benin New President Visit Niger As Both Countries Try Fix Dia Relationship

By: Esther Ayoola Benin new leader, Romuald Wadagni, don visit Niger on Tuesday, marking di first presidential visit since di 2023 coup wey happen for Niamey. Di visit show say tension between di two neighbours don reduce afta Niger military gornment close border with Benin. Niger junta leader, Abdourahamane Tiani, naim receive Wadagni as dem plan tuk on how to restore security cooperation between both countries.

todayJune 3, 2026 7

National

Court Luck 5 Police Officers For Prison For Di Ogidi Killing Inside Effuren

By: Esther Ayoola Delta State High Court for Asaba don order make dem lock di ASP Usman Nuhu, and im four gang member for Ogwashi-Uku Correctional Centre. Dis officers dey face case say dem do extrajudicial killing of 28-year-old Oghenemene Ogidi, wey people know as OG Millan, for Effurun, Delta State. Di incident happen on April 26, 2026, and e cause serious public outrage afta video of di shooting circulate […]

todayJune 3, 2026 11

National

How 13 Reps Members Switch Party For House As Dem Resume Work

By: Esther Ayoola As House of Representatives resume from four-week break on Tuesday, na 13 lawmakers announce say dem don change political parties. Speaker Abbas Tajudeen read di defection notices during plenary, with lawmakers from Nasarawa, Cross River, Edo, Katsina, Oyo, Delta and Bauchi states joining different parties. Most of di lawmakers wey defect say internal crisis, leadership quarrel and factional divisions for dia former parties naim be di reason […]

todayJune 3, 2026 13 2

National

CAN Tell Federal Gornment To Declare Security Emergency

By: Esther Ayoola Di Christian Association of Naija (CAN) don call on di Federal Gornment to declare state of emergency on security mata across obodo Naija, say kpaings, kidnappings, terrorist attacks don turn 2.0 CAN make di call on Tuesday for Abuja during di National Church Leaders’ meeting for di National Christian Centre. Na di oga presido of CAN Archbishop Daniel Okoh naim read di agreement note to tori pipo, […]

todayJune 3, 2026 13

National

Wike Calm Protesters, Say Gornment Go Release Oyo Victims

By: Esther Ayoola FCT Minister, Nyesom Wike, don assure protesting teachers and civil society groups for Abuja say gornment and security agencies dey work hard to rescue di Oyo victims. Wike tuk dis one when e address di protesters for FCTA Secretariat. E also warn make people no use di insecurity mata play politics, as e express confidence say security agencies go soon secure di release of di kidnapped persons.

todayJune 3, 2026 7 17

south west

Police Clear Air Say No Security Threat Or Panic For Ondo LGA

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don clear di air say no shake-up, security threat, or any bad tin inside Odigbo Local Government Area at all. Di command image-maker, DSP Abayomi Jimoh, yarn dis one inside statement on Tuesday say all di sharpman doings and security check wey dem do show say di area dey clear. Because of dis one, di Commissioner of Police for di state, Felix Ohagwu, […]

todayJune 3, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds