obodo oyinbo

429 Results / Page 6 of 48

Background

obodo oyinbo

Cholera Kpai 120 pipo for Sudan

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin say one wicked  cholera outbreak don scarra  Sudan,   kpai  120 pipo, and dem sti dey suspect  1,102  cases. The World Health Organization (WHO) tuk say di three years war between the Sudan army and the RSF fighter group don scatter the country healthcare system kpata-kpata. Dis na di third time wey cholera heavy wave dey hit Sudan back-to-back inside three years, just […]

todayJuly 1, 2026 13

obodo oyinbo

Heatwave Kill Over 1,000 People For Spain

More than 1,000 pipo don kpai for Spain because of di recent heatwave wey roast Europe. Spain Carlos III Health Institute konfam dat at least 1,028 pipo naim don kpai from heat-related sickness during di extreme hot weather. Di death figure double di 407 deaths wey Spain record for June 2025, wey bin be di hottest June before. Weather agency Aemet also confirm say di first six months of 2026 […]

todayJuly 1, 2026 9

obodo oyinbo

China Wash Hand Comot From World Bank Loan

Di World Bank don konfamate say dem dey enter new phase for dia relationship with China, say China don dey wash hand comot for loan mata small, small. One World Bank official konfam how ogbonge development dey cry for China based on di ogbonge support wey dem get from di world bank. Di official add say di new relationship dey reflect how China economy and development dey grow vavava dan […]

todayJuly 1, 2026 9

obodo oyinbo

South Africa Police block Everywia To Stop Xenophobic Groups

Nor be small tin for South Africa, as police block everywia say xenophobic groups wan drive foreigners to comot. Dem lock up shops tight and streets quiet like say na grave yard for Johannesburg as police dey patrol to block any kind fight or looting. For Durban, small groups of protesters wey wear Zulu clothes and hold stick and shield gather for park dey sing "abahambe", wey mean "make dem […]

todayJune 30, 2026 11

obodo oyinbo

US military Rush Open Port For Aid

US military like dis dey fire doings to reopen one major port for La Guaira, Venezuela, to hellep rescue pipo after ejima earthquakes wire di country last week. Five days after di quakes level, whole blocks of buildings, like dis na family members dey cry blood say di don kpai over 1,700 pipo and thousands still dey miss. One temporary matuary inside di port area full with deadibody Forensic doctors […]

todayJune 30, 2026 11

obodo oyinbo

Pakistan, Afghanistan Face-to-Face as Airstrike Kpai Dozens for Border

By : Jolayemi Olajide See gbege, Pakistan go launch airstrike and send ground troops enter Afghan province, kpaikpai pipo yangayanga on Sunday. Di Taliban gornment for Afghanistan  say at least 36 civilians, including women and children, kpeme inside the attack and over 160 people sustain wound. But Pakistan Information Minister, Attaullah Tarar, change am, say 29 militants st caput  inside di strikes wey target wia di  bad boys dey hide. […]

todayJune 29, 2026 8

obodo oyinbo

Plane Crash Kpai 11 Near France Airport

Eleven pipo naim don kpai after one civilian plane wey carry skydivers crash, play, play turn to hit an go, say di plane get askident near Tomblaine for eastern France on Sunday. According to local authorities, Di victims include five instructors, five students and di pilot, as di plane fall near Nancy-Essey airport close to residential area. Authorities say nobody wey dey ground die, while dem don open investigation to […]

todayJune 29, 2026 11

obodo oyinbo

America Send Support To Venezuela To Rescue Earthquake Victims

America don send military and rescue support go Venezuela after two strong earthquakes of 7.2 and 7.5 magnitude kill at least 188 people. Di earthquakes destroy plenty buildings, damage di country main airport and leave many people trapped under rubble. US Southern Command talk say dem go help rescue teams find survivors, check di damage and deliver emergency help to victims. America also deploy USS Fort Lauderdale, USS Billings, C-17 […]

todayJune 26, 2026 12

obodo oyinbo

Venezuela Earthquake Kpai 188 Pipo As Of Thursday

By: Yusuf Abuh Death toll from di strong earthquake wey shake Venezuela don rise reach 188 people, while 971 pipo don sustain injury, according to government officials. Dem say about 30 aftershocks don hapun since di two big earthquakes of 7.2 and 7.5 magnitude hit di country on Wednesday. Di disaster make plenty buildings for Caracas collapse and force authorities to close di main airport as rescue workers still dey […]

todayJune 26, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds