OBODO NAIJA

770 Results / Page 48 of 86

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve Computer Health For Nigerian

President Bola Tinubu don approve di creation of National Health Technology and Data Analytics Office to coordinate Nigeria digital health system. Dis na according to statement fromĀ  Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, naim on Friday. According to di statement, di new office go operate under di Office of di Coordinating Minister of Health and Social Welfare.    

todayJune 26, 2026 23

OBODO NAIJA

Shettima Order NEMA To Prepare For Flood

By: Yusuf Abuh Vice-Presido, Kashim Shettima don direct National Emergency Management Agency, NEMA, and other gornment agencies make dem start work for Ā flooding now, make e nor con spoil something later. Di senior man vice presido give dis order on Thursday during meeting with di emergency task force pipo for Aso Villa, Abuja. Dis one follow National Economic Council approval of N83.2 billion on June 18 to support plans wey […]

todayJune 26, 2026 23

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Oyo Hope

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure pipo for Oyo State say, make dem nor too worry demselves say goment go rescue di pikins and dia teachers wey kidnappers carry from three primary schools for Oriire Local Government Area. Baba Seyi tok dis one for Ibadan for wia im go run one or two parrol. Im say security agencies dey use every possible way, including support from […]

todayJune 26, 2026 10

OBODO NAIJA

Femi Falana Advice FG To Give Naija Youth Work

By: Yusuf Abuh Human rights lawyer, Femi Falana, don drop beta bombshell say creating state police alone nor go fit solve Naija insecurity problem. According to di senior man lawyer, say, di tin nor go shake scale since poverty and unemployment strong. Falana yarn dis one for TV sit down tuk on Thursday, say plenty young pipo dey enta crime because of lack of work and no social support. You […]

todayJune 26, 2026 16

OBODO NAIJA

Two Pipo Kpai as Building Collapse for Port Harcourt

Residents for Odili Road, Port Harcourt, Rivers State, nor be small tin hapun yesterday, dem enter panic after one three-storey building collapse and trap some people under di rubble. Acting Permanent Seco for Rivers State Ministry of Health, Dr. Vincent Wachukwu, tok say emergency responders, ambulances and medical personnel quickly move go di scene after dem hear about di incident. E still konfam say two people wey get serious injuries […]

todayJune 25, 2026 23

OBODO NAIJA

Africa Go Gain From Raw Materials – Presido Tinubu

Wi oga Presido, Bola Tinubu, AKA baba Seyi, don shake table for Africa, say make African countries stop di anyhow character ofĀ  export dia raw materials and later buy back finished products for very high price. Senior man yarn dis one for Abuja during di 2026 African Natural Resources and Energy Investment Summit. Baba Seyi, through Solid Minerals Minister, Dele Alake, say Africa must learn to cook dia minerals inside […]

todayJune 25, 2026 23

OBODO NAIJA

Senate Clear Road For State Police Across Nigeria

By: Yusuf Abuh Di Senate on Tuesday pass bill wey go amend di 1999 Constitution to allow state police begin operate for all states across Nigeria. Senate Leader, Sen. Opeyemi Bamidele, present di bill before lawmakers consider and approve am afta more dan two-thirds of senators vote in support. Di bill create two police systems, Federal Police Service and State Police Services, to replace di current single Nigeria Police Force […]

todayJune 25, 2026 27 1

OBODO NAIJA

Abia Police Gbab Two Men Wey Pretend To Be NDLEA Officers

By: Emmanuel Ariyo-David Abia State Police Command don arrest two men wey dey accused of pretending to be NDLEA officers after one viral video show dem beating and handcuffing one keke rider for Umuahia. Detectives from Central Police Station for Umuahia arrest the suspects, Anthony Kelechi, 41, and Bright Abraham, 42, after investigation into the incident. Police spokesperson DSP Maureen Chinaka disclose this for statement wey she release on Wednesday. […]

todayJune 24, 2026 18

OBODO NAIJA

PDP Draw Line, Say Wike No Be APC Property

By: Emmanuel Ariyo-David PDP don clear air say FCT Minister, Nyesom Wike, still be their correct man and dem no get any plan to allow am waka go join APC permanently, even though e dey work for Tinubu government. Party tuk, tuk, Jungudo Mohammed, tuk dis one for statement on Wednesday, say Wike na one of dia biggest political tools and no amount of sweet tuk go make dem give […]

todayJune 24, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds