obodo oyinbo

580 Results / Page 7 of 65

Background

obodo oyinbo

US Supreme Court Block Trump Mail Ballot Plan

By: Mariam Ajayi US Supreme Court don block President Donald Trump plan to change how dem dey send mail-in ballots give voters across America. Di court stop di plan on Monday after election officials warn say e fit cause confusion and disenfranchise millions of voters for dis year midterm election. Two conservative justices, Samuel Alito and Clarence Thomas, oppose di decision, while di court say Trump administration no likely win […]

todaySeptember 15, 2026 11

obodo oyinbo

Donald Trump Blast Tech Bosses, Say Dem Mumu If Dem Fear AI

By: Mariam Ajayi US President Donald Trump don blast tech big boys, say AI go destroy di world say na big lie. Wetin hapun, na one tech oga,  Anthropic big-boy, wey dem dey call Jack Clark tell BBC  naim say make gornment  force tech companies to put mandatory kill switch button to turn off any crazy AI. Trump come jump enter e social media page dey drag  say Jack clark […]

todaySeptember 15, 2026 10

obodo oyinbo

China Rejects Claim Say Dem Give Iran US Base Images

By: Kofoworola Olayinka China don reject reports say Chinese entities supply Iran with satellite images of US military base in Jordan before and after Iranian missile strike wey kpai three American soldiers on July 17. Chinese Foreign Ministry spokesperson Guo Jiakun reject di claim on Monday, saying Beijing oppose wetin e call groundless accusations without evidence during regular briefing. Di reports wey Wall Street Journal publish say US officials no […]

todaySeptember 14, 2026 11

obodo oyinbo

Trump Clear marras On China Role Of Iran Bombing US Base

By: Mariam Ajayi US presido Donald Trump, don clear tatafo say make dem rest, which one be China naim supply Iran informate to Bumb Jordan, kpai  three US Army. Trump yarn dis one inside Air Force One airplane, senior man first laugh, say US sef dey Spy China, dat one nor be news, and dat di mata sef nor get evidence. Di Senior man Presido, sti clear mata say di […]

todaySeptember 14, 2026 27

obodo oyinbo

Iran President Say US Pressure Don Reach Dangerous Level

By: Kofoworola Olayinka Iran Presido Masoud Pezeshkian say US pressure on Iran don reach critical and dangerous level, as e speak for India on Friday ahead of BRICS summit. Pezeshkian say heavy sanctions and economic pressure don make Iran matter worse, especially after US and Israel military attack on Iran. He say di world dey face unprecedented complexity, as di conflict don hit Iran economy wey international sanctions already weaken.

todaySeptember 11, 2026 14

obodo oyinbo

National Assembly Don Stop Trips Go South Africa

By : Jolayemi Olajide National Assembly don tell senators, members and workers make dem no travel go South Africa for official work until further notice. Dem also say make nobody from National Assembly join any meeting or programme wey South Africa organise for lawmakers. House of Representatives spokesman, Akin Rotimi, talk say dem take dis decision because of reports say Nigerians and other Africans still dey face attack and serious […]

todaySeptember 11, 2026 9

obodo oyinbo

Gambia Vex Protest say Dem nor get light for 48 hours

By: Mariam Ajayi Nor be small tin for Gambia, say Thousands of angry youths  enter street near Banjul for Gambia overnight  vex, squeeze face like man wey mess for taxy. Before Police say jack, Youths begin sing wi nor go gree, we gree, ha, wetin ona nor dey gree, say may dem nor go get light for 2 days and heat dey> Suuuu, say na di second time dis week […]

todaySeptember 11, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Say Republicans Win, Every Adult Go Get $5,000

By: Ayobami Dada Us presido Donald Trump don promise to give every adult American $5,000 if Republicans win control of both House of Representatives and Senate for November midterm election. Trump make di promise on Wednesday for Republicans Party first midterm convention for Dallas, Texas, as e turn di campaign rally into plan wey fit put plenty money for American pocket. Trump call di money "dividend" but e no explain […]

todaySeptember 10, 2026 13

obodo oyinbo

Flights To Di United Kingdom Worwor As Dem Cancel Nearly 400 Flights

By: Ayobami Dada Pipu wey dey travel by air for UK face more wahala on Wednesday as dem cancel nearly 400 flights across di country, after technical problem affect Britain air traffic control service, wey say di incident no be cyberattack. After 1,746 flights cancel on Tuesday following di outage, another 399 flights cancel on Wednesday, mostly flights wey dey go or come from London Heathrow Airport, one of Europe […]

todaySeptember 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds