Lagos

1138 Results / Page 34 of 127

Background

Lagos

Lagos Gornment Find Dangerous Chemicals For Waste Water Inside Ikeja

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don raise alarm, say dem discover dangerous level of toxic chemicals for dustbin wey for Ikeja. According to aproko pipo, say geochemical touch lighting show nitrate, ammonium, copper and zinc and dat e pass World Health Organisation safety limit. Dem also add say di data wey dem gather go hellep dem map contamination hotspots and sanction factories wey dey spoil di Lagos environment.

todayMay 19, 2026 25

Lagos

FG Promise To Upgrade Makoko, Gishiri, Other Ghetto Areas To Big Communities

By: Esther Ayoola Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don drop update say federal gornment  dey plan to turn informal settlements like Makoko for Lagos and Gishiri for Abuja into beta places to live. E tuk dis one when Naija Institute of Town Planners visit am for Abuja. Darma mention say areas for Kano and Port Harcourt sti dey among places wey need upgrade from ghetto condition. E […]

todayMay 19, 2026 28

Lagos

Lagos Gornment To End Electricity Band System, Promise Ogbonge Light Supply

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don tuk say dem dey plan to remove di electricity customer band system wey NERC introduce for 2024. Di system wey get Band A to E dey separate customers based on di electricity dem dey receive and how much dem dey pay. Commissioner for Energy, Biodun Ogunleye, tuk dis one for ministerial briefing for Alausa, say di goal na stable light for everybody without […]

todayMay 19, 2026 13

Lagos

Lagos APC Konfam Senators Across Dia Three Senatorial Districts

By: Esther Ayoola Di Lagos State branch of di All Progressives Congress, don konfam say na dia current senators go sti run di package as senators across di three senatorial districts for 2027. In fact, Senator Idiat Adebule naim emerge as di APC candidate for Lagos West senatorial district ahead of 2027 general election. Di primary wey hapun for Agege Stadium show say she win as di only aspirant for […]

todayMay 19, 2026 24

Lagos

APM Governorship Candidate Laja Adeoye Promise 4th Mainland Bridge

By: Esther Ayoola One Lagos governorship candidate, under di canopy of Allied Pipos Movement, Prince Laja Adeoye,  don promise say im go build 4th Mainland Bridge and create Amotekun Corps if im win 2027 election. Adeoye yarn dis on Sunday as im bin dey tell im pipo about im “RESET LAGOS Agenda 2027” wey dem tag “Àtunto Èkó 1.0, Re-Engineering Lagos for Inclusive Prosperity.” According to am, di plan, na […]

todayMay 18, 2026 22

Lagos

Police Gbab Six “One Chance” Suspects For Okota Lagos

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police Command don arrest six suspected members of “one chance” robbery gang, wey bin dey operate around Ago Palace Way for Okota, Lagos State. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, naim convasate dis mata for statement wey she post for X on Sunday. According to di police, di suspects bin dey inside one keke (korope), when officers stop and search dem during patrol operation. […]

todayMay 18, 2026 12

Lagos

Desmond Elliott Cry Out Say Mehn Dey Intimidate Am For Surulere APC Primary

By: Esther Ayoola Fire dey for mountain, or Surulere rather, say like dis Lagos lawmaker, Desmond Elliott, don accuse some All Progressives Congress, APC, leaders and local gornment, say dem dey intimidate im supporters. Im yarn dis one for one viral video wey circulate on Sunday, Elliott cast some party leaders. Di Surulere Constituency I representative also allege say dem remove some local gornment officials from office sake of say […]

todayMay 18, 2026 26

Lagos

Sanwo-Olu Hail Olanrewaju for Betterment for  Banking Leadership

By : Jolayemi Olajide Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu don (don pelle beta salutate give ) Prof. Pius Olanrewaju, say dis particular senior man try for Naija Chartered Institute Bankers. Di governor, through Lagos Commissioner for Finance, Abayomi Oluyomi, tuk dis one on Thursday, during Olanrewaju sent fort party for Bankers House, Victoria Island, Lagos. According Baba Sanwo Olu, Olanrenwaju suppose enter  di AMA, make Igwe give am award, say […]

todayMay 15, 2026 16

Lagos

NIWA Tighten Safety Campaign for Lagos Waterways to Stop Boat Askident 

By : Jolayemi Olajide National Inland Waterways Authority don intensify dia safety awareness campaign for Lagos waterways to reduce boat accidents and make sure say zero askident  hapun for river. Lagos Area Manager, Sarat Braimah, talk dis one when she receive members of Shipping Correspondents Association of Nigeria 2026 Dockworkers’ Day Committee for her office. She explain say di campaign dey follow order from acting NIWA MD, Yusuf Girei, wey […]

todayMay 14, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds