OBODO NAIJA

770 Results / Page 2 of 86

Background

OBODO NAIJA

INEC Bring QR Code Make Lagos Voters Check Dia Names

By: Jolayemi Olajide INEC don bring QR code wey Lagos voters fit use find where dem go check dia names for voter register. INEC Resident Electoral Commissioner for Lagos, Prof. Ayobami Salami, announce dis one on Tuesday, as e say dem don start to display voter register since October 9 for all 245 wards across di state. Di exercise go end October 15, and e go help voters check dia […]

todayOctober 13, 2026 9

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Na Hin Chase Lawal Comot From PDP

By: Jolayemi Olajide FCT Minister, Nyesom Wike, don fire back at Zamfara Governor, Dauda Lawal, after e call am dat guy. Wike tok dis one on Tuesday during media parley, as e claim say na im make Lawal comot from Peoples Democratic Party, PDP. E talk say even though Lawal get money, im and im people no fit stand against am when dem still dey inside PDP.

todayOctober 13, 2026 4

OBODO NAIJA

How Women Leaders Raise Hand Support Tinubu/Shettima Ticket

Di election breeze take dey blow nor be small, group just dey do alignment support group up and down, na so yesterday one women political group wey call demselves Nigerian Women for Tinubu/Shettima 2027 (NWFTAS 2027), go promise re-election for Tinubu/Shettima ticket inside Aso rock. For una wey never get voter card, oyo na your case oh, women dey play front for Abuja like dis like dis. Senior man vice […]

todayOctober 13, 2026 8

OBODO NAIJA

Minister Umahi Fry Mouth As Plans Dey Go For Lagos Calabar Coastal Highway

You sabi dat report wey bin fly up and down yesterday say di federal gorment wan change plans for di Lagos Calabar costal highway, story don change oh, in fact wi Minister of Works, David Umahi, say make Nigerians nor mind bad belle pipu wey dey spread fake news. Say di plans for di 750-kilometre Lagos-Calabar Coastal Highway project sti dey intact. Oga Umahi clear di air give Baba Seyi […]

todayOctober 13, 2026 8

OBODO NAIJA

LCCI Beg Gornment Make Petrol Price Drop by 15 to 20 Per Cent

Lagos Chamber of Commerce and Industry, LCCI, don ask federal gornment make dem reduce petrol price by 15 to 20 per cent within six months, so e go reduce di heavy cost of fuel and transport wey dey affect businesses and ordinary Nigerians. LCCI Director-General, Dr Chinyere Almona, welcome gornment plan to control petrol price, including di proposed ₦1,350 per litre limit for petrol cost before e reach filling stations, […]

todayOctober 12, 2026 12

OBODO NAIJA

Chief of Staff, Segun Ogunwuyi, Resign From Hin Job 

Segun Ogunwuyi, wey be Chief of Staff to Oyo State Govo, Seyi Makinde, don resign from di gornment on Monday, October 12, 2026. For im resignation letter, Ogunwuyi say im resignation start to dey effective from di same day wey im write di letter. Ogunwuyi, wey don serve before as member of Oyo State House of Assembly and House of Representatives, na one of several aides wey don resign from […]

todayOctober 12, 2026 9

OBODO NAIJA

INEC Talk Say Governorship List For Six States Na Fake

By: Mariam Ajayi INEC don tok say one announcement wey dey waka online about governorship candidates for six states na fake. Di commission tok am on Monday for dia social media, say dem no release any list for Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano states. INEC tell Nigerians make dem no mind di announcement because na fake news, e no come from dem. Dem beg Nigerians make dem no […]

todayOctober 12, 2026 9

OBODO NAIJA

Bayelsa Gofnor Order Free Medical Check Up Every Three Months

By: Mariam Ajayi Bayelsa Goment don order free medical checks for residents across all eight Local Gorment Areas Governor Douye Diri give di order on Sunday for St John’s Anglican Church, Olobiri, Kaiama, to help people wey no fit afford medical tests. Di checks go cover high blood pressure, high blood sugar and cancer for government secondary hospitals, while di Health Commissioner go announce when di programme go start. Diri […]

todayOctober 12, 2026 7

OBODO NAIJA

FRSC Mourn Former Corps Marshal Dauda Biu

By: Mariam Ajayi Di Federal Road Safety Corps don mourn former Corps Marshal, Dauda Ali Biu, wey don die. Di current Corps Marshal, Shehu Mohammed, say Biu death na painful loss to im family, FRSC and Naija. Mohammed describe am as dedicated officer wey serve with discipline and commitment to public service. Biu join FRSC during di early years and later become di seventh substantive Corps Marshal, serving from July […]

todayOctober 12, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds