obodo oyinbo

510 Results / Page 7 of 57

Background

obodo oyinbo

17 Migrants Die As Boat Drift 15 Days For Sea

By: Esther Daniel Two North African migrants don survive after dem spend about 15 days dey drift for Mediterranean Sea as dem dey try reach Spain Balearic Islands. Rescue team save dem early Tuesday morning about 13 nautical miles from Mallorca. Di two men dey battle dehydration and serious hunger, so rescue workers rush dem go hospital for treatment. According to wetin di survivors tell rescuers, na 19 pipo bin […]

todayAugust 4, 2026 15

obodo oyinbo

Ukraine Strike Hit Three Wildberries Warehouses For Russia

By: Esther Daniel Ukraine don launch overnight attack on Monday wey hit two Wildberries warehouses, while anoda site wey dem believe say get link with Russia biggest online shopping company also suffer damage near Moscow. For di past few weeks, Ukraine don dey target Wildberries facilities, wey plenty pipo dey call "Russia Amazon," as part of dia attacks. Local officials tok say at least five pipo die and 10 oda […]

todayAugust 4, 2026 10

obodo oyinbo

Man Hide Mama Body Inside Freezer for Almost 3 Years, Land Jail

By: Esther Daniel Strange story don shock people as 60-year-old Christopher Phillips collect two years and four months jail term after e hide im mama body inside chest freezer for almost three years. Court hear say Phillips keep di body of im 89-year-old mother, Sylvia Phillips, for dia family house after she die for March 2023, while e continue to collect her pension and other benefits. Di man tell court […]

todayAugust 4, 2026 12

obodo oyinbo

Blood Don Flow, Drone Strike Scatter Russia Beach As Seven People Kpai

By: Esther Daniel Sunday fun turn nightmare as drone strike hit Arkhipo-Osipovka beach for Krasnodar, Russia, kill seven people including three pikin and throw di area into panic. Gofnor Veniamin Kondratyev accuse Ukraine of targeting civilians, say 40 people wunjor and 17 pipo still dey hospital for treatment. People wey witness di attack tok say dem hear gunfire before one heavy blast as Russian air defence try stop di drone […]

todayAugust 4, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Deny Fresh Peace Tuks With United States

Iran don wash hand comot from reports say dem do any peace tuk with di United States of America. Dis na after, President Donald Trump tuk say, yesterday, wey be Monday, say dem go open new chapter for di book of life, and arrange di peace tuk . Iran Foreign Ministry  say nothing like dat oh, infact no discussion even though US match break small for di attack wey dem […]

todayAugust 4, 2026 20 3

obodo oyinbo

Kasala Don Red! Russia and Ukraine Fire Back, 14 People Don Lose Dia Life

By: Esther Daniel Chai! Blood don flow again as fresh attack and counterattack between Russia and Ukraine on Sunday don kill at least 14 people, with Ukraine strike wiping nine people for Russian territory while Russia own attack take five lives for Ukraine. Officials for both Russia and Ukraine confirm di deadly attacks, tok say both sides continue to rain missiles and drones because nobody wan back down as di […]

todayAugust 3, 2026 11 1

obodo oyinbo

Iran Mark Present for Peace as US Suspend Fresh Attack

By: Yusuf Abuh Iran don bring out chest say, dem don reach peace agreement with Oman to open di Strait of Hormuz, since U.S don decide to respect demselves to end di war for inside middle east. U sabi say, US Presido Donald Trump say America and Israel agree say dem nor go fire tins enter Tehran, since dem don agree to tuk peace Since February 28, US, Israel and […]

todayAugust 3, 2026 9 1

obodo oyinbo

US Don Vex! Blow Hot for Kaduna Massacre, Tell Tinubu “E Don Do!”

By : Jolayemi Olajide Di United States don strongly condemn di early morning attack wey happen on July 27 for one village in Kaduna State, where reports say at least 30 people, including children, lose dia lives after gunmen attack di community. For statement wey di US Bureau of African Affairs post on X, Washington tok say e dey deeply sorry for di families of di victims and condemn di […]

todayAugust 1, 2026 12

obodo oyinbo

Liberia Presido Sack 12 Officials As Big Cocaine Scandal Burst

By: Esther Daniel Liberia Presido, Joseph Boakai don sack 12 gornment officials and order investigation into some others after massive cocaine seizures shake di country and spark public anger. Boakai announce di decision through official statement on Thursday night, say di move na to tighten di fight against drug trafficking and hold people accountable. Earlier dis month, security agencies seize almost four tonnes of cocaine worth about 317 million dollars […]

todayJuly 31, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds