obodo oyinbo

Iran Cancel Flights To Iraq And Oman

todaySeptember 23, 2026 2

Background
share close

Iran don cancel flight go Baghdad for Iraq and Muscat for Oman from midnight on Tuesday, just hours before US  punishment against Iran go start.

Tok tok pesin for Iran civil aviation tell media tok tok pipo say Baghdad and Muscat airports no go accept Iran flight again, but flight to other area like Istanbul go continue normal  normal.

Iran flight oga dem dey follow Iraq yarn to move Baghdad flight to Najaf, where many Iranian worshipers dey travel go, as yarnings with Oman still dey go on.

Iraq gornment never officially announce di ban, but senior man gornment official say Baghdad go follow di decision.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds