Sport Yarns

103 Results / Page 3 of 12

Background

Sport Yarns

FIFA World Cup Golden Boot Race Hot

By : JolayemI Olajide Race for the 2026 FIFA World Cup Golden Boot don hot up after second round of group-stage matches finish, with Argentina captain Lionel Messi leading the scorers table. The eight-time Ballon d’Or winner don score five goals and never record any assist so far. Messi start the tournament with hat-trick before adding two more goals for Argentina second group game.

todayJune 24, 2026 14

Sport Yarns

Argentina, France Set for Big World Cup Clash Against Austria and Iraq Tonight

By : Jolayemi Olajide Unto di World cup update, Argentina dey face Austria for dia World Cup Group J match today by 6 p.m. Nigerian time. While France go also meet Iraq for Group I clash by 10 p.m. Nigerian time, with Kylian MbappĂ© and im teammates ready to push for another victory. Both matches go be big test as teams dey try secure beta position for dia group stage […]

todayJune 22, 2026 10

Sport Yarns

Pochettino tell Messi Sorry, for im papa wey dey hospital

By : Jolayemi Olajide USMNT head coach, Mauricio Pochettino, don message Lionel Messi and im family, after dem rush Messi papa go hospital. Pochettino fry mouth say normal, messi papa, Jorge, receiving treatment for hospital na distraction, but encourage di senior man to stay focus dat im papa go dey alryt. Di former PSG boss, wey sabi Messi well-well, send im full support and best wishes to the family as […]

todayJune 19, 2026 8

Sport Yarns

World Cup Gbege, Police Gbab Ivorian Star Elye Wahi Over Betting Scandal

By : Jolayemi Olajide Nor be small gbege, Ivory Coast striker, Elye Wahi, don enter world cup hot soup. According to report, French police arrest am just two weeks before di  2026 World Cup over alleged spot-fixing. Omo, the gist be say the 23-year-old allegedly collect yellow card on purpose during one Ligue 1 match between Nice and Metz back in May, all just to settle one dirty betting arrangement. […]

todayJune 18, 2026 10

Sport Yarns

England  set eye for dia long-awaited glory as World Cups

By : Jolayemi Olajide Unto di world cup update, England don dey fire body to begin dia mission to end 60 years trophy without winning any trophy. Today dem go face Croatia for dia World Cup opener. Meanwhile, Cristiano Ronaldo, wey be 41 years, go feature for record-equalling sixth World Cup as e dey prepare to lead Portugal against DR Congo for Houston.  

todayJune 17, 2026 9

Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

By : Jolayemi Olajide Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles. According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament. Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly […]

todayJune 16, 2026 11

Sport Yarns

Senegal senior man football tuk, tuk share moral for France vs. Senegal world cup game

By : Jolayemi Olajide Say like dis now, di America, world cup dey hot, As Senegal ready to jam France for dia 2026 World Cup opener. According to di tuk tuk person for Senegal football, Ousmane Sonko, dis match be like two African side playing demsleves and dat di game get deep meaning for football. Sonko explain, say based on the plenty African players wey dey inside French squad, Sonko […]

todayJune 16, 2026 9

Sport Yarns

Amorim to Pick Up AC Milan Coaching Job

By : Jolayemi Olajide Dem really tuk say, one man food na another man poison, say former man united coachie, Ruben Amorim don dey close to become AC Milan new coach Dis na according to report from Italy,  Milan go  later this week to sign two-year contract. The 41-year-old Portuguese manager go replace Massimiliano Allegri, wey dem sack after poor results  wey make Milan miss Champions League qualification.  

todayJune 15, 2026 11

Sport Yarns

Roberto Martinez Hail Eric Chelle, Say Him Workings Dey Show 

By : Shalom Ovie Portugal coachie,  Roberto Martinez, don talk say e dey impressed with Super Eagles coachie, Eric Chelle, as e dey build im own football style for Nigeria side. Martinez talk dis one for him pre-match interview before di match, say Nigeria na strong side and Chelle don give dem clear football identity wey dey show. Even though some key players no dey, Martinez still talk say Nigeria […]

todayJune 11, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds