OBODO NAIJA

770 Results / Page 47 of 86

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Approve N3.9 Trillion For 27 Road Projects

Wi federal gorment again don tell igwe to give wi oga Presido Bola Tinubu, AKA Baba Seyi di award, say so fa, im don approve 27 road project-dem inside 15 states, and all di contract money na about 3.9 trillion Naira. Oga Minister of Works, David Umahi, fry mouth tuk dis one after di Federal Executive Council meeting for Abuja on Monday. Umahi list di states where di road go […]

todayJune 30, 2026 27

OBODO NAIJA

CJN Kekere-Ekun open computer System For Supreme Court Workings

Di Chief Justice, wey be di number judgii for Nigeria, CJN, Justice Kudirat Kekere-Ekun, don announce anoda ogbonge update wey go sharpen Naija Supreme Court like cutlass. Di senior woman yanyanpu dis mata during the NBA Lagos Branch Law Week 2026 on Monday. She fry fry mouth, say di court go soon start to use one new digital system, wey dem dey call, National Case Management System (NCMS) to follow […]

todayJune 30, 2026 22

OBODO NAIJA

Federal Gorment Make Change For Nysc

Di Federal Executive Council don approve big change  for National Youth Service Corps (wey wi sabi as NYSC), na di first ogbonge change for since e start 53 years ago. FEC order di Attorney-General and Ministry of Youth make dem amend di NYSC Act so all di new changes fit start immediately. Wetin be di change, Under di new arrangement, civilian go lead NYSC operations while military go still dey […]

todayJune 30, 2026 21

OBODO NAIJA

Tinubu Commission Open New Road For Abuja

Wi oga Presido, Bola Tinubu, don rake full newspaper again say im gorment dey deliver beta development to Nigeria Im yarn dis one through im Vice, Kashim Shettima wey go represent am for di event, commison road project for Karu, wi decision headquarters. Tinubu rake oh, say im road project na blood tonic to   local businesses and e dey  bring development.

todayJune 30, 2026 17

OBODO NAIJA

Dickson Beg Obi, Kwankwaso Make Dem No Dump NDC

By : Jolayemi Olajide Senior man leader of di Nigeria Democratic Congrees, Seneta Seriake Dickson don beg Peter Obi, Rabiu Kwankwaso and oda NDC candidates make dem no dump di party after Federal High Court judgment for Lokoja. U sabi Di court cancel im earlier order wey direct INEC to register NDC, say one Peace Movement Party dey claim di party logo. Dickson say make all aspirants remain calm as […]

todayJune 29, 2026 15

OBODO NAIJA

NARD Give FG Four Weeks, Threaten Nationwide Strike

Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD), dat di number one body mata pipo don declare say if wi Federal Gornment nor con follow dem discuss about dia  lazy salary in di next four-week, dem go shut down all hospital house for di Country. Dis according to a paper wey di association release on Sunday after dia special meeting wey hapun online on Saturday. NARD Presido, Dr. Mohammad Usman Suleiman, […]

todayJune 29, 2026 27

OBODO NAIJA

Bayelsa Police Don Arrest One 23-year-old University Student Wey Spread Fake Social Media News Say Bandits Don Invade Some Parts Of Di State.

Bayelsa Police don arrest one 23-year-old university student wey spread fake social media news say bandits don invade some parts of di state. Commissioner of Police, Daniel Iyamah, tok dis one on friday for Yenagoa, say di fake report cause serious panic and disturb business and school activities. According to am, di false story claim say militants catch di bandits and dey demand N50 million ransom before dem go release […]

todayJune 26, 2026 30

OBODO NAIJA

Kwankwaso Jam Obasanjo For Kano aliagn politics

Senator Rabiu Musa Kwankwaso pay courtesy visit to former President Olusegun Obasanjo for Kano on Thursday night. Obasanjo, wey dey Kano for official assignment, receive Kwankwaso for im temporary residence. Statement wey Saifullahi Hassan release say Aminu Gwarzo join Kwankwaso for di visit. Di statement no talk wetin di two leaders discuss during di meeting.  

todayJune 26, 2026 30

OBODO NAIJA

Check Food Label Before You Chop, NAFDAC Advise Nigerians

NAFDAC Director-General, Prof. Mojisola Adeyeye, don tell Nigerians make dem dey read food label before dem buy any packaged food. She tok dis one on Friday for Abuja during di launch of di "Read the Food Label" campaign, say bad food choice dey increase sickness wey no dey spread. According to am, di campaign go help people understand wetin dey inside di food wey dem dey buy and make better […]

todayJune 26, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds