Blog sidebar

Background

National

IGP Disu Honour 17 Fallen Officers For Yobe

By: Esther Ayoola Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, on Tuesday enter heavy rain  to honour di 17 police officers wey terrorists kpai for active service inside Yobe State. Di officers, wey be members of Police Mobile Force, kpai during terrorist attack for Nigerian Army Special Forces School for Buni Yadi, Gujba Local Government Area, on May 8, 2026. While addressing journalists during di ceremony, Disu drop micro soft word […]

todayMay 20, 2026 11

National

Wike Praise Speed Of Abuja Projects

By: Esther Ayoola FCT Minister, Nyesom Wike don loud matas say infrastructure projects for Abuja dey move fast and na with Ogbonge quality. Wike yarn dis on Tuesday during inspection of ongoing projects, saying di government of Bola Tinubu dey serious about opening satellite communities through massive road construction. Im also reveal say Body of Benchers annex building and several road projects don near completion and dat dem go commission […]

todayMay 20, 2026 15

National

Peter Obi Clear NDC Screening, Say Presidential Race Sti Open For Everybody

By: Esther Ayoola Di 2023 labour party presidential candidate Peter Obi don complete im screening as presidential aspirant under Naija Democratic Congress ahead of 2027 general elections. Afta di screening wey last more than two hours for Abuja, Di former Anambra governor salutate di party, say dem ma  sabi democracy. Na so tori pipo sti carry Goodluck Jonathan contesting mata   stone Obi, according to obi make Jonathan feel free to […]

todayMay 20, 2026 13

National

PDP Screen 12 Gov Aspirants, Clear Jonathan As Sole Presidential Pick

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Party, interim leadership under Tanimu Turaki don screen 12 governorship aspirants ahead of 2027 election, while dem give former Presido, Goodluck Jonathan automatic ticket to contest presidency. Former Vice President Namadi Sambo, through former Niger State Govo, Babangida Aliyu, naim announce di development afta dia screening exercise for Abuja on Tuesday. Meanwhile, Reacting to di move, African Democratic Congress tuk say Jonathan entering di contest […]

todayMay 20, 2026 10

Lagos

Lagos Man Chop 24 Months Jail For Cocaine And Igbo Selling

By: Esther Ayoola Oneman wey dem call Olalowo Olatunji, wey be 44 years old, don collect 24 months jail sentence for Federal High Court wey dey Lagos. Justice Ambrose Lewis-Allagoa give di judgement afta di man admit say im guilty for two-count charge wey NDLEA bring come court. NDLEA tuk say dem arrest am on March 8, 2026 for Victoria Island as e dey sell 89 grams of cocaine and […]

todayMay 20, 2026 15

Lagos

Lagos Gornment Ban Heavy Load For Danfo

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don announce ban on movement of goods and heavy luggage for danfo across di state. Na di Lagos Metropolitan Area Transport Authority dey tuk dis one for statement wey dia Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi, release on Tuesday. Dem say di enforcement go start from June 1, 2026, and e go affect buses wey dey carry passengers for public transport system. Dem explain […]

todayMay 20, 2026 14

Lagos

Sanwo-Olu Open Big Data Centre For Lekki, Call Lagos Di Headmaster City Of Tech

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don declare say Lagos na di number one Africa digital economy, dat investment for technology and infrastructure dey cry. E tuk dis one during di inauguration of Kasi Tec Data Centre Campus for Lekki on Tuesday. Di governor say di new facility go hellep boost Naija digital infrastructure and support economic growth. Sanwo Olu sti call on foreign investors make dem come […]

todayMay 20, 2026 13

Sport Yarns

Super Eagles To Jam Guinea-Bissau, Tanzania, Madagascar for AFCON 2027 Qualifiers

By : Jolayemi Olajide Nigeria don land for Group L as dem go face Guinea-Bissau, Tanzania and Madagascar for 2027 AFCON qualifiers. Di draw happen for Cairo, Egypt on Tuesday, and Super Eagles fans don begin expect tough matches. Nigeria don meet Guinea-Bissau plenty times before, including 2021 and 2023 AFCON competitions, while dem beat Tanzania 2-1 for 2025 AFCON. Super Eagles now go battle to secure one of the […]

todayMay 19, 2026 20

obodo oyinbo

By : Jolayemi Olajide World Health Organization officials on Tuesday don warn say Ebola outbreak for north-eastern DR Congo dey spread faster than dem first think. Dr Anne Ancia of WHO tell newsmen say as dem dey investigate more, dem dey discover fresh cases for different areas around Ituri province, wey be di centre of di outbreak. Residents for di area talk say na so pipo dey die, die anyhow, […]

todayMay 19, 2026 11

OBODO NAIJA

Jonathan Hail Gowon, Say Him Policies Still Dey Help Nigeria

By : Jolayemi Olajide Former Presido, Goodluck Jonathan don praise former Head of State Yakubu Gowon, say many policies wey im bring during him time still dey help Nigeria till today. Jonathan talk dis one for Abuja during the launch of Gowon autobiography titled “My Life of Duty and Allegiance.” Im say Gowon show strong leadership as young leader during Nigeria civil war and still stand for unity with him […]

todayMay 19, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds