obodo oyinbo

Oil Price Crash, Iran Peace Deal

todayJune 12, 2026 7

Background
share close

Oil price don drop on Thursday afta US Presido, Donald Trump soft in bicycle pedal from im earlier threat to launch more attacks on Iran, and tuk say dem don ready for peace agreement.

Earlier for di day, tension bin rise like 40 years olg BP, as America and Iran exchange attacks for di second day, scata tins for di middle east.

Later di day, e be like  Trump tuk to im self, change tone, so Brent crude oil price con fall 3 percent to below $90 per barrel.

West Texas Intermediate crude too drop pass 3 percent and trade around $87 per barrel.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds