Blog sidebar

Background

National

JAMB Release 2026 Result for Dia Thursday April 16 Candidates

Joint Admissions and Matriculation Board don release result for candidates wey write 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination on Thursday, April 16, as 632,788 results don dey ready to check. For statement wey dem release Friday, spokesperson Fabian Benjamin tuk say make candidates send “UTMERESULT” go 55019 or 66019 with the same number wey dem use register take check their score. JAMB talk say for now, na only to view result […]

todayApril 18, 2026 25

Sports

Onyeka Carry Coventry Back To Premier League After 25 Years Wait

Super Eagles midfielder Frank Onyeka don helep Coventry City secure promotion enter Premier League, playing 1-1 draw with Blackburn Rovers. Say Coventry bin  just need one point for Ewood Park, and dem get am as Bobby Thomas score late equaliser for 84th minute to seal di return after 25 years. Onyeka play 62 minutes for the match, show solid performance for midfield before dem comot am put Victor Torp. The […]

todayApril 18, 2026 17

National

FCCPC Clear Air Say Airtime Borrowing Still Dey, No Ban At All

FCCPC don come out tuk on Friday for dia official X page say dem never ban airtime borrowing or data advance anywhere for Nigeria, as viral social media posts bin dey claim. Di Commission say those reports na false and misleading. Dem explain say people still fit use all telecom value-added services normal, and dat nothing don change.

todayApril 18, 2026 17

Uncategorized

Governor Sanwo-Olu Hail Ex-IGP Musiliu Smith As E Clock 80

Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu don wire ogonge  congratulation message to former Inspector-General of Police, Alhaji Musiliu Smith (rtd), as e celebrate im 80th birthday. For statement wey im Special Adviser on Media and Publicity,  Gboyega Akosile release, he hail Smith as person wey get selflessness and strong commitment to public service. Sanwo-Olu  say Smith na visionary and well-respected elder wey serve Nigeria with full dedication. E also praise […]

todayApril 18, 2026 16 1

Uncategorized

Why Lagos Court Frees Policemen Wey Kpai Innocent Traders Over Land Wahala

Say Lagos State Ministry of Justice don free di four policemen and one developer, Abiodun Ariori, wey dem accuse of kpaing  traders for Owode Onirin, Kosofe area.  Directorate of Public Prosecutions tuk say di policemen act on self-defence, and no strong evidence dey to charge dem for manslaughter. Di victims kpai after di policemen, Musa Bala, Ahmed Abass, Ibrahim Kasimu and Ibrahim Garba, open fire during di incident. Report show […]

todayApril 18, 2026 14

National

Police Arrest 7 Suspects for Benue Kidnap Case

Security operatives for Benue State don arrest seven suspects wey dem link to di kidnapping wey hapun for Otukpo Local Government Area. Police PRO, Udeme Edet, naim dey konfamate  di mata for statement wey dem release on Friday. Recall say, di attack hapun on Wednesday when gunmen stop one Benue Links bus, rob di passengers and carry some of dem enter bush. Police tuk say na 14 people dem kidnap, […]

todayApril 18, 2026 26

Lagos

First Lady Insist Say Na Unity, Love And Respect Go Push Nigeria Forward

First Lady, Oluremi Tinubu again don press tuk  say national development go only work, when citizens joinbodi share values like love, tolerance, peace, sacrifice, compassion and service to humanity. She yarn this one on Friday for wia  she go do inauguration of Odo-Noforija Ultra-Modern Central Mosque for Epe, Lagos State. She no dey there physically, she send message through her Senior Special Assistant on Public Affairs and Strategy, Wahab Alawiye-King […]

todayApril 18, 2026 44

Sports

Saudi Arabia Sack Coach Renard Weeks Before 2026 World Cup

French coach Herve Renard don lose im job as Saudi Arabia national team coach, just few weeks before 2026 World Cup go start. Di French man naim by imself dey konfamate dis development for interview on Friday. Renard, wey be 57 years old, come back to coach Saudi for second time for 2024, after  carry dem go last World Cup and even beat Argentina that time. Before dis Saudi waka, […]

todayApril 17, 2026 12

obodo oyinbo

Iran insist say Strait of Hormuz Go Remain Open till Ceasefire End

Iran don talk say Strait of Hormuz dey fully open for all commercial ships to pass as ceasefire dey between Israel and Lebanon. Abbas Araghchi yarn this one for X, say as dem agree ceasefire, ships fit move freely for the remaining time. Dem also talk say make vessels follow the normal coordinated route wey Ports and Maritime Organisation of Iran don already announce. Di so called  ceasefire wey dem […]

todayApril 17, 2026 19

OBODO NAIJA

Ondo Monarchs Beg Tinubu to Share Pipeline Surveillance Power for Ilaje 

Monarchs from Ilaje Local Government Area for Ondo State don wire  appeal  letter wi oga  Presido,  Bola Tinubu make dem dis pipeline surveillance work touch everywia. Di traditional rulers under Ilaje Council of Obas tuk dis one inside letter wey dem send to President and sign by Secretary, Oba Obafemi Ogbaro, after dem meet for Igbokoda headquarters on Friday. Dem explain say di current central system dey limit community involvement […]

todayApril 17, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds