OBODO NAIJA

770 Results / Page 51 of 86

Background

Economics

Dangote refinery reduce petrol price to ₦1,175

By : Jolayemi Olajide Dangote Refinery don drop dia petrol price to ₦1,175 per litre for marketers. According to dia management, dis na to see whether transporter fit reduce tfair small Oil experts believe say dis move go make competition better and help keep fuel supply stable for all corner of Nigeria.  

todayJune 16, 2026 21

OBODO NAIJA

Soldiers Rescue Wife Weh Bandits Shoot

Soldiers of Nigerian Army, with support from Air Force, don rescue di wife of late Major General Rabe Abubakar, Amina Abubakar, wey bandits carry go weeks ago. According to Defence Headquarters, through di Director of Defence Information, Major General Samaila Uba, dem say di rescue hapun under Operation FASAN YAMMA. Troops explain say dem jam di kidnappers for Tunga Village during serious search and attack operation against di criminals. As […]

todayJune 16, 2026 24

OBODO NAIJA

Okonkwo Drag ADC Over VP Choice

African Democratic Congress chieftain, Kenneth Okonkwo don criticize di party decision to pick Vice Presidential candidate from South-South for 2027 election. Im tuk dis one for TV sit down tuk say, di move fit worsen di political marginalisation wey South-East dey face since 1999, as dem never produce Presido or Vice Presido. Okonkwo also yarn say if ADC really choose candidate from South-South, e no go show fairness to other […]

todayJune 16, 2026 17

OBODO NAIJA

Why Court Wan Wipe ADC From Di 2027 Election

African Democratic Congress (ADC) don reject one Federal High Court judgment wey order INEC to deregister dem and four other political parties. U sabi say, Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja give di order on Monday, say di parties no meet constitutional and electoral requirements. Di party Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, naim con sorosoke for statement to reply, post for X, say di judgment dey unconstitutional […]

todayJune 16, 2026 22

OBODO NAIJA

Delta Activist, Mulade Drag NDC Go Court, Demand ₦5 Billion Over 2027 Ticket

Nor be small gbege for Warri as Delta activist, Sherrif Mulade, don drag im party, Nigeria Democratic Congress (NDC), go court dey demand N5 billion damages. Mulade dey vex say di party leadership sharp-ally corner di Warri Federal Constituency primary ticket wey im win, con give am to another person because of money. Di senior man tuk say di party don abandon democracy sell the ticket to the highest bidder, […]

todayJune 15, 2026 15

OBODO NAIJA

Warri Ijaw, Urhobo Cry Out, Tell INEC To Carryout Court Order

Ijaw and Urhobo pipo for Warri Federal Constituency don drop micro soft word to INEC to execute di Supreme Court order wey concern ward delineation report. Na leaders from both tribe tuk dis one for joint press conference wey happen for Warri on Sunday. Di meeting come after Abuja stakeholders session wey President Bola Tinubu arrange with dem. Dem also yarn say any further delay fit scatter di small peace […]

todayJune 15, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Abdulsalami

Wi Presido, Bola Tinubu yesterday praise shege comot former military Head of State, Abdulsalami Abubakar, head, say im na oga na master for naija democratic. Tinubu tuk dis one for Abuja during public book presentation wey dem hold to honour Abdulsalami 84th birthday, and na  Vice Presido Kashim Shettima represent am fry mouth for di event. Shettima drop Tinubu message say Abdulsalami leadership naim bee di stew for naija democracy, […]

todayJune 15, 2026 19

OBODO NAIJA

Sowore Tell Presido To Resign

Still on same mata, na Omoyele Sowore carry protester dey protest for wi decision headquarters, say make wi oga presido resign. Di senior man fry, fry mouth unto many tins for di Democracy day protest wey dem do for Abuja. According Sowore, security zero, food sef nor dey, say, Nigerians don lost dia democracy and dey demand back from di gorment.

todayJune 12, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Say No Mercy For Jaguda Boys

By: Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don drop micro soft word for democracy day, say make dis terrorists, bandits and kidnappers, nor too worry bodi, dat di gorement and security dey come for dem with full force. Im knack dis one for im Democracy Day speech wey e deliver on Friday to mark Nigeria 27th uninterrupted democracy anniversary. Baba seyi burst mehn bolobolo when im say, torrist killings […]

todayJune 12, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds