OBODO NAIJA

770 Results / Page 40 of 86

Background

OBODO NAIJA

Army Burst Gun Runners, Seize Seven Guns for Kaduna

Edited by: Esther Troops of Sector 7, Operation ENDURING PEACE, don intercept one suspected arms trafficking gang for Kaduna State and recover three locally made AK-47 rifles plus four submachine guns wey dem hide inside one vehicle, according to Nigerian Army. Army make dis known for statement wey dem post for dia official social media pages on Tuesday. Dem say di intelligence-led operation happen early Monday morning for Samaru Checkpoint, […]

todayJuly 13, 2026 23

OBODO NAIJA

NUT Cry Out, Say Make Dem Rescue Oyo Headmaster Sharp Sharp

Nigeria Union of Teachers (NUT), Oyo State chapter, don raise alarm over di kidnap of one primary school headmaster for Itesiwaju Local Government Area, as di union dey call for im quick rescue. Di union drop dis one for statement wey State Chairman, Hassan Fatai, and State Secretary, Salami Olukayode, sign and give tori pipo for Ibadan. According to di statement, gunmen kidnap M.K. Owoade, wey be headmaster of Nomadic […]

todayJuly 13, 2026 21

OBODO NAIJA

Soludo Wife Yarn Nigerians To Always Choose Healthy Food

Anambra First Lady, Dr Nonye Soludo, don tell Nigerians make dem dey choose healthy food by eating more local fruits, vegetables, beans, grains and tubers wey get plenty nutrients wey body need, she talk say natural food na one of di biggest gifts God give human beings. Soludo, wey also found di NGO Healthy Living with Nonye Soludo, say when people choose natural food instead of plenty processed food, e […]

todayJuly 13, 2026 18

OBODO NAIJA

Aisha Buhari Show for Late Husband One-Year Remembrance

Former First Lady Aisha Buhari don attend di one-year remembrance of her husband, former President Muhammadu Buhari, wey hold for Abuja on Monday. Muhammadu Buhari, wey rule Nigeria as President from 2015 reach 2023, die on July 13, 2025, for London at di age of 82 after long illness. Dem later bury am for im hometown, Daura, Katsina State, according to Islamic rites.

todayJuly 13, 2026 25

OBODO NAIJA

INEC Open Online Portal For 2026 Voters Card Registration!

By: Jolayemi Olajide The Independent National Electoral Commission, INEC, don reopen open online portal for Abuja make all Naija pipo fit register for their 2026 voter's card from anywhere. Di process na, na for Pipo go just log enter di internet portal fill dia correct details, and di address wey dem put for there na im dem go use deliver the Permanent Voter's Card, PVC, straight to their door. INEC […]

todayJuly 13, 2026 29 4

OBODO NAIJA

Soldiers Scata ISWAP Attack, Kpai Cameraman

By: Yusuf Abuh Troops of Operation Hadin Kai don go kpai plenty ISWAP terrorists after dem stop one attack for Cross Kauwa, Kukawa Local Government Area of Borno State. Military tuk say among di pipo wey die na one ISWAP cameraman, and diam idea tools. According to Acting Military Information Officer, Mohammed Goni, di terrorists try attack di troops position around 10:20 p.m. on July 11, but soldiers resist dem […]

todayJuly 13, 2026 19

OBODO NAIJA

FG Push NIMC To Register Every Nigerian For National Identity

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don direct National Identity Management Commission (NIMC) make dem register every Nigerian for national identity database before di end of 2026. NIMC Director-General, Abisoye Coker-Odusote, talk dis one during interview for TV sit down tuk on Sunday. She say di plan na to help gornment get beta national identity system wey go improve planning, governance and service delivery. Coker-Odusote add say NIMC […]

todayJuly 13, 2026 17

OBODO NAIJA

Oluremi Tinubu Lunch Food Bank

By: Yusuf Abuh Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, A.k.a Iya kuli kuli, A.k.a Iya Alakara, A.k.a nawa mama be dis don go throw beta salutate give Kogi State Govo, Ahmed Usman Ododo for di beta National Community Food Bank wey im build for Lokoja, to stop kpaturekor doings. Di senior woman first lady, porporly dis mata during, on ogbonge visit to inspect di  project. She talk say di modern […]

todayJuly 13, 2026 20

National

INEC Shift Deadline for Presidential, NASS Candidate List

By Ebi Oboko Independent National Electoral Commission (INEC) don extend di deadline for political parties to submit names and credentials of candidates wey go contest 2027 presidential and National Assembly elections. Di electoral body say parties now get until midnight on Tuesday, July 14, instead of di earlier Saturday, July 11 deadline. According to INEC, di extension follow appeals from some political parties wey complain say dem face challenges to […]

todayJuly 12, 2026 24 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds