obodo oyinbo

Trump And Iraq PM Wan Rub Mind For White House

todayJune 16, 2026 12

Background
share close

By: Yusuf Abuh

US Presido, Donald Trump and Iraq Prime Minister, Ali al-Zaidi, don set time to meet for White House for July, say dem wan align one or two on how di two both countries go work together.

Dis na according to di US embassy for Baghdad and Trump special envoy, Tom Barrack,  on Tuesday.

From wetin wi dey hear, Tom Barrack go travel go Baghdad, visit di Prime Minister to reason how dem go take settle di country security.

Di two big men tidy how dem wan handle  guns and scata all di illegal armed groups, jaguda boys  for Iraq.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds