PETER OBI

46 Results / Page 4 of 6

Background

Politics

Obi Get Green Light as NDC Zone Presidential Ticket to South

Nigeria Democratic Congress (NDC) don reserve dia 2027 presidential ticket for Southern Nigeria, and many people dey talk say dis move fit boost former Anambra State Governor, Peter Obi chance well-well. Dem make di announcement on Saturday during dia national convention wey dey happen for Abuja. Di party still confirm am for dia official X handle, as dem post say, “NDC presidential ticket don go South!” Top party big men […]

todayMay 9, 2026 25

National

Obi, Kwankwaso Join NDC For Abuja, Beg Supporters To Join

By: Esther Ayoola Two of Naija top opposition, Peter Obi and Rabiu Musa Kwankwaso on Sunday like dis don buy waka officially join Naija Democratic Congress (NDC). Party big wigs, including leader Seriake Dickson naim welcome dem for di national secretariat for Abuja on Sunday. Afta di joining, Obi and kwankwaso  fry mouth, telling di gorment of di day to allow multi party system exist.

todayMay 4, 2026 13

Politics

Breaking: Peter Obi Dump ADC

Former Labour Party presidential candidate Peter Obi don comot from African Democratic Congress because of serious gbege inside di party and for di country. Di former Anambra State govo post dis statement wey im X on Sunday. E describe Nigeria politics as something wey don turn toxic, full of intimidation, insecurity, and discouragement. Obi explain dat, di decision im think am wella before resigning, hoping dat e go find beta […]

todayMay 3, 2026 15

National

Obi Raise Alarm how 60% of Naija Student take Join Yahoo

By: Esther Ayoola Di 2023 presidential candidate of labour, Peter Obi, don raise alarm say Naija dey face serious moral and systemic crisis following claim by EFCC Chairman, Olanipekun Olukoyede, say six out of every ten university students dey involved in internet fraud. Obi post for X, say if di claim na true, e show say problem dey for Damascus, dat, dis one nor be only crime but failure of […]

todayApril 29, 2026 17

south west

Makinde Meet Peter Obi For Ibadan To Discuss 2027 Coalition Plan

By: Esther Ayoola Oyo state govo Seyi Makinde and di 2023 labour party presidential candidate don run anoda closed door meeting. Say di Oyo state Govo host Peter Obi with im delegation for im Office for Agodi, Ibadan on Tuesday. Speaking with tori pipo afta di meeting, Obi say di visit na part of ongoing tuks and consultation about coalition wey dem dey plan run for 2027 general elections. Dis […]

todayApril 29, 2026 21

National

Yul Edochie Dismiss Peter Obi 2027 Ambition

By: Esther Ayoola Nollywood actor and politician, Yul Edochie, don scarra mouth say Peter Obi nor go fit become President of Naija for dis present time. Edochie yarn dis one for im X page on Tuesday, where e tuk say Obi political strength no strong reach. E sti go ahead press tuk say wetin Obi dey do with African Democratic Congress no go work, say na “dead on arrival” and […]

todayApril 21, 2026 22

OBODO NAIJA

ADC, PDP, Obi Blast INEC As Dem Drop David Mark, Aregbesola Recognition

Di African Democratic Congress, Peoples Democratic Party, and Peter Obi dey vex wetin nor good for  INEC say dem  remove David Mark, Rauf Aregbesola and some other party leaders from recognition. INEC tuk say dem take dis decision because of court order wey say make dem maintain status quo until dem settle case about David Mark leadership. ADC tuk, tuk Bolaji Abdullahi and PDP own Ini Ememobong say dis action […]

todayApril 2, 2026 19

OBODO NAIJA

Kwankwaso Dump NNPP, Join ADC for Kano State

Di 2023 NNPP presidential candidate and ex-Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, don officially join African Democratic Congress (ADC) on Monday, March 30, 2026, for Gidan Kwankwasiyya, Miller Road, Bompai, Kano. Kwankwaso register with di party and collect im membership card in front of top politicians like ADC chairman David Mark, Aminu Tambuwal, Rotimi Amaechi, Peter Obi, Dino Melaye and John Odigie-Oyegun. Although Kwankwaso no fully explain why, but say im […]

todayMarch 30, 2026 25

National

Nyesom Wike Bad Mouth Peter Obi, Question Im Leadership Quality

By: Esther Ayoola Oga Minister of di Federal capital Territory, Nyesom Wike don blast Peter Obi say im no get beta leadership to handle anything. Di FCT minister yarn dis one on Sunday for PDP 2026 convention wey dem hold for Moshood Abiola National Stadium. E say Obi waka comot from Labour Party when gbege start, instead of solving di problem, say dat move nor be smart move at all. […]

todayMarch 30, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds