Sport Yarns

107 Results / Page 2 of 12

Background

Sport Yarns

Stanley Nwabali Return back to Chippa United for South Africa

By : Yusuf Abuh Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali don return to South African club Chippa United five months after e announce say e dey leave di team. Chippa United konfam say di Nigeria international don come back to Eastern Cape ahead of di new season. Di club say Nwabali experience, leadership and presence go bring more value to their squad. Di goalkeeper transfer plan wey make am leave di […]

todayJuly 13, 2026 12

Sport Yarns

Senegal Sack Coach Pape Thiaw After World Cup Crash

Edited By Ebi Oboko Senegal don sack dia head coach, Pape Thiaw, after di team crash comot for Round of 32 for 2026 FIFA World Cup. Senegal Football Federation tok say dem don sack Thiaw and all di coaching crew after executive committee meeting on Sunday. Di federation presido, Abdoulaye Fall, go address journalists on Monday to explain why dem take di decision and wetin dey next for di national […]

todayJuly 12, 2026 14 3

Sport Yarns

England, Argentina Renew Old World Cup Rivalry

Edited by Ebi Oboko England and Argentina go face each other for one heavyweight World Cup semi final on Wednesday after both teams beat Norway and Switzerland for quarter final. Argentina, with Lionel Messi, dey chase back-to-back World Cup title, while England dey hope to  end dia 60-year wait for major trophy. Winner of di match go face either France or Spain for di World Cup final on July 19. […]

todayJuly 12, 2026 9 2

Sport Yarns

Power Slap Hulk Challenge Anthony Joshua to Fight

Edited by Ebi Oboko Nigerian Power Slap heavyweight, Kabiru Adediran wey people sabi as "Hulk", don challenge British-Nigerian boxing star Anthony Joshua to one fight. Hulk tok say nor be cruise oh dat, im go like  enter ring with Joshua wey e call im role model. According to am, even if Joshua beat am, di fight fit change im life because e go still collect beta money. Di former Davido […]

todayJuly 12, 2026 14 2

Sport Yarns

How Flamingos take  Fly Enter 2026 U-17 Women World Cup

Edited by Ebi Oboko Nigeria U-17 women team, di Flamingos, don qualify for 2026 FIFA U-17 Women's World Cup after dem beat Benin Republic 5-3 for second leg in Lomé, Togo. Di victory give Nigeria 8-5 aggregate win and secure one of Africa qualification tickets for di tournament. Queen Joseph shine well with hat-trick, while Mary Akpan Dunstan and Esther Enne Stephen also score for di Flamingos. Di 2026 FIFA […]

todayJuly 12, 2026 10

Sport Yarns

Spain Knock Belgium Out, Set for France Showdown

Edited by Ebi Oboko Spain don beat Belgium 2-1 to qualify for the World Cup semi-final, where dem go face France. Fabian Ruiz score first for Spain before Charles De Ketelaere equalise for Belgium before halftime. Mikel Merino later score di winning goal after Belgium substitute goalkeeper Senne Lammens fumble the ball. Spain now don set big semi-final clash with France and Kylian Mbappe for Tuesday.  

todayJuly 11, 2026 15 7

OBODO NAIJA

Ajibade, Oshoala Lead Super Falcons Squad for WAFCON

Super Falcons coach, Justine Madugu, don release 25-player squad wey go represent Nigeria for 2026 Women Africa Cup of Nations for Morocco. Captain Rasheedat Ajibade, goalkeeper Chiamaka Nnadozie and striker Asisat Oshoala dey among di players wey go defend Nigeria continental title. One big surprise for di list na say defender Ashley Plumptre no make di final squad despite her strong performance for di team before. Nigeria, wey don win […]

todayJuly 11, 2026 16 3

Sport Yarns

Sinner, Zverev One Match Away from Wimbledon Glory

Jannik Sinner don beat Novak Djokovic straight sets 6-4, 6-4, 6-4 to qualify for di Wimbledon final and stop di Serbian legend from chasing him 25th Grand Slam title. Alexander Zverev too nor waste time as e brush aside British wildcard Arthur Fery 7-6, 6-2, 6-4 to book him own place for di final. Now, Sinner and Zverev go face each other for Sunday to battle for di Wimbledon trophy.

todayJuly 11, 2026 17 3

Sport Yarns

Rice and Odegaard to Face Each Other for World Cup quarter finails On Saturday

By : Jolayemi Olajide Declan Rice of England and Martin Odegaard of Norway go meet each oda for di FIFA World Cup quarter-final. Di two players be teammates for Arsenal Football Club in London, where dem help di club win di Premier League title and reach di UEFA Champions League final. But now, dem go stand against each oda because Rice dey represent England, while Odegaard dey captain Norway. Both […]

todayJuly 10, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds