obodo oyinbo

429 Results / Page 26 of 48

Background

obodo oyinbo

Germany Open Scholarship for African Graduates

By: Esther Ayoola Germany don open application for one scholarship programme wey dey target graduates and postgraduates from Sub-Saharan Africa, to give dem chance for further study and research abroad. Dem announce am for dia X handle on Friday, tuk say na part of their plan to support international academic cooperation. Dem say DAAD scholarship don ready now and make interested people check di flier for full details and apply […]

todayApril 10, 2026 11

obodo oyinbo

Melania Trump Deny Report Say She Nor Get Link With Epstein

By: Esther Ayoola For White House on Thursday, first lady, Melania Trump don address reporters how she nor get any connection with Jeffrey Epstein, di widespread sex trafficking network. She say make all those claims stop because dem dey spoil her name. She explain say na only once she “cross path” with Epstein around year 2000, and say di rumor dat she introduce Epstein to Donald Trump no be true, […]

todayApril 10, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Call Out Iran Say Dem Need To Do More For Di Strait Hormuz

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump say like dis Iran dey do “very poor job” for how dem dey handle oil wey dey pass through di Strait of Hormuz. Im tuk dis one for public statement, say Iran nor dey match di agreement wey dem agree. Even though say oil don dey pass di Strait of Hormuz, say di ceasefire agreement never show full workings.

todayApril 10, 2026 12

obodo oyinbo

Two Ships Pass Strait Of Hormuz After Cease Fire Deal

Say like dis, two ships don pass through di Strait of Hormuz since US and Iran do ceasefire deal overnight from Tuesday night go Wednesday. According to Marine Traffic for dia X page, dem say one Greek-owned bulk carrier NJ Earth cross di Strait by 08:44 UTC, while one Liberia-flagged Daytona Beach don pass earlier by 06:59 UTC, shortly after e depart from Bandar Abbas by 05:28 UTC. According to […]

todayApril 9, 2026 15

obodo oyinbo

Israel Fire Big Air Strike For Lebanon,182 Die, 890 Wound

Israel don fire plenty air strike for Lebanon, dem talk say na di biggest one so far. Dem target more than 100 Hezbollah place for 10 minutes. Lebanon health ministry talk say at least 182 people don die and 890 na im wound. For Beirut, pipo still dey find survivors from rubbles, while families dey mourn and pick wetin remain of dia life.

todayApril 9, 2026 14

obodo oyinbo

UN To Vote On How To Open Hormuz Strait, Trump Give Iran Deadline

By: Esther Ayoola Say like dis UN Security Council go vote to address do mata of di middle east, on how dem go unblock di Strait of Hormuz. Say nobody go use force, even for defense, but di aim na to find solution. Dis vote go hapun few hours before Donald Trump 8:00 pm deadline for Iran to make deal or U.S go destroy im power plants and bridges. Bahrain, […]

todayApril 7, 2026 14

obodo oyinbo

10 Pipo Kpai For Gaza As Hamas Clash With Israel-Backed Militia

By: Esther Ayoola At least, ten pipo don kpai for Gaza, afta Israeli air strikes and fight between Hamas and Israel-backed militia. According to local hospital source, di fight hapun Monday, near Maghazi refugee camp, when Hamas pipo attack militia wey go do checkpoint for dia area. Al-Aqsa hospital for Deir al-Balah naim receive di bodies, and many other pipo wunjur, some dey critical condition. Local witnesses tuk say di […]

todayApril 7, 2026 16

obodo oyinbo

Trump Give Iran Deadline, Make Deal Or Risk ‘One Night’ Strike

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don drop some micro soft words for White House on Monday say e fit finish Iran “for one night” if dem no make deal before im deadline. Say di deadline na 8pm Washington DC time on Tuesday (12am GMT Wednesday). Addressing state media, Trump say e believe some reasonable leaders for Iran dey negotiate for “good faith,” but e no sure how di […]

todayApril 7, 2026 14

obodo oyinbo

Presido Trump To Touch Light Iran Ceasefire Deal

White House officials, all di way from united state of America on Monday don konfamate say dem dey consider one 45-day ceasefire deal between U.S. and Iran for di Middle East war. Di senior men wey tuk with Agence France-Presse, say di only tin be say Donald Trump never sign di deal. Dem explain say na mediators bring di proposal as part of efforts to reduce di fighting, but Trump […]

todayApril 7, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds