News-auth

697 Results / Page 10 of 78

Background

Sports

Alcaraz Make Strong Return, Beat Rinderknech For Doha Open First Round

By: Esther Ayoola World number one , Carlos Alcaraz don start im betterlicioius doings again oh, afta Australian Open win,  beating Arthur Rinderknech 6-4, 7-6 (7/5) for Doha first round on Tuesday. Yarning with tori pipo after di match, E explain dat, e no easy oh, because Arthur na strong player wey nobody wan jam for first round. Alcaraz tuk say e happy say e fit remain calm for di […]

todayFebruary 18, 2026 10

obodo oyinbo

Peru Fire President Jose Jeri Over Corruption Wahala

By: Esther Ayoola Peru Congress don fire interim presido, Jose Jeri, wey be di seventh presido of di kontri and e don rule  for di last ten years. Dem accuse am say e hire plenty women for him gornment and say e dey linked to one Chinese businessman for corruption wahala. Jeri take over from leader Dina Boluarte, wey dem bin impeach, because pipo complain about di wahala for di […]

todayFebruary 18, 2026 5

National

Muslims And Christians Enter Prayer Mood As Ramadan, Lent Start

By: Esther Ayoola Millions of Muslims and Christians for di world don start dia special spiritual time today. Muslims don ready for Ramadan, wey dem go fast from morning till night, pray more, and do plenty charity. Christians wey dey observe Lent, go also dey pray, do penance, and control demself till Easter. Saudi Arabia sef don konfamate dis doings, say dem don see di new moon, so Ramadan 1447 […]

todayFebruary 18, 2026 10

National

How Drama Promax Take Sup For Nass Over E-Transmission For 2027 Elections

By: Esther Ayoola Drama burst for National Assembly of Naija on Tuesday as lawmakers approve electronic transmission of election results but sti keep manual collation as backup ahead of 2027 elections. A move wey bring serious argument for both Senate and House of rep. For Senate, about 15 lawmakers led by Enyinnaya Abaribe protest against di clause wey say manual Form EC8A fit serve as main result, if electronic transmission […]

todayFebruary 18, 2026 9 2

National

Manufacturers Block NAFDAC Office, Kick Against Sachet Alcohol Ban

By: Esther Ayoola Say like dis manufacturers of spirit drink, wey dey under Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association dey protest, say dem nor go gree oh, for NAFDAC office, Oshodi-Apapa expressway, block di gate enter, say make NAFDAC open dia offices. Dem say NAFDAC seal dia factories because of di ban on sachet alcohol drinks and PET bottles wey small pass 200ml. Di workers carry placard wey write […]

todayFebruary 18, 2026 3

Lagos

Lagos Police Commissioner Drop Security Alert

By: Esther Ayoola Lagos Police commissioner Olohundare Jimoh don shake table oh, say make Lagos resident dey always dey alert of security. Jimoh dey yarn dis one give tori pipo as im dey mark one year for inside office. Giving his report card , Jimoh say, just one year im don spend for office, dem don recover over 150 vehicle from jaguda boys, gingering resident to dey at alert always.

todayFebruary 18, 2026 3

Sports

FA Cup Round of 16: Arsenal, Chelsea, Liverpool, Man City Know Opponent

By: Esther Ayoola Premier League big clubs Arsenal, Liverpool, Chelsea and Manchester City don sabi who dem go play for FA Cup Round of 16. Arsenal go play lower league team Mansfield Town, while Chelsea go face Wrexham. Manchester City go play Newcastle United, and Liverpool go rugged Wolves wey dey try avoid relegation. Other games na Fulham vs Southampton, Sunderland go play Port Vale or Bristol City, Leeds go […]

todayFebruary 17, 2026 12

Sports

Spalletti Rake For Newspaper Say Juventus Go Block Osimhen Progress

By: Esther Ayoola Juventus coach Luciano Spalletti, wey be Victor Osimhen former coachie for Napoli  say, im  believe im boys to  stop Victor Osimhen Galatasaray for Champions League. Di two teams go play first leg for RAMs Park on Tuesday night. Osimhen don score six goals for six Champions League games dis season. However, Spalletti say, if Juventus must progress, e dey importankpa for dem to stop Gala deadly stikers […]

todayFebruary 17, 2026 7 2

Sports

FIFA Maintain Composure For NFF Petition Against DR Congo

By: Esther Ayoola Say, FIFA never still tuk anytin about di petition wey Naija Football Federation (NFF) put, dat, DR Congo play ineligible players for last November 2026 World Cup African play-offs, According to report, Nigerians waiting on Monday na another level, because di intercontinental play-offs go happen from March 26 to 31 for Mexico. But unto update, NFF Presido Ibrahim Gusau tuk for social media, say dem never hear […]

todayFebruary 17, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app