Sports

444 Results / Page 10 of 50

Background

Sports

Morocco Start AFCON Strong, Beat Comoros 2-0

By: Esther Ayoola Morocco don start dia Africa Cup of Nations waka wella beating Comoros 2-0 for di tournament opener on Sunday. Brahim Diaz score di first goal 10 minutes afta di second half start, and Ayoub El Kaabi follow am up with fine overhead kick. Dis win don give di Atlas Lions better chance for di next Group A matches against Mali and Zambia.

todayDecember 22, 2025 4

Sports

Junior D’tigress Naija Jump Nine Places For FIBA World Ranking

By: Rilwan Agbomeji Right now, na junior dey hot for basket ball , say dem climb nine places for di latest FIBA world ranking for girls, moving to 26 for world. Di ranking wey come out for Thursday, show say Naija na di fourth biggest movers as dem jump from 30 to 26. For Africa, Junior d’tigress dey for number three with 469.5 points, behind Mali wey dey 16th and […]

todayDecember 19, 2025 21

Sports

Joshua Ready To Whack Jake Paul For Miami Ring Fight

By: Esther Ayoola Naija, UK senior boxer Anthony Joshua say im don package beta blow for youtuber, Jake Paul for ring today for Miami, say Paul chor chor tukings, na today im go tidy am for ring. Joshua tuk say e wan beat Paul make other online tuk tuk dem learn, dat, nor by to tuk and dat boxing dey im blood, even afta im loss to Daniel Dubois last […]

todayDecember 19, 2025 13

Sports

Alonso Dey Fight Make E Still Get Im Job – Tote

By: Rilwan Agbomeji  Former Real Madrid striker, Tote, don yarn say manager Xabi Alonso dey fight to keep im job for di club. Tote yarn dis for one siddon talk show say decision to sack Alonso don almost ready as confidence don low for am. E yarn say Xabi dey struggle every three days to prove himself, and di pressure na heavy for am. According to Tote, some people no […]

todayDecember 18, 2025 12

Sports

FIFA Don Slam Malaysia – 3 Games Turn 3-0 Ls On Top Fake Players Wahala

By: Rilwan Agbomeji FIFA don punish Malaysia with three 3-0 Ls after dem play ineligible players, Football Association of Malaysia (FAM) confirm Wednesday. Friendly wins wey dem get against Palestine and Singapore, plus draw with Cape Verde, don turn to losses, as FIFA don strike dem. Seven foreign-born players wey claim Malaysian ancestry don already dey suspended, and FAM don pay extra $12,500 fine on top di previous $440,000. FAM […]

todayDecember 18, 2025 4

Sports

Ighalo Talk Am Clear – Osimhen Suppose Carry Super Eagles Captain Band

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles hitman, Odion Ighalo, don drop am hot say Victor Osimhen na di right man to wear Super Eagles captain band. Dis talk come afta ex-captain, William Troost-Ekong, comot from international football. Though many people dey shout Wilfred Ndidi name, Ighalo say Osimhen get di fire, form and liver to lead di team. According to am, Osimhen dey ball well and no dey fear to […]

todayDecember 18, 2025 10

Sports

Super Eagles Jim Jim Bodi For Cairo, 12 Players Still Dey Load

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles don kick off dia Cairo mission, as dem go hold first official training on Monday evening, after more players don touch camp ahead of di international match, Training go start 8:00pm local time for main bowl of Cairo International Stadium, with coach Eric Chelle and im technical crew dey ready to drill di boys. As at Monday morning, 11 players don report for Renaissance Hotel […]

todayDecember 15, 2025 12

Sports

Alcohol, Animals, Other Items No Dey Allowed Inside AFCON 2025 Stadiums

By: Rilwan Agbomeji As AFCON 2025 dey near, wey go start December 21 for Morocco, CAF don release list of items wey no go allow for all stadiums. Dem put di rules for dia website on Monday, talk say na to keep fans safe throughout di tournament. Everybody wey wan attend AFCON matches for Morocco go need pass security screening before dem fit enter stadium. Di guideline dey make sure […]

todayDecember 15, 2025 11

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now […]

todayDecember 15, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app