obodo oyinbo

135 Results / Page 10 of 15

Background

obodo oyinbo

Syrian Government, SDF Agree Ceasefire

By: Esther Ayoola Syrian government share update, say dem don reach agreement with Kurdish-led  Syrian Democratic Forces, SDF,  say make dem stop to kill dia self. Dis agreement  dey come  days afta plenty fight, fight between di Syrian gornment and di SDF for  northeastern Syria. According to report, SDF go comot from area wey dey west side of River Euphrates. Syrian Presido Ahmed al-Sharaa tuk on Sunday say, gornment go […]

todayJanuary 19, 2026 9 6

obodo oyinbo

Trump Promise To Send Soldiers Go Minnesota To Stop Protest

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don cut chain, say e fit use one old law wey dem dey call Insurrection Act to send U.S. military go Minnesota, if state officials no stop di protest wahala for Minneapolis. Di law fit allow military for inside America to help restore order. Dis warning dey come as protests heat up afta federal Immigration and Customs Enforcement (ICE) officers shoot people during […]

todayJanuary 16, 2026 16

obodo oyinbo

Museveni Lead Uganda President Election From first results with 76 percent

By: Esther Ayoola Oga Presido of Uganda, Yoweri Museveni like dis don dey dust im opponents, dey lead Uganda election result as counting of votes dey on. According to Electoral Commission of Uganda, afta dem count almost half of di polling units, Museveni get about 76 percent of di vote, while im main challenger, Bobi Wine, get around 20 percent. Like dis di gbege nor be here, say Bobi Wine […]

todayJanuary 16, 2026 8

obodo oyinbo

Iran Go Fast Track Trials Afta Trump Threat

By: Esther Ayoola Iran gornment vow to fast-track trial for people wey dem arrest during big protests, Iranian Judiciary Chief Gholamhossein Mohseni Ejei tuk on Wednesday. Di promise come afta US President Donald Trump warn say dem go face “very strong action” if Iran go ahead with hangings. Rights groups say crackdown fit don kill thousands as protesters challenge Iran clerical leadership, but government insist dem don regain control. Ejei […]

todayJanuary 14, 2026 7

obodo oyinbo

France Wan Open Emergency Mata House For Greenland February

By: Esther Ayoola Say, France wan open emergency mata house, wetin oyibo dey call consulate for Greenland on February 6, 2026. French Foreign Minister Jean-Noel Barrot tuk on Wednesday, say, di move na beta political move based on say Greenland dey strategic. Dis one dey come following US Presido, Donald Trump don bin yarn, dat im wan seize di island. Say infact, Denmark top diplomat dey meet US officials for […]

todayJanuary 14, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Tell Us: We Ready To Tuk, But No Go Accept Intimidation

By: Esther Ayoola Iran tuk say dem still dey communicate with America through Switzerland, even as protest and violence dey spread for di country. Iran foreign ministry tuk say dem ready for dialogue but no go accept any one-sided tuk or foreign interference. Untop yaning for us, President Trump confamate say, Iran call am to negotiate nuclear matter, while e still dey threaten strong action. Meanwhile, gornment don shut internet, […]

todayJanuary 12, 2026 8

foreign

Iran Presido, Pezeshkian Promise to Listen to Protesters

By Ebi Oboko Iran presido, Masoud Pezeshkian, don bow to pressure,   say  dem go  rearrange di iran economy wey dem spoil, dey warn protesters to be calming down. Pezeshkian dey beg for tv sit don tuk, say make di protesters nor go do until  “rioters” and “terrorist elements”  con take over di mata, say dat one  go be big  wahala. The protest don enter third week after market people for […]

todayJanuary 12, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Warn: US Fit Hit Nigeria Again Over Killings

By: Esther Ayoola US President Donald Trump don warn say America fit launch more military strikes for Nigeria if violence against Christians no stop. Trump tuk dis one on Thursday during wide interview with The New York Times, as e respond to question about di US airstrike wey happen on Christmas Day for northwest Nigeria. According to am, di December 25 strike target Islamic State-linked militants at di request of […]

todayJanuary 9, 2026 12

obodo oyinbo

Naija Collect $9.5M from Jersey – Govt Yarn

By: Esther Ayoola Authorities for Jersey, British Crown Dependency wey dey between UK and France, yarn say dem go return over $9.5 million (£7 million) wey belong Nigeria government. Attorney General for Jersey, Mark Temple KC, tuk say di money go dey used for infrastructure projects across Nigeria. Him yarn dis one follow Memorandum of Understanding wey dem sign with Nigeria government for December. Dis repatriation na continuation of past […]

todayJanuary 9, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app