Lagos

541 Results / Page 4 of 61

Background

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According […]

todayJanuary 13, 2026 4

Lagos

Lagos Court Kramp Man For Yahooing N60m Naira

By: Esther Ayoola Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do. Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing. Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel. […]

todayJanuary 13, 2026 5 4

Lagos

Akran Of Badagry, Oba De Wheno Menu-Toyi, Die For Age 89

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday. Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs. Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry […]

todayJanuary 12, 2026 9 1029

Lagos

Lagos Gorment Meet Doctors To End Strike

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment say dem ma dey do everytin within dia power to resolve issues wey dey behind di ongoing strike by di Joint Health Sector Unions (JOHESU) in di state. Di Permanent Secretary, Lagos State Primary Healthcare Board, Ibrahim Mustafa, yarn dis one for interview on Sunday. Mustafa say, gornment sabi say problem dey for di health sector and dat, dem ma dey dialogue to […]

todayJanuary 12, 2026 4

Lagos

Chimamanda Lawyers Drag Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Solicitors wey dey represent Nigerian senior writer Chimamanda Adichie don write letter to Euracare Multi-Specialist Hospital, Lagos, over di death of her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, wey die on Wednesday, January 7, 2026. Di lawyers,  Prof Kemi Pinheiro (SAN), claim say di hospital, di anaesthesiologist, and attending medical staff breach di duty of care wey dem suppose give di pikin. Lagos State Gornment don confirmate say dem […]

todayJanuary 12, 2026 11 34

Lagos

Chimamanda Adichie Drag Lagos Hospital Over Pikin Death

By: Esther Ayoola Senior Nigerian writer, Chimamanda Adichie, don drag one private hospital for Lagos, Euracare, say make dem come answer for wetin happen afta her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, kpai for di hospital. Her Mata sef dey raise worries about di hospital as plenty, plenty pipo sef dey accuse di hospital of medical negligence and professional misconduct. Say, like dis, Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don also order investigation […]

todayJanuary 12, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Release Plan For Waterside Business

By Ebi Oboko Lagos State  gorment don release new plan say, dem wan turn all   watersides for  di state to beta business wey go bring state  money. Based on yanings with tori pipo,  Di  Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tuk say, dis new policy go hapun dis  2026 and say, e show beta workings for  2025. Before now, say  people dey buy land dem for di waterside, dem […]

todayJanuary 12, 2026 9 4

Lagos

INEC Chair Swear Say E No Go Be Magomago, Tech Go Run Am

By: Esther Ayoola Prof. Joash Amupitan (SAN), Chairman of INEC, yarn on Friday for Lagos during di 2026 Induction and Strategic Retreat say 2027 General Election go free, fair, transparent and dey run with technology. Im tuk say commission no go tolerate any misconduct to make sure election clean. Amupitan explain say INEC dey prepare for how election dey change fast and wan meet expectations of Nigerians. Di retreat wey […]

todayJanuary 9, 2026 11

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app