As tension dey rise for South Africa, Nigerian Consulate, together with Nigerian Citizens Association in South Africa, don arrange free repatriation flight for Nigerians wey wan return home permanently.
According to President of NICASA, Frank Onyekwelu, e say di wahala don force many Nigerians to lock their shops and businesses.
E add say, no serious support system dey on ground for Nigerians wey di crisis affect, but di consulate intervention don at least open door for people wey wan comot.
Onyekwelu still talk say plenty Nigerians don already begin show interest to return back home.