Blog sidebar

Background

Politics

Oyo 2027, Makinde Set Mission To Choose Successor For 2027

Oyo State Governor Seyi Makinde on Sunday, for Ibadan, Oyo State say like dis now im don start process to choose who go succeed am for 2027 election. Di senior put for letter wey dem give tori pipo, say dem don involve credible people to make sure di transition smooth and fair, and im go make di announcement later. Makinde explain say, im don task im advisory council, led by […]

todayApril 6, 2026 16

Lagos

Fanti Carnival 2026 Begin With Colourful Brazilian Display

Say like dis di 2026 Lagos Fanti Carnival don start on Monday for Tafawa Balewa Square. According to news post on X wey show different pictures, say pipo, cultural groups, and tourists dey celebrate di carnival, for di arena. Di carnival, wey dey hold every Easter Monday, normally na to show di strong cultural connection between Nigeria and Brazil. According to di organisers, di event dey promote heritage and identity […]

todayApril 6, 2026 19

OBODO NAIJA

Kwankwaso Condole With Jega As Im Wife, Hadiza, Pass Away

Former Kano Govo, Rabiu Kwankwaso, don commot condolence give former INEC Chairman, Attahiru Jega, as im wife, Hadiza Jega, kpai on sunday. For im Facebook post on Monday, Kwankwaso say Hadiza na woman wey get virtue and dignity, wey life don touch plenty pipo. Im add say, her life na blessing not only to her family but to everybody wey she show kindness and strength. Kwankwaso pray make Jega and […]

todayApril 6, 2026 12

Sports

Inter Milan Extend Dia Lead For Seria A Beating Roma 5-2

Inter Milan  knack Roma 5-2 for Serie A inside San Siro on Sunday, to take dia lead to nine points ahead of AC Milan. Lautaro Martinez come back from injury, score two goals, while Marcus Thuram score im first goal since February. Hakan Calhanoglu score beta shot before half-time and Nicolo Barella add another one, making it a sure win.

todayApril 6, 2026 17

Sports

Chukwuma Beat Ofili, Win First Outdoor Doings For Louisiana

Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma don start her outdoor season with beta result, wining di Battle for Bayou matas wey hapun for Louisiana. She run 10.81 seconds (+3.1 m/s) to beat her training partner Favour Ofili and Canada’s Audrey Leduc, wey finish together for 10.93 seconds. Chukwuma pick race for di blocks, sharp-sharp and hold her lead till di finish, even as Ofili try rush at di end. Dis timing sef […]

todayApril 6, 2026 11

Sports

Remo Stars Nail 3SC, Kano Pillars Hammer Bendel Insurance 4-0

Interesting games na sup for di Nigeria Premier Football League, match day 33, say Remo Stars record 1-0 win over Shooting Stars for Ikenne on Sunday as Samuel Anakwe score di only goal after half-time. For other matches, Kano Pillars hammer Bendel Insurance 4-0, while Kwara United waka pass El-Kanemi Warriors 3-0. Rivers United lose 2-0 to Warri Wolves as Nasarawa United collect 0-1 lose to Kun Khalifat.

todayApril 6, 2026 16

obodo oyinbo

Trump Promise To Burn Iran Plant If Dem No Open Strait Of Hormuz

US Presido, Donald Trump,  like dis now dey threaten say e go fit destroy Iran power plants and bridge if dem no open Strait of Hormuz by Tuesday. Im tuk dis one for im truth socials, dat if Iran nor behave demselves e fit release "hell", but believe say deal fit hapun with Tehran. Iran on dia own part dey laugh Trump threat, dem call am "helpless, nervous and stupid." […]

todayApril 6, 2026 17

OBODO NAIJA

At Least 17 Kpai As Armed Men Attack Mbalom For Benue State For Easter

For Mbalom community for Gwer East, Benue State, say at least 17 pipo na im kpai after armed men attack on Sunday during Easter celebrations. Eyewitness tuk say dem fire gun wotowoto, burn houses, and force pipo run enter bush. Local resident wey nor wan give name tell newsmen say many pipo still dey miss from di race wey dem run and dat like dis dem sti dey find pipo […]

todayApril 6, 2026 18

OBODO NAIJA

ADC Clear Matas David Mark Remain Dia National Chairmo

Di African Democratic Congress (ADC) don clear mata say di tuk dat former Senate Presido, David Mark don resign as dia party Chairmo, na big lie. Di statement come after false tuk dey spread wetin nor good, say Mark don resign, wey di party call “insidious fabrication.” ADC say, dem still dey united, focused, and dey ready to give Nigerians credible leadership. Dem con sti press tuk say di fake […]

todayApril 6, 2026 13

OBODO NAIJA

Information Minister Ginger Traditional Rulers To Promote Peace  

Minister of Information, Mohammed Idris don go gather traditional rulers across obodo Naija, tell dem plenty tins, say make dem try to promote peace and unity. Im yarn dis one for Iwo, Osun state during di installation of senior special assistant to di president and media and special duties, Tunde Rahman, say di leaders gat use dia influence to settle disputes, bring pipo together. According to am, dis go hellep […]

todayApril 6, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds