OBODO NAIJA

770 Results / Page 50 of 86

Background

OBODO NAIJA

UK Court Clear Diezani Of Six Bribery Charges

Former Nigeria oil minister and first woman president of OPEC, Diezani Alison-Madueke, don win her case for UK court as dem clear am of six bribery charges on Wednesday, June 17, 2026. Dis na according to statement from Her lawyer, Jonathan Laidlaw, dat Southwark Crown Court discharge all di allegations after five months of trial. UK National Crime Agency bin accuse am of collecting benefits from people wey get link […]

todayJune 18, 2026 21

OBODO NAIJA

Minority Lawmakers Drag Tinubu Gorment Over Insecurity, Hardship

By : Jolayemi Olajide Nor be small fire for wi house of representative today, wia  minority caucus drop bars say, President Bola Tinubu nor dey try at all,  dat   insecurity wan finish di giant of Africa. Dem yarn dis one for National Assembly for Abuja, according to  Minority Leader Fred Agbedi,  Nigeria don enter one of im worst period since 1999 democracy, say dis one, na demonstration of craze . […]

todayJune 17, 2026 22

OBODO NAIJA

Senate Clear Customs Over ₦62bn

Senate Committee on Public Accounts don clear Nigeria Customs Service over allegation say dem no remit ₦62.2 billion enter Federation Account as stated for 2019 Audit Report. Di committee, wey senators lead di touch lighting, take decision after dem hold session with Customs Comptroller-General, Bashir Adeniyi, over 77 audit queries for 2019 and 2020 reports. Dem say dem still go set up ad hoc reconciliation panel to review remaining 76 […]

todayJune 17, 2026 19

OBODO NAIJA

Federal Gornment Must To Fix Naija To Stop Xenophobic Attacks

Chairmo of Inter-Party Advisory Council, IPAC and National Chairmo of Allied People’s Movement, APM, Yusuf Dantalle, don clear FG, why dem need learn from di xenophobic attacks for South Africa, say na sign say Nigeria gat build build dia own country. Im yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday,. Dantalle say Nigeria suppose be example to oda African countries, if not say, dem never sti knw demselevs, […]

todayJune 17, 2026 22

OBODO NAIJA

Abuja Court of Appeal Vex, Stop INEC Plan

Di Court of Appeal for Abuja don stop di judgement wey say make INEC cancel African Democratic Congress (ADC) and four other political parties. Di three-judge panel wey Justice A. B. Mohammed lead vex well-well  for Justice Peter Lifu of di Federal High Court, say dem nor understand why im go suspend di case. Di appellate court say, wetin Justice Lifu do na pure 'judicial rascality' and e show say […]

todayJune 17, 2026 17

OBODO NAIJA

State Police No Go Take Food from dia table – IGP

Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don assure officers and men of Nigeria Police Force say plan to create state police no go scata or replace federal police. Im yarn dis one during im working visit to Jigawa State Police Command, According to Disu, federal police go still dey carry out dia constitutional duty of maintaining law and order across di country.

todayJune 16, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Muslims

Wi oga Presido, Bola Tinubu don felicitate Muslims for Nigeria and di obodo world as dem mark Islamic New Year, 1st Muharram 1448AH. Baba Seyi put dis one  for statement wey im send through im  Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, on Tuesday, E urge Nigerians make dem show patriotism and be beta citizens as di new Hijri year begin.      

todayJune 16, 2026 21

OBODO NAIJA

IGP Calm Federal Police Officers, Say State Police No Go Take Food from dia table

By : Jolayemi  Olajide Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don assure officers and men of Nigeria Police Force say plan to create state police no go scata or replace federal police. Im yarn dis one During im working visit to Jigawa State Police Command, According to Disu, federal police go still dey carry out dia constitutional duty of maintaining law and order across the country.

todayJune 16, 2026 26

OBODO NAIJA

Three Senators Deny Signature For Natasha Suspension

Play, play, truth don dey come out, u remember dat jogolo wey dem take suspend Kogi Senator, Natasha Akpoti for wi senate dat time Senator Adams Oshiomhole wey dey represent Edo North don come out nack tori, say dem forge di signature of at least three senators put for di report for di suspension letter. Oshiomhole yanyanpu dis mata for tv sitdown tuk on Monday, say ojoro everywia, ahooo. Di […]

todayJune 16, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds